BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PSALM 102-105
Jehovah Remember Sey Na Sand Sand We Be
David compare different things to take explain how Jehovah dey show us mercy.
103:11
As we no fit know how heaven take far from earth, na so we no fit know how the love wey Jehovah get for us big reach
103:12
As the place where sun from dey come out for morning take far from the place where sun dey enter for evening, na so Jehovah take carry our sin comot go far far from where we dey
103:13
As papa take dey pity im pikin when e dey feel pain, na so Jehovah take dey show mercy to people wey don repent but still dey feel bad because of their sin