LESSON 7
Dem Build Tall House for Babel
After the heavy rain, Noah pikin and their wife born many pikin. Their family come dey many, dem come dey go different different place for the earth as Jehovah sey make dem do.
But some people no do wetin Jehovah talk. Dem sey: ‘Make we build one house wey tall well well so that we go stay here. We go build one house wey go tall reach heaven. People go come know us well well.’
Because Jehovah no like wetin dem dey do, e come stop dem. You know how e take do am? E make dem start to dey speak different different language. As dem no come dey understand theirself, dem come stop the work. The place wey dem dey build come be Babel, wey mean “Confusion.” People come start to dey go different different place for the earth. But dem still continue to dey do bad things for where dem go. But you think sey some still dey wey love Jehovah? Make we see.
‘Anybody wey dey carry shoulder go see disgrace, but anybody wey no dey carry shoulder go get high position.’—Luke 18:14