One sister dey preach to one mama and im pikin for West Bengal, India
Example Wey You Fit Follow
THE WATCHTOWER
Question wey you go ask: When we dey worry, we need wetin go make our mind come down. But where we go fit see am?
Bible wey you go read: 2Co 1:3, 4
How you go give am: This Watchtower tell us about how God dey make our mind come down.
THE WATCHTOWER (back of The Watchtower)
Question wey you go ask: Some people think sey God Kingdom na something wey dey for person mind, other people think sey the Kingdom na wetin human being go do to bring peace come this earth. Wetin you think?
Bible wey you go read: Da 2:44
How you go give am: Bible talk sey God Kingdom na real government. This Watchtower talk other things wey Bible talk about God Kingdom.
TEACH THE TRUTH
Question wey you go ask: How we go take know whether God dey care for us?
Bible wey you go read: 1Pe 5:7
Truth: God dey tell us sey make we pray to am because e care for us.
WRITE AS YOU GO DO YOUR OWN
Use the way dem write the example for here take write as you go do your own when go preach.