Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ll part 7 pp. 16-17
  • Which Kind Person Jesus Be?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Which Kind Person Jesus Be?
  • Listen to God Make You Live Forever
  • Similar Material
  • Who Jesus Christ Be?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Jesus Christ, Who E Be?
    Good News Wey Come From God!
Listen to God Make You Live Forever
ll part 7 pp. 16-17

PART 7

Which Kind Person Jesus Be?

Na Jehovah send Jesus come this world. 1 John 4:9

Jesus dey God right hand for heaven

E get another person wey we go hear wetin e dey talk, if we want make Jehovah happy. E don tey wey Jehovah make this person for heaven before e come make Adam. This person na the first angel wey God make for heaven and e get power well well.

When Mary get belle and after e born Jesus

As time dey go, Jehovah do miracle come carry this angel life put for one woman belle wey dey live for Bethlehem. This woman name na Mary, and e never sleep with man before. As e born the pikin, e call am Jesus.—John 6:38.

Jesus dey teach other people about Jehovah

When Jesus dey this world, e dey do like im Father. E get better mind, e love people well well, and people no dey fear to near am. Even self, e dey tell people about Jehovah.

Jesus do better thing, but people still hate am. 1 Peter 2:21-24

Jesus raise one girl wey don die and e heals one man wey dey sick

Jesus make people wey dey sick well and e bring people wey don die come life again.

The Scribe and Pharisee dem hate Jesus well well because e dey tell people sey wetin dem dey teach na lie lie and wetin dem dey do no good.

Dem beat Jesus and even kill am

This Scribe and Pharisee people tell the soldier wey dey Rome sey make dem beat Jesus. Na the soldier dem still kill am.

  • Why e good make we sabi who Jesus be?—John 17:3.

  • Wetin Jesus dey do for heaven before e come this world?—Colossians 1:15-17.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share