MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Wetin We Dey Learn From Bible Fit Help Us Make We No Dey Hate Ourself
Jehovah no dey do partial. (Ac 10:34, 35) E like ‘people wey come from different country and place, and people wey dey talk different language.’ (Re 7:9) And because of that one, e no go good make person for inside congregation dey do partial or favor one person pass another person. (Jas 2:1-4) Thank God for wetin we dey learn for Bible, e dey make us dey enjoy peace now because many people don change their bad character. (Isa 11:6-9) As we dey do everything wey we fit do to make sure sey we no dey do partial, we dey show sey we dey copy God. —Eph 5:1, 2.
WATCH THIS VIDEO: JOHNY AND GIDEON: DEM BE ENEMY BEFORE, BUT NOW DEM BE BROTHERS. AFTER MAKE UNA ANSWER ALL THIS QUESTION:
As human being don try reach to make everybody get one mind, why e be sey na wetin we dey learn for Bible fit help us pass?
Wetin you really like about the kind love wey we dey show ourself for this organization?
If everybody for congregation dey do things with one mind, how e take dey bring praise to Jehovah name?