SONG 57
Dey Preach Give Everybody
(1 Timothy 2:4)
1. E make sense to dey do like Jehovah.
To dey use full mind take dey help people.
Jehovah want save people everywhere.
Make dem follow the road wey e dey show.
(CHORUS)
Na the person wey e be.
Na im heart Jehovah see.
This message fit give life wey no go end.
We go show sey we dey care,
We go preach reach everywhere,
We want make people be Jehovah friend.
2. We no dey look the place wey dem come from.
We no go worry if dem no want hear.
E fit be person wey put God for mind.
E fit be who Jehovah like to near.
(CHORUS)
Na the person wey e be.
Na im heart Jehovah see.
This message fit give life wey no go end.
We go show sey we dey care,
We go preach reach everywhere,
We want make people be Jehovah friend.
3. Jehovah want make people enjoy life.
And e ready to help dem learn Bible.
E dey gather good people everywhere.
And we go help dem learn wetin we know.
(CHORUS)
Na the person wey e be.
Na im heart Jehovah see.
This message fit give life wey no go end.
We go show sey we dey care,
We go preach reach everywhere,
We want make people be Jehovah friend.
(Still check John 12:32; Acts 10:34; 1 Tim. 4:10; Titus 2:11.)