BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 20-21
“Any of Una Wey Want Be Great Person Must Serve the Rest of Una”
20:28
The scribe and Pharisee people dey carry shoulder up. Dem like to dey come where people go see dem, and dem like make people dey greet dem for market
The scribe and Pharisee people dey carry shoulder up, and dem like big big things. Dem like make people notice dem and respect dem. (Mt 23:5-7) But Jesus no be like that, e talk sey: “The Son of man come, no be make dem serve am, but na to serve people.” (Mt 20:28) As we dey worship Jehovah, na the work wey go make people notice and praise us we dey like to do? If we want be great person for Jehovah eye, we go try to be like Jesus. We go do everything wey we fit do to serve other people. When we dey do this kind work people fit no notice us, but Jehovah dey see us. (Mt 6:1-4) Person wey dey carry body down go . . .
dey join clean Kingdom Hall and maintain am
dey ready to use im mind help people wey don old and other people
dey contribute to support God work