Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ypq question 4 pp. 12-14
  • Wetin I Go Do When I Make Mistake?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin I Go Do When I Make Mistake?
  • Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
  • Similar Material
  • You Dey Learn From Your Mistake?
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
ypq question 4 pp. 12-14
Two boys dey look glass wey break

QUESTION 4

Wetin I Go Do When I Make Mistake?

WHY E DEY IMPORTANT

If you dey gree sey you make mistake, e go help you to be better person wey person fit trust.

WETIN YOU FOR DO?

Just think am sey: Tim and im friend dey play ball. As dem dey play, Tim kick the ball go up, na so the ball go break their neighbor window.

If you be Tim, wetin you for do?

WAIT! THINK AM WELL

YOU FIT DO THREE THINGS:

  1. Run.

  2. Blame another person.

  3. Tell your neighbor wetin happen, and tell am sey you go pay.

You fit like to choose number 1. But e get better reason why e good to dey gree sey you make mistake—whether you break person window or do any other thing.

THREE REASON WHY E GOOD TO GREE SEY YOU MAKE MISTAKE

  1. Na the correct thing to do.

    Bible sey: ‘We want make sure sey everything wey we dey do na the right thing.’—Hebrews 13:18.

  2. People dey quick forgive person wey gree sey e do mistake.

    Bible sey: ‘Person wey dey cover im sin no go succeed, but na who dey confess am and change im way dem go pity.’—Proverbs 28:13.

  3. The one wey better pass be sey, e dey make God happy.

    Bible sey: ‘Jehovah hate person wey im way no clean, but na who dey do wetin right go be im better friend.’—Proverbs 3:32.

Karina wey dey 20 years, try hide paper wey police use charge am because of over speed make im papa no see am. But e no fit hide am forever. Karina sey: “After one year, my papa see the paper, and I enter big trouble!”

Wetin we learn? Karina sey: “If you hide your mistake, e no go only make am worst, you go suffer am later later!”

HOW YOU GO TAKE LEARN FROM YOUR MISTAKE

Bible sey: ‘Many times all of us dey make mistake.’ (James 3:2, wetin dey under) As we don learn, you go show sey  you no dey carry shoulder up and sey you mature if you dey gree sey you make mistake—and na the right  thing to do be that.

Another way na to learn from the mistake wey you make. One girl wey im name na Vera talk sey: “I dey always try to learn something from any mistake wey I make, and I dey allow wetin I learn help me be better person so that I no go do am again.” Make we see how you go fit do wetin Vera talk.

You use your papa bicycle come spoil am. Wetin you go do?

  • No talk anything and dey pray make your papa no see am.

  • Tell your papa wetin happen.

  • Tell your papa wetin happen but sey na another person fault.

You fail for exam because you no read. Wetin you go do?

  • Sey the exam hard.

  • Gree sey na you cause am.

  • Vex sey your teacher no like you.

One girl dey look mirror wey dey show back as e dey drive

If you carry your mistake for mind, e be like person wey dey drive but im eye dey for mirror wey dey show back

Remember the two example wey dey up, try think sey na you be (1) your papa and (2) your teacher. How your papa and your teacher go feel if you gree sey you make mistake? If you cover your mistake, how dem go feel?

Now think about the mistake wey you make last year and answer all this question.

Wetin be the mistake? Wetin you do when the mistake happen?

  • I hide am.

  • I blame another person.

  • I gree sey na me do am.

If you no gree sey na you do am, how you feel later?

  • I happy—No body know!

  • My mind dey judge me—I for talk true.

How you think sey you for do am wey e go better pass?

Wetin you learn from your mistake?

WETIN YOU THINK?

Why some people no dey gree sey dem make mistake?

Which kind eye people go take look you if you dey cover your mistake? Which kind eye people go take look you if you gree sey na you do am?—Luke 16:10.

WETIN I PLAN TO DO

  • Before 1 year finish, wetin you don plan to do wey go help you when you make mistake again?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share