SONG 52
We Want Use Our Life Serve Jehovah
(Hebrews 10:7, 9)
1. Jehovah, you wey make heaven,
Your work full all the earth.
You make the land, the sun, and star,
Your power na the best.
And you give us life wey we get,
You draw us near body.
Jehovah na only you we praise
For all the good things wey dey.
2. Na for Jordan Jesus baptize,
To show sey e ready,
To serve God with im heart and mind,
Na promise wey e make.
When e come out from the water,
God spirit show am sey
Na im be the Son wey God like pass.
E dey do wetin God want.
3. With all our heart we dey praise you,
Your Word don help us grow.
From now we want dey use our life
Dey do wetin you like.
Jesus your Son wey you give us,
Na im come die for us.
So nothing fit make us leave your side,
We go serve you forever.
(Still check Matt. 16:24; Mark 8:34; Luke 9:23.)