Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • Which Kind People Jehovah Witness Be?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 1

      Which Kind People Jehovah Witness Be?

      One Jehovah Witness for Denmark

      Denmark

      Jehovah Witness people for Taiwan

      Taiwan

      Jehovah Witness people for Venezuela

      Venezuela

      Jehovah Witness people for India

      India

      How many Jehovah Witness people you sabi? Some of us dey live for your area, some fit dey your school and some dey work for where you dey work. E fit even be sey we don preach for you before. Who you think sey we be? And why you think sey we dey preach for everybody?

      We no better pass other people. Some of us go school, some no go. Some get money, others no get. Some don go another church before, some even no believe sey God dey. But, when we come take our time learn wetin Bible talk, we come see am sey everything wey dey inside na true. (Acts 17:11) Na this one make us gree sey na Jehovah we go worship.

      Our life dey better as we dey learn Bible. Like other people, we self dey do mistake, and we get our own problem. But as we dey do wetin we dey learn from Bible, e dey make our life better. (Psalm 128:1, 2) Because of this fine fine thing wey we don learn, e dey sweet us for belle well well to help other people learn wetin Bible talk.

      We dey follow wetin we learn from Bible. Because we dey follow wetin Bible talk, we dey respect people well well. We no dey do bad to anybody and we no dey play wayo. Wetin we dey learn from inside Bible dey help us live better life, e still dey help us teach other people how to live better life. As we sabi sey ‘God no dey do partial,’ na im make we be one big family wey dey worship God together even though sey we come from different different country and dey speak different different language. Na true sey we get our own problem like other people, but our mind dey sweet us well well because we dey do wetin Bible talk. —Acts 4:13; 10:34, 35.

      • How Jehovah Witness people take be like other people?

      • Wetin Jehovah Witness people don learn for Bible wey dey help dem live better life?

  • Why Dem Dey Call Us Jehovah Witness People?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 2

      Why Dem Dey Call Us Jehovah Witness People?

      Noah

      Noah

      Abraham and Sarah

      Abraham and Sarah

      Moses

      Moses

      Jesus Christ

      Jesus Christ

      Many people think sey Jehovah Witness na one new church wey just start. But the truth be sey, e don pass 2,700 years wey God call people wey dey worship am ‘im witness.’ (Isaiah 43:10-12) Before 1931, na ‘Bible Students’ be our name. Wetin make us come dey answer Jehovah Witness now?

      The name dey show people who our God be. The time wey dem write Bible, e pass 7,000 place wey that name Jehovah, show for inside Bible. For many many Bible wey dey today, people don comot that name and dem come change am to Lord or God. The truth be sey, e don tey wey God tell Moses sey im name na Jehovah, when e sey: ‘Na my name be this forever.’ (Exodus 3:15) That name Jehovah make am dey different from other fake fake god. We happy well well sey we be Jehovah Witness people.

      The name dey show the work wey we dey do. Na from Abel time, many many good people don dey show sey dem believe God. No be only Abel o, people like Noah, Abraham, Sarah, Moses, and David follow join ‘plenty plenty other people dem wey talk about God.’ (Hebrews 11:4–12:1) Just like when person enter court to talk wetin im sabi about person wey no do bad, na so Jehovah Witness people dey ready to tell people about God.

      The name dey show sey we dey follow Jesus. Bible call Jesus ‘faithful and true witness.’ (Revelation 3:14) Even Jesus talk am sey, im ‘tell other people God name’ and help dem ‘sabi wetin dey inside Bible.’ (John 17:26; 18:37) People wey dey really follow Jesus suppose to dey answer God name and tell people about am. Na wetin Jehovah Witness people dey do be that.

      • Wetin make us dey answer Jehovah Witness?

      • Na which time Jehovah Witness people take start for this world?

      • Who be the number one Jehovah Witness?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      If you see any Jehovah Witness, make you try sabi am well well. You fit ask am plenty plenty question like: “Wetin make you come join Jehovah Witness people?”

  • How We Come Take Get the Truth Wey Dey Inside Bible Again?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 3

      How We Come Take Get the Truth Wey Dey Inside Bible Again?

      Some men wey dey study Bible around the year 1870

      Bible Students for 1870

      One man dey read the first Watchtower wey Jehovah Witness people do

      This one na The Watchtower wey dem print for 1879, na im be the first one

      One woman dey hold The Watchtower and Awake!

      The Watchtower as e be today

      Bible don talk am sey after Jesus comot for this world, some of the people wey dey follow am no go follow im example. Dem go dey teach many many things wey no dey inside Bible. (Acts 20:29, 30) As Bible talk am, na so e take happen. Dem carry wetin people wey no sabi God dey teach come mix am with wetin Jesus teach. Na so people wey dey teach wetin no dey Bible but wey dey claim sey dem dey serve God take start. (2 Timothy 4:3, 4) Wetin make us believe sey the things wey we dey learn for inside Bible today na true?

      Time come reach when Jehovah see sey people go sabi wetin really dey inside Bible. Jehovah talk am sey for this time of the end, im people go come sabi wetin Bible talk well well. (Daniel 12:4) For 1870, some people see sey many many things wey dem dey teach for church no dey inside Bible. Na so this small group come start to dey find the true things wey really dey inside Bible. And Jehovah bless dem well well as dem come sabi wetin Bible really teach.

      Some people put their mind down sofri sofri learn Bible. As the small group wey be Bible Student dem take dey learn Bible that time, na so we still dey do today. Dem dey learn different different things wey Bible teach one by one. When dem see some place wey hard to learn, dem go find other place for Bible wey go help dem sabi am well. When dem see am sey wetin dem learn gree with other place for Bible, dem go write am down. This one come help dem sabi many many things wey dey inside Bible like God name, God Kingdom, wetin God want do for people, wetin dey happen when person die, and how people wey don die go take come back to life. All this one come free dem from plenty plenty lie lie wey people dey teach.—John 8:31, 32.

      For 1879, this small group come see am sey time don come make everybody sabi wetin Bible dey really teach. Na that year dem come start to dey print the book wey we dey call, The Watchtower Announcing Jehovah’s Kingdom. We still dey print am reach today. Jehovah Witness people dey preach for different different language wey pass 750 and for 240 different different place. Today, people dey learn wetin Bible really teach everywhere for this world!

      • Wetin happen to the truth wey dey inside Bible after Jesus die?

      • How we come take get the truth wey dey inside Bible again?

  • Why We Make New World Translation Bible?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 4

      Why We Make New World Translation Bible?

      Old machine wey dem take dey print
      First New World Translation of the Holy Scriptures Bible wey dem give people for convention
      People dey look New World Translation Bible wey dem give for Congo (Kinshasa)

      Congo (Kinshasa)

      New World Translation Bible wey dem give people for convention for Rwanda

      Rwanda

      Symmachus paper where we see God name

      Na the Symmachus paper wey we see God name for Psalm 69:31 be this wey dem write about 300 or 400 years after dem born Jesus

      For many many years, Jehovah Witness people dey use different different Bible. Dem even print am give other people. We come see am sey we suppose get the kind Bible wey go help people learn ‘the truth wey dey inside Bible’ and na wetin God want be that. (1 Timothy 2:3, 4) Na 1950 we start to dey print some part of The New World Translation for English. Today, we don make this Bible for different different language wey pass 130. This New World Translation na correct Bible wey no hard to read.

      People need Bible wey dey simple well well. As time dey pass, language dey change. The truth be sey, some Bible use some kind big big word wey people no dey use again because dem too hard to understand. As we come see the old book wey dem write for Hebrew, Aramaic, and Greek wey near the first one wey dem write, e come help us sabi the language wey dem take write Bible well well.

      People need Bible wey dey talk true. People wey write Bible for different different language wey dem dey call Translators no suppose change wetin dey inside Bible. Na wetin dem see for the original book dem suppose write. The truth be sey, many people wey dey translate Bible today don comot God name from inside Bible.

      People need Bible wey go help dem sabi the owner. (2 Samuel 23:2) As we see am for this photo, e pass 7,000 place wey dem write God name Jehovah as e dey for inside the old old book wey dem use write Bible. This New World Translation Bible don put that name for where e suppose dey. (Psalm 83:18) This Bible wey dem put their mind down write sweet to read well well and e dey help us sabi wetin God want. Whether you get New World Translation for your language or you never get am, make you try to dey read Bible everyday.—Joshua 1:8; Psalm 1:2, 3.

      • Why we make New World Translation Bible?

      • Wetin you go dey do everyday if you want learn wetin God want?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Read the foreword of the New World Translation, and answer the question: “With what sense of responsibility did the translation committee produce this Bible?” Then compare their rendering of the following verses with that of other translations that you may possess: Genesis 25:29; Isaiah 14:23; Matthew 5:3; 11:12; 1 Corinthians 10:24, 25; Philippians 1:8.

Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
Log Out
Log In
  • Nigerian Pidgin
  • Share
  • Set Am How You Like
  • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
  • How to Use Am
  • Privacy Policy
  • Privacy Settings
  • JW.ORG
  • Log In
Share