Brothers and sisters dey do Kingdom Hall work for Switzerland
Example Wey You Fit Follow
THE WATCHTOWER
How you go take start: Many people know the story of the four men wey dey ride horse for the book of Revelation. E dey make some people fear but other people want know more about am.
Bible wey you go read: Re 1:3
How you go give am: This Watchtower go help you see how the things wey Revelation talk about this four men wey dey ride horse take be good news for us.
TEACH THE TRUTH
Question wey you go ask: You think sey we go fit know wetin go happen for future?
Bible wey you go read: Isa 46:10
Truth: For Bible, God tell us how the future go be.
YOU FIT MEK YOUR FAMILI HAPI (hf)
How you go take start: I go like show you this short video wey talk about family. [Play the video wey talk about the brochure You Fit Mek Your Famili Hapi.]
How you go give am: If you go like read this brochure wey dem talk about for this video, I fit give you one or show you how you go take download am.
WRITE AS YOU GO DO YOUR OWN
Use the way dem write the example for here take write as you go do your own when you go preach.