SONG 88
Teach Me Your Word
(Psalm 25:4)
1. Jehovah our God you dey help us dey learn
The truth for your Word wey get power.
To show us the road, to give us better life.
Na im make we gather together.
(CHORUS)
This road to life, na im I want dey stay.
Wetin you talk I go dey try obey.
And use your Word when I dey try decide.
Abeg help me make I no leave your side.
2. Your deep sense Jehovah, dey give me the mind
To trust you and give you my whole life.
Some things wey I learn go make me dey wonder,
Jehovah true true na you make life.
(CHORUS)
This road to life, na im I want dey stay.
Wetin you talk I go dey try obey.
And use your Word when I dey try decide.
Abeg help me make I no leave your side.
(Still check Ex. 33:13; Ps. 1:2; 119:27, 35, 73, 105.)