BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JEREMIAH 35-38
Ebed-melech Na Better Example of Person Wey No Dey Fear and Wey Get Better Mind
Ebed-melech na person wey dey work for King Zedekiah palace, im better character show sey na God servant
38:7-13
Ebed-melech show sey e strong mind when e no waste time to go meet King Zedekiah and when e go save Jeremiah from the well wey dem throw am put
Ebed-melech give Jeremiah soft rag and pieces of cloth make e put am for under im armpit so that the rope wey dem go take draw am come out, no go pain am. This one show sey Ebed-melech get better mind