Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 15 ques. 1-4
  • Why E Good Make You No Stop to Dey Learn About Jehovah?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Why E Good Make You No Stop to Dey Learn About Jehovah?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • How You Go Take Near God?
    Good News Wey Come From God!
  • No Comot for Jehovah Side
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Who God Be?
    Good News Wey Come From God!
Good News Wey Come From God!
fg lesson 15 ques. 1-4

LESSON 15

Why E Good Make You No Stop to Dey Learn About Jehovah?

1. Wetin you go gain if you no stop to dey learn Bible?

Two women dey study Bible when dem dey for break

All the things wey you don learn for this book don make the love wey you get for Jehovah strong. If you want make this your love strong well well, make you still dey learn more about Jehovah. (1 Peter 2:⁠2) Na only if you no stop to dey learn about Jehovah, you go get that life wey no go end.—Read John 17:3; Jude 21.

As you dey learn more about Jehovah, your faith go dey strong. This your faith go help you dey do wetin go make God happy. (Hebrews 11:​1, 6) E go make you repent and your life go better.—Read Acts 3:19.

2. How other people fit gain from the things wey you don learn?

One woman dey pray to God

You and Jehovah fit be tight friend

When you hear better news, e dey sweet you for body to tell other people? As you dey learn Bible, you go come sabi how to dey use Bible tell other people about Jehovah.—Read Romans 10:​13-15.

The way wey many people start to dey preach be sey, dem go first preach for their friend and family dem. But e good make you use your sense do am. Instead make you tell dem sey the way wey dem dey serve God no correct, tell dem about wetin God promise. No forget sey wetin people see you dey do na im dey touch dem pass the one wey you use your mouth talk.—Read 2 Timothy 2:​24, 25.

3. If you and God na friend, wetin you go enjoy?

As you dey learn Bible, the love wey you get for God go dey strong. You go see as you go take near God well well. You go come be like one of im pikin.—Read 2 Corinthians 6:⁠18.

4. How you go take continue to learn about Jehovah?

If you no stop to dey learn Bible, you go sabi how to do wetin God want. (Hebrews 5:​13, 14) Tell any Jehovah Witness person make e come teach you Bible with one book wey dem dey call What Can the Bible Teach Us? You go see am sey as you dey learn from Bible, your life go dey better.—Read Psalm 1:​1-3; 73:​27, 28.

Jehovah Witness bring new book wey dem go use take study Bible with dem

Jehovah na God wey dey happy, na im make this good news come from am. If you dey near people wey dey serve God, e go make you dey near God well well. (Hebrews 10:​24, 25) As you dey try to do wetin God want, e mean sey you want that life wey no go end. The best thing wey you fit do for this life na to near God.—Read 1 Timothy 1:11; 6:⁠19.

If you want learn more about this topic, read chapter 18 for this book What Can the Bible Teach Us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share