Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 148
  • Jehovah Dey Save Im People

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Dey Save Im People
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Special People
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Make We Sing to Our God!
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 148

SONG 148

Jehovah Dey Save Im People

(2 Samuel 22:1-8)

  1. 1. Jehovah God, no other God fit be like you.

    Everything wey you do,

    show sey na you fit rule.

    Na only you get power.

    You dey my side, I no fear,

    I know sey you dey care.

    (CHORUS)

    Jehovah dey save people wey no leave am.

    Make we tell people sey Jehovah really strong.

    Na the True God wey make everything.

    Trust am, praise am,

    and no leave am.

    Na im fit save us and give us life.

  2. 2. Sometimes my plenty problem fit make me dey cry.

    Water fit full my eye.

    My pocket fit don dry.

    Jehovah na only you

    go fit help me, hold my hand,

    Save me abeg, my God.

    (CHORUS)

    Jehovah dey save people wey no leave am.

    Make we tell people sey Jehovah really strong.

    Na the True God wey make everything.

    Trust am, praise am,

    and no leave am.

    Na im fit save us and give us life.

  3. 3. I go serve you with

    all my heart Jehovah God.

    Na you be the True God.

    I go dey read your Word.

    Your enemy go fear you.

    You go destroy all of dem.

    But we go dey enjoy.

    (CHORUS)

    Jehovah dey save people wey no leave am.

    Make we tell people sey Jehovah really strong.

    Na the True God wey make everything.

    Trust am, praise am,

    and no leave am.

    Na im fit save us and give us life.

(Still check Ps. 18:1, 2; 144:1, 2.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share