Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 September p. 2
  • If E Be Sey Na Small Pikin Open Door

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • If E Be Sey Na Small Pikin Open Door
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • Papa and Mama, Help Your Children Become Jesus Disciple!
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 September p. 2

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

If E Be Sey Na Small Pikin Open Door

Two sister dey preach to one mama and im pikin

If na small pikin come open door when we dey preach, make we tell am sey we want follow im papa or im mama talk. This one go show sey we respect dem. (Pr 6:20) If the small pikin tell us sey make we enter, no enter if im mama or im papa no dey house. E good make we go back another time.

If the pikin big small, maybe e dey around 15 to 19 years, e still good make we tell am sey we want see im mama or im papa. If dem no dey house, we fit ask am whether dem dey allow am choose the kind book wey e dey read. If e sey yes, we fit give am our book or tell am about our website wey be jw.org.

When we go back go visit the young person wey listen to us before, make we tell am sey we go like see im mama or im papa. This one go give us chance to tell dem wetin carry us come and show dem the better advice wey dey inside Bible wey dey make family happy if dem follow am. (Ps 119:86, 138) When we put their papa and mama for mind and show sey we respect dem, that one fit make dem want listen to us and e fit even give us chance to preach to everybody for the family.—1Pe 2:12.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share