Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 December p. 2
  • Dey Touch People Mind With “Keep Yourselves in God’s Love” Book

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dey Touch People Mind With “Keep Yourselves in God’s Love” Book
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 December p. 2

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Wetin We Go Do To Make How We Dey Preach Better—Dey Touch People Mind With “Keep Yourselves in God’s Love” Book

WHY E GOOD: People must learn wetin Jehovah like and do am so that e go accept their worship. (Isa 2:​3, 4) “God’s Love” book na the second book wey we dey use do Bible study. E dey help Bible student know how the advice wey dey Bible go take help am everyday for im life. (Heb 5:14) We must do our best to make sure sey we touch their mind, so that dem go really see why e good make dem change some things for their life.​—⁠Ro 6:⁠17.

One sister dey conduct Bible study with one woman

HOW YOU GO DO AM:

  • Prepare well and think of how you go fit help your student. Ask am different different question wey go make am talk wetin dey im mind and wetin e think about the things wey e dey learn.—Pr 20:5; be 259

  • Use all the box wey dey the book take help your student see why e good to follow the advice wey dey Bible

  • Help your student think of how e go take choose the correct thing to do, but no choose for am.—Ga 6:5

  • Use sense take see whether your student need help to fit follow some advice wey dey Bible. Sofri encourage am make e change some kind way e take dey do things to show sey e really love Jehovah.—Pr 27:11; Joh 14:⁠31

Make sure sey una study “God’s Love” book finish. Even after the student don baptize, you fit still count the time, the return visit, and the Bible study until una finish the book.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share