BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PROVERBS 22-26
‘Train Pikin the Way You Want Make E Be’
The book of proverbs get better advice for papa and mama dem. If papa and mama train their pikin well from small, that one go help dem serve Jehovah well even when dem don grow.
22:6
To train pikin well, you need time and you go really work
Papa and mama must show their pikin better example, and dem must teach their pikin, advice am, encourage am, and correct am
22:15
Correction dey train pikin mind and heart, and e show sey the papa and mama love their pikin
You fit correct children for different way