You Still Remember?
You take time read the Watchtower wey never tey wey we print? See whether you fit answer all this question:
Which kind sin Jesus dey talk about for Matthew 18:15-17?
E dey talk about matter wey the two people wey get quarrel fit settle by theirself. But the sin serious reach to disfellowship person if dem no settle the matter. For example, the sin fit be sey person play brother or sister wayo for business matter or sey e talk wetin go spoil another person name.—w16.05, p. 7.
Wetin be some things wey you fit do to help you gain from your Bible reading?
You fit do this things: Read with free mind, see how you fit follow wetin you don learn; ask yourself question like ‘How I fit use am help another person?’; and use the different different book and other things wey we get take do research about wetin you just read.—w16.05, pp. 24-26.
Na bad thing for God servant to cry if person die even when e believe sey resurrection dey?
The faith wey God servant get sey resurrection dey, no go just comot the pain wey e dey feel if person die. Abraham feel am and e pain am well well when Sarah die. (Gen. 23:2) As time dey go, the pain go dey go down.—wp16.3, p. 4.
The man wey carry wetin person take dey write and the six men wey carry wetin dem take dey scatter things for Ezekiel chapter 9, who dem be?
We understand sey dem be the army wey dey heaven wey join scatter Jerusalem reach ground and for Armageddon dem go still join hand finish this wicked world wey Satan dey control. For our time, the man wey carry wetin person take dey write, na Jesus Christ; e dey mark the people wey go save.—w16.06, pp. 16-17.
Wetin be the things wey for destroy Bible and spoil the message?
(1) The kind paper wey dem first take write Bible dey rotten; two of that kind paper na papyrus and parchment; (2) government and leaders for religion try to destroy am; and (3) some people try to change the message wey dey inside.—wp16.4, pp. 4-7.
Which things person wey be Christian fit do to make im life simple?
Know wetin you really need and no dey buy anything wey you no need. Plan how to spend money so that you no go spend pass wetin dey your hand. No dey keep wetin you no dey use again, and pay any money wey you owe. No let your work chop your time, and plan how you go take do more for God work.—w16.07, p. 10.
Wetin Bible talk sey better pass gold or silver?
Job 28:12, 15 talk sey the sense wey God dey give better pass gold or silver. As you dey find am, try to get strong faith and make you no carry shoulder up.—w16.08, pp. 18-19.
E good make person wey dey serve Jehovah dey keep beard beard?
For some culture, if man keep beard beard wey clean, dem fit no see am as bad thing. And e fit no disturb our preaching work for that area. But even with that one, some people fit sey dem no want keep beard beard. (1 Cor. 8:9) For other culture, beard beard no be better thing and dem feel sey better Christian no suppose dey keep beard beard.—w16.09, p. 21.
Wetin fit make us believe sey David and Goliath story for Bible na true?
Goliath use only six inches (15 cm) tall pass the man wey dem sey na im tall pass for the world today. David na real person. Na true because Jesus talk about David, and people wey dem dey call Archaeologists see one olden days thing wey talk about David family. Wetin people know about the area wey the fight for happen match wetin dey Bible.—wp16.5, p. 13.
How to know something, to understand something, and to get better sense take different?
Person wey know something dey learn things. Person wey understand something dey know how one thing take concern another one. Person wey get sense dey fit join wetin e know together with wetin e understand, come use dem well.—w16.10, p. 18.