Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 April p. 5
  • You Fit Encourage Inactive Christian

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Fit Encourage Inactive Christian
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 April p. 5

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

You Fit Encourage Inactive Christian

One shepherd dey try to save im sheep wey be don loss

Many inactive Christian go come our Memorial wey we go do on Tuesday April 11, this year. This people dey follow us serve Jehovah before, but some things come make dem weak. Return to Jehovah brochure tell us some of the things wey make dem weak. (Heb 12:1) But even though sey dem dom be inactive, Jehovah still value dem well well because na im Son blood e take buy dem. (Ac 20:28; 1Pe 1:18, 19) But how we go take help this kind people come back?

Elders for congregation dey try well well to help this kind people. Dem just be like shepherd wey dey put eye for ground to find their sheep wey loss. (Lu 15:4-7) This one show the kind love wey Jehovah get for dem. (Jer 23:3, 4) All of us need to dey encourage dem, no be only elders. Jehovah dey happy when e see us dey try our best to help this kind people and e go bless us. (Pr 19:17; Ac 20:35) So think about the person wey you fit encourage, and no waste time to encourage am!

Laura stand for window dey look, Abbey dey pray, Abbey and Laura hold each other as dem dey snap picture

WATCH THIS VIDEO ENCOURAGE INACTIVE CHRISTIAN, AND ANSWER ALL THIS QUESTION:

  • Wetin Abbey do when e see one sister wey e no know?

  • Why e good make we tell elders first before we go encourage person wey don be inactive?

  • How Abbey take prepare to visit Laura the second time?

  • When Abbey dey encourage Laura, how e take show sey e dey patient, e love am and e no want tire?

  • Wetin we learn from the story wey Jesus talk for Luke 15:8-10?

  • Wetin come happen as Abbey and the elders no tire as dem dey try help Laura?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share