August 15-21
PSALM 102-105
Song 80 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“Jehovah Remember Sey Na Sand Sand We Be”: (10 min.)
Ps 103:8-12—Jehovah dey forgive us when we repent (w13 6/15 20 ¶14; w12 7/15 16 ¶17)
Ps 103:13, 14—Jehovah know how we fit do reach (w15 4/15 26 ¶8; w13 6/15 15 ¶16)
Ps 103:19, 22—To show sey we value as Jehovah dey forgive us, we go dey support am sey na im get power pass to rule us (w10 11/15 25 ¶5; w07 12/1 21 ¶1)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Ps 102:12, 27—If we dey think about our friendship with Jehovah when we dey face problem, how e go take help us? (w14 3/15 16 ¶19-21)
Ps 103:13—Why e be sey no be everything wey we ask Jehovah e dey do quick quick? (w15 4/15 25 ¶7)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Ps 105:24-45
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) g16.4 10-11—Tell am wetin una go talk about when you come back.
Return Visit: (No pass 4 min.) g16.4 10-11—Tell am wetin una go talk about when you come next time.
Bible Study: (No pass 6 min.) bh 164-166 ¶3-4—Help the student make e see how e go fit do wetin e learn from the study.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 91
No Forget Wetin Jehovah Don Do for You (Ps 103:1-5): (15 min.) Talk am together. First play this video wey dey tv.jw.org/pcm: The Way I Take Dey Live My Life Tire Me. (Check CHOOSE VIDEO WEY YOU LIKE > TRUTH DEY CHANGE PEOPLE LIFE.) After, ask dem this question: Which reason we get to praise Jehovah? Because Jehovah good well well, wetin be some of the things wey we dey expect sey e go do for us for front?
Congregation Bible Study: (30 min.) ia chap. 22 ¶1-13
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 131 and Prayer