Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 11 ques. 1-4
  • Wetin We Go Gain if We Follow Wetin Bible Talk?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin We Go Gain if We Follow Wetin Bible Talk?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • Train Your Conscience With Laws and Wetin Fit Guide You for Bible
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Good News Wey Come From God!
fg lesson 11 ques. 1-4

LESSON 11

Wetin We Go Gain if We Follow Wetin Bible Talk?

1. Why we need help?

This people follow wetin Bible talk: Mama wear im pikin sit belt when dem enter motor; One pikin and im pikin wear helmet when dem ride Bicycle; woman wey get belle, one man wey dey work wear helmet

How wetin Bible talk fit help us make we no enter wahala?​—PSALM 36:9.

God wey make us get sense pass us well well. God like us as papa take like im pikin. E no make us make we dey our own. (Jeremiah 10:23) As small pikin want make im mama and papa dey help am, na so we self take need God to help us. (Isaiah 48:​17, 18) God give us im law for Bible, to take help us.—Read 2 Timothy 3:16.

The law wey Jehovah give us dey teach us how we go take dey live better life now and e still dey show us how we fit get life wey no go end. As e be sey na God make us, e good make we dey follow wetin e talk. That one go show sey we like as e dey help us.—Read Psalm 19:​7, 11; Revelation 4:11.

2. The things wey God tell us for inside Bible, wetin dem be?

Law for inside Bible, na wetin we must do because na wetin God want. But e get other things wey Bible still talk wey go make our life better if we do dem. (Deuteronomy 22:8) We must use our sense well take sabi how wetin Bible talk go help us. (Proverbs 2:​10-12) For example, Bible talk sey na God give us life. If we remember sey na God give us life, e go help us for our work, for house, or if we dey travel. E go help us know wetin we suppose do make we no enter trouble.—Read Acts 17:28.

3. Which two command big pass?

Jesus talk about two command wey big pass. The first one go help us know why God make us​—make we sabi am, love am, and serve am well. Make we dey think about this command before we do anything. (Proverbs 3:6) People wey dey follow this command go happy well well, and dem go be God friend. Dem go get life wey no go end.—Read Matthew 22:​36-38.

The second command go help you live with people well. (1 Corinthians 13:​4-7) If we dey treat people the wey God dey treat dem, na the second law we dey follow.—Read Matthew 7:12; 22:​39, 40.

4. Wetin we go gain if we follow wetin Bible talk?

Family wey dey happy

Bible dey teach family how dem go take live together with love. (Colossians 3:​12-14) Bible help husband and wife know sey e no good make dem scatter their marriage.—Read Genesis 2:24.

If we dey follow wetin Bible talk, we go fit manage our life well. For example, oga for work dey like people wey dey talk true and wey dey serious for their work. (Proverbs 10:​4, 26; Hebrews 13:18) Bible teach us how we go take let wetin we get reach us. E still teach us how we go take like God pass anything for this world.—Read Matthew 6:​24, 25, 33; 1 Timothy 6:​8-10.

If we do wetin Bible talk, we no go dey sick anyhow. (Proverbs 14:30; 22:​24, 25) For example, if we follow wetin Bible talk about drink, e go free us from bad bad sickness and we no go dey get accident anyhow. (Proverbs 23:20) Jehovah no talk sey make we no drink, but e no want make we drink too much. (Psalm 104:15; 1 Corinthians 6:10) All this things wey dey Bible, dey teach us wetin we go dey do and e still dey help us for wetin we dey think. (Psalm 119:​97-100) Correct Christian today dey serve God because dem love am, no be because of wetin dem want gain.—Read Matthew 5:​14-16.

If you want learn more about this topic, read chapter 12 and 13 for this book What Can the Bible Teach Us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share