MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Welcome People Well
Who be the people wey we go welcome well? Anybody wey come our Kingdom Hall, both people wey start to dey come our Kingdom Hall newly and people wey be don stop to dey come Kingdom Hall. (Ro 15:7; Heb 13:2) E fit even be our brother or sister wey come from another country or person wey be inactive. Just think am sey na you be that person, you no go like am if dem treat you well? (Mt 7:12) So before meeting start and after e end, e go good make we dey waka round greet people. This one dey add join the peace and love wey all of us get as Jehovah people and e dey make Jehovah happy. (Mt 5:16) Even if we no fit greet everybody for Kingdom Hall, e good make we try do everything wey we fit do to dey greet people because e go make dem happy and know sey we really like dem.a
No be only for Memorial we dey welcome people, we need to dey do am everytime. And when new people wey come our Kingdom Hall see the kind love wey we get, e fit make dem come join us dey worship Jehovah.—Joh 13:35.
a But when person wey dem disfellowship come Kingdom Hall, we no go greet am because of wetin Bible talk.—1Co 5:11; 2Jo 10.