Dey Pity People and Judge Well Like Jehovah
‘Make una dey judge matter well. Make una dey use love do things with each other and dey pity for each other.’—ZECH. 7:9.
1, 2. (a) How Jesus see God Law? (b) How the scribe and Pharisee take turn God Law upside down?
JESUS like the Law wey Jehovah give Israel people. And e no surprise us sey e like am! This na because the Law come from the Person wey im like pass, and this Person na Jehovah im Father. Psalm 40:8 talk how Jesus like God law reach. E sey: ‘O my God, na to do wetin you want na im I want, and your law dey inside my heart.’ Wetin Jesus talk and the things wey e do when e dey this earth, show sey God Law no get comma at all. E show sey everything wey dey inside go happen, and gain dey if person follow am.—Matt. 5:17-19.
2 But the people wey dem dey call scribe and Pharisee turn God Law upside down, and dem dey make people think sey e no make sense. When Jesus see all this one, e pain am well well! Jesus talk sey dem no dey fail to pay tithe for some small small plant wey dem dey call ‘mint’ ‘dill’ and ‘cumin.’ This one mean sey dem dey sofri follow some kind things wey dey the Law. Wetin come bad for wetin dem dey do? Jesus talk sey: ‘But una no dey follow the things wey matter pass for the Law: una no dey judge matter well, una no dey pity for people, and una no dey serve God well.’ (Matt. 23:23) The Pharisee dey feel sey dem better pass other people. Their own na to dey tell other people wetin dem go do. Dem no dey see the reason why God give the Law. But Jesus know why the Law dey, and e know wetin the Law talk about Jehovah.
3. Wetin we go talk about for this topic?
3 Today, we no dey follow the Law wey Jehovah give Israel people. (Rom. 7:6) But Jehovah still make sure sey the Law dey Bible. Why? Na because e want make we do ‘the things wey matter pass.’ This one mean sey we go know why Jehovah give the Law. For example, Jehovah tell im people to build different city wey person fit run go if e kill person by mistake. Wetin we fit learn from that law? For the topic before this one, we talk about wetin person wey kill somebody by mistake need to do, and we learn from that arrangement. But this arrangement still help us know the kind person wey Jehovah be, and how we fit be like am. So, we go answer three question for this topic: (1) How the city take show sey Jehovah dey pity person? (2) How e take show sey Jehovah value person life? (3) How e take show sey Jehovah dey judge matter well? As we dey answer this question, dey think how you go take copy Jehovah example.—Read Ephesians 5:1.
WHERE THE CITY DEY, SHOW SEY JEHOVAH DEY PITY PERSON
4, 5. (a) How dem take build the city wey person fit run go, and why dem build am like that? (b) Wetin this one teach us about Jehovah?
4 Na six city dem build and e easy to run reach there. Dem build three for one side of River Jordan, and three for the other side. Why? So that e no go hard anybody to quick run reach there, if e kill person by mistake. Jehovah allow Israel people to choose place wey good for dem. (Num. 35:11-14) Dem dey maintain the road wey dem dey pass go the city. (Deut. 19:3) As dem talk sey Jew people dey do, dem put signboard wey dey point where the person go follow go the city. So if dem kill person by mistake, dem no need to run go other place where people no dey serve Jehovah. This one fit make dem stop to serve Jehovah.
5 Think am: Na Jehovah tell Israel people make dem kill anybody wey open eye kill person. But Jehovah pity for who kill person by mistake and e tell dem wetin dem go do to protect am. One man wey sabi this matter well well talk sey God “make everything clear, simple and easy. This one really show how God dey pity person reach.” Jehovah no be the kind judge wey dey find how e go take punish people. Instead, Bible tell us sey God ‘dey pity us well well.’—Eph. 2:4.
6. How Pharisee people take dey behave?
6 Pharisee people no dey pity for person like Jehovah. For example, if person do one bad thing reach three times, dem no go forgive am again. Jesus tell us one story wey show how Pharisee people take dey look other people. For the story, one of dem come dey pray to God sey: ‘God I thank you sey I no be like other people. I no be like people wey dey use wayo collect people things or people wey dey do bad things. I no be like people wey don marry wey dey sleep with another person or even like this tax collector.’ But the tax collector dey pray for imself make God pity am. Why Pharisee people no dey pity other people? Bible talk sey dem ‘dey see other people as nothing.’—Luke 18:9-14.
You ready to forgive other people and make am easy for dem to come beg you? No dey make am hard for people to come meet you (Check paragraph 4-8)
7, 8. (a) How you go take copy Jehovah example when person do wetin vex you? (b) Why e go hard us to forgive other people if we dey raise shoulder?
7 No do like Pharisee people. Instead, dey pity for people like Jehovah. (Read Colossians 3:13.) No dey make am hard people to come beg you to forgive dem. This one go show sey you dey pity people. (Luke 17:3, 4) So ask yourself sey: ‘I dey quick forgive people wey do wetin I no like, even if dem do am again? I dey make am easy for dem to come beg me? I ready to make peace with person wey do wetin vex me?’
8 If we no dey carry body up, we go dey forgive other people. Pharisee people no ready to forgive other people because dem believe sey dem better pass dem. But as Christian, we must get ‘the mind sey other people better pass’ us. This one go make am easy for us to forgive dem. (Phil. 2:3) You go copy Jehovah example? You ready to carry body down and forgive other people? Remember sey Israel people dey maintain the road wey person dey pass go the city, and e easy for person to reach there. So make you ready to forgive other people and make am easy for dem to come beg you. Dey quick forgive people and no dey quick vex.—Eccl. 7:8, 9.
VALUE LIFE AND ‘NOBODY BLOOD GO DEY YOUR HEAD’
9. How Jehovah take help Israel people know sey life get value?
9 One of the main reason why Jehovah tell Israel people to build those city, na because e no want make person blood dey their head. (Deut. 19:10) Jehovah value life well well, so e no like am if person ‘kill person wey im hand clean.’ (Prov. 6:16, 17) Because Jehovah na holy God wey dey judge matter well, e value the life of person wey dem kill by mistake. Na true sey Jehovah dey pity for the person. But the person need to first go tell the elders wetin happen. And if the elders really see sey na by mistake, dem go let am stay the city until the high priest die. This one mean sey the person fit even dey there till e die. E no easy, but this one make Israel people know sey life get value. So, to show sey dem respect Jehovah as the Person wey give dem life, dem no go do anything wey fit kill person.
10. How Jesus take show sey scribe and Pharisee people no value people life?
10 Scribe and Pharisee people no be like Jehovah wey value people life. We know because of wetin Jesus tell dem. E sey: ‘Una hide the key wey go make people know God. Una no gree enter and una no let other people enter!’ (Luke 11:52) Wetin Jesus mean? E mean sey dem suppose to dey help people understand God Word and get life wey no go end. But no be wetin dem do be that. Dem no want make people follow Jesus, the ‘Person wey God choose to give us life.’ (Acts 3:15) So how dem go take get life? This scribe and Pharisee people dey carry shoulder and dey only think about theirself. Dem no see people life as anything. E clear sey dem really wicked and dem no sabi pity person!
11. (a) How apostle Paul take show sey e value people life like Jehovah? (b) Wetin go help us be like apostle Paul?
11 How we go take copy Jehovah example so that we no go be like the scribe and Pharisee people? Value life because na gift from Jehovah. Apostle Paul preach well well to show sey e value life. Na im make am fit talk sey im ‘hand clean’ from people blood. (Read Acts 20:26, 27.) But Paul no preach just because e no want make people blood dey im head, or because Jehovah want make e preach. E preach because e love people and e value their life. (1 Cor. 9:19-23) So make we self value people life like Jehovah. Jehovah ‘want make everybody repent.’ (2 Pet. 3:9) What of you? If you really dey pity for people, e go help you put body for the preaching work. And this one go make you dey happy more more.
12. Why Jehovah people no dey play with life?
12 To show sey we value life like Jehovah, we no go do anything wey fit put person life for danger. This one mean sey we go dey drive and work well. Make we put this one for mind when we dey build or maintain house, or when we dey drive go Kingdom Hall or assembly. No put person life for danger because of hurry hurry or money. E good make we be like Jehovah wey dey always do the correct thing. Elders need to make sure sey their life or the life of people wey dey work with dem, no dey for danger. (Prov. 22:3) So if the way you dey work fit put person life for danger, and elder correct you, listen to am. (Gal. 6:1) If you value life like Jehovah, ‘nobody blood go dey your head.’
‘FOLLOW WETIN I TALK TAKE JUDGE’ THE MATTER
13, 14. How elders for Israel go take judge matter well like Jehovah?
13 Jehovah tell the elders for Israel make dem dey judge matter well like am. So if person kill person, the elders go first know everything wey really happen. After that one, dem go try to know wetin cause am, how the person feel about wetin e do, and if the person first get bad belle for the person wey die. The elders go still need to know if the person kill the person ‘because e hate am.’ Na this things go help dem know whether dem go pity for am. (Read Numbers 35:20-24.) Before dem fit kill this kind person, dem go call like two people wey see wetin happen.—Num. 35:30.
14 When the elders don know everything wey happen, dem no go only put eye for wetin e do, but dem go think about the person. Dem need to settle down look the matter well well. But the main thing wey dem need na Jehovah holy spirit. Na Jehovah spirit go help dem fit think the matter well, pity for the person, and judge the matter well.—Ex. 34:6, 7.
15. How Jesus take different from Pharisee people?
15 Pharisee people dey only put eye for the bad thing wey person do. Dem no want know who the person really be for inside. When dem see Jesus dey chop for Matthew house, dem ask im disciples sey: ‘Why una teacher dey chop with people wey dey collect tax and people wey dey sin?’ Jesus come answer dem sey: ‘People wey well no need doctor, na people wey dey sick need doctor. Make una go learn wetin this thing mean: “I no need sacrifice. I want make una dey pity people.” Na people wey dey sin I come call, no be people wey dey do good.’ (Matt. 9:9-13) This one mean sey Jesus dey cover for bad people? No! Jesus want make dem change. This one na even one of the main message wey e preach about. (Matt. 4:17) Jesus see sey some of this people wey dey do bad ready to change. All this people no come Matthew house just because of food. Instead, dem dey among the plenty people wey dey follow Jesus. (Mark 2:15) Many of those Pharisee people no dey see other people like Jesus. Dem dey talk sey dem dey serve God, but dem no dey judge matter well or pity people like God. Instead, dem dey look other people as sinner wey no get hope.
16. Wetin elders wey dey judge matter dey try to know?
16 Elders today need to dey do like Jehovah wey dey judge matter well. (Ps. 37:28) The first thing na for dem to ‘do everything to know wetin really happen.’ If dem see sey wetin the person do no good, dem go use wetin dey Bible handle the matter. (Deut. 13:12-14) The elders wey go judge the matter need to find out if wetin the person do really pain am. E no always easy to know. But how the person feel about wetin e do, and wetin dey im mind go help the elders know. (Rev. 3:3) For dem to pity for the person, dem need to see sey wetin the person do really pain am and e ready to change.a
17, 18. How elders go take know person wey no happy for wetin e do and wey ready to change? (Go check the first picture.)
17 Elders no be like Jehovah and Jesus wey dey fit see wetin dey person mind. If you be elder, how you go take know person wey no really happy for wetin e do and wey ready to change? The first thing wey you go do na to pray make Jehovah give you sense and help you understand the matter. (1 Ki. 3:9) Another thing wey you go do na to check Bible and our book dem. This one go help you know person wey ready to change and person wey dey pretend. (2 Cor. 7:10, 11) Check wetin Bible talk about people wey repent and people wey no repent. Find out how dem see wetin dem do, wetin dey their mind, and how dem behave.
18 The other thing wey you go do na to think about the person. No only put eye for the bad thing wey e do. Ask yourself sey: Why this person be like this? Wetin make am do this kind thing? Wetin be some of the things wey e dey face? Na Jesus be the head of congregation and Bible tell us sey ‘no be wetin im eye see e go take judge.’ And e no go ‘correct person with only wetin e hear. E no go do partial when e dey judge common people,’ and e go do wetin go favor better people. (Isa. 11:3, 4) Na Jesus put you as elder to take care of the congregation. And e go help you know how to pity for people and judge matter well like am. (Matt. 18:18-20) We happy sey we get better elders wey dey take care of us. And we like as dem dey pity people and dey judge matter well!
19. Wetin you don learn from the city wey Jehovah tell Israel people to build, and how you plan to use am?
19 The Law wey Jehovah give Israel people dey help us know the kind person wey Jehovah be. E still dey help us know the things wey Jehovah want make we dey do. (Rom. 2:20) For example, the city wey Jehovah tell Israel people make dem build dey help elders know how to ‘judge matter well.’ And e teach all of us how to ‘use love do things with each other and dey pity for each other.’ (Zech. 7:9) Na true sey we no dey follow the Law wey Jehovah give Israel people again. But Jehovah no dey change. E still want make we dey judge matter well and dey pity people. You no happy sey you dey serve this kind God? So make we dey do like Jehovah, and run go meet am to help us!
a Check September 15, 2006, Watchtower page 30, under “Questions From Readers.”