SONG 13
Copy Jesus Example
(1 Peter 2:21)
1. Jehovah we love you
For the good wey you do,
Wey you send your Son Jesus to come save us.
Jesus dey put you first,
E dey give you the best,
When e come the earth with body like us.
2. Jesus strong love for God,
Make am study God Word,
Wey make am dey get deep sense wey dey guide am.
And e use all im heart
Dey do wetin God want,
Because e dey like to dey serve God well.
3. Bible don tell us sey,
Like Jesus, try obey.
Make we try dey do wetin God dey tell us.
Make we copy Jesus,
And do wetin e talk.
Make we try dey serve God well ev’ry day.
(Still check John 8:29; Eph. 5:2; Phil. 2:5-7.)