CHAPTER ONE
Who God Be?
1, 2. Which kind question people dey ask?
SMALL small children dey ask question well well. If you try answer dem, dem go still ask, ‘Why?’ And if you still try answer, dem fit still ask, ‘Why e be like that?’
2 Whether we be small pikin or whether we don grow, all of us dey ask question. We fit ask about wetin we go chop, the kind cloth wey we go wear or wetin we go buy. We fit still get some question wey dey worry us for mind about life and how our tomorrow go be. But if we no see better answer, we fit stop to dey ask question.
3. Why many people think sey dem no fit get answer to their question?
3 Bible get answer to all this better question wey we dey ask? Some people know sey the answer dey Bible, but dem think sey e too hard to understand. Dem fit think sey na only people like their teacher, priest and pastor know the answer. And some people dey shame to talk sey dem no know the answer. Wetin you think?
4, 5. Which kind question you fit ask? Why e good make you no stop to dey find the correct answer?
4 You fit don get question wey dey worry you for mind, some of dem fit be: Why God make human being? Wetin dey happen to person when e die? How God be? Jesus na teacher wey people know well well, and e talk sey: ‘Continue to dey ask and dem go give una, continue to dey find and una go see am, continue to dey knock and dem go open for una.’ (Matthew 7:7) Make you no tire to dey ask question until you find the correct answer.
5 Get am for mind sey you go see the correct answer for Bible, if you ‘no stop to dey find am.’ (Proverbs 2:1-5) The answer no too hard to understand. Wetin you learn go make life sweet you now and go make you get better tomorrow. Make we come talk about one question wey dey worry many people for mind.
GOD REALLY LOVE US?
6. Why some people dey talk sey God no really love dem?
6 Many people think sey God no really love us. Dem dey talk sey, if God really love us, this world for better pass like this. Because people dey fight war, people hate each other, and wahala full everywhere. Sickness dey, people dey suffer and dey die. Some people dey talk sey, ‘If God really love us, why e never comot all this suffer suffer?’
7. (a) How some people take dey teach people sey God wicked? (b) Why we dey sure sey God hand no dey for the bad things wey dey happen?
7 Some people wey talk sey dem dey teach people about God dey make people believe sey God wicked. If bad thing happen, dem dey talk sey na so God want am. This kind talk show sey dem dey blame God for wetin happen. But Bible talk sey God no dey cause bad thing at all. James 1:13 tell us sey God no dey use bad thing test us. E talk sey: ‘When person get problem, make e no talk sey: Na God dey test me. Because person no fit use bad thing test God and God no dey use bad thing test person.’ This one mean sey even though sey God never stop all the bad things wey dey happen, no be im dey cause am. (Read Job 34:10-12.) Make we see one example.
8, 9. Why e no good to dey blame God for our problem? Give example.
8 Think about one boy wey dey stay with im papa and mama. Im papa like am well well and e teach am how e go take live better life. After some time, the boy come start to dey misbehave, e come pack comot for house. As e dey do the bad things wey e dey do, e come enter trouble. You go talk sey na the papa cause wetin happen, because e let am comot for house? No! (Luke 15:11-13) Like that papa, God no dey stop people wey choose to dey do wetin dey their mind. So if bad thing happen, make we remember sey no be God cause am. E no go good to dey blame God for the bad things wey dey happen.
9 But why God never stop all this bad things wey dey happen? For Chapter 11, you go learn wetin Bible talk about this matter. But make you dey sure sey God love us well well and we no suppose blame am for our problem. The truth be sey na only God go fit solve all our problem.—Isaiah 33:2.
10. Why we fit dey sure sey God go comot all the wahala wey bad people don cause?
10 God dey holy. (Isaiah 6:3) Everything wey e dey do dey holy, clean and good. We fit trust am. Human being no be like that. Sometimes dem dey do bad things. And even person wey dey rule with better mind no get the power to comot all the wahala wey bad people cause. Nobody get power reach God. E go fit comot all the wahala wey bad people don cause and e go do am. E go comot bad things forever.—Read Psalm 37:9-11.
HOW E DEY DO GOD FOR BODY WHEN PEOPLE DEY SUFFER?
11. How e dey do God for body when person dey suffer?
11 How e dey do God for body when e see wetin dey happen for this world and wetin dey happen to you? Bible talk sey God ‘hate partial.’ (Psalm 37:28) When people dey do good, God like am, but when dem do bad, e hate am. E hate am when people dey suffer. Bible talk sey ‘e pain Jehovah for mind’ the time wey bad thing full this world for Noah time. (Genesis 6:5, 6) God never change. (Malachi 3:6) Bible talk sey God really love you.—Read 1 Peter 5:7.
We learn for Bible sey na Jehovah make everything for heaven and for this earth
12, 13. (a) Why we love people and how we dey feel about the suffer wey dey this world? (b) Why you dey sure sey God go comot all the suffer suffer and partial wey dey this world?
12 Bible still talk sey God make us make we resemble am. (Genesis 1:26) This one mean sey na God give us the kind better character wey e get. So if e dey pain you when you see people wey dey suffer, make you know sey e pain God pass you! How we take know?
13 For Bible we learn sey ‘God na love.’ (1 John 4:8) Na love make God dey do everything wey e dey do. Because God na love, na im make we self dey love. Think am: If you get power to comot all the suffer suffer and partial wey dey this world, you go like do am? Yes, you go do am because you love people. What of God? E get power, and because e love us, e go comot all the suffer suffer and partial wey dey this world. Get am for mind sey all the things wey God don promise for the beginning of this book go happen! But for you to fit believe this promise, you need to learn more about God.
GOD WANT MAKE YOU KNOW AM
If you want make person be your friend, you go tell am your name. God tell us im name for inside Bible
14. Wetin be God name, and how we take know sey we suppose dey use am?
14 If you want make person be your friend, wetin be the first thing wey you go tell am? Na your name. God get name? Many people sey im name na God or Lord, but that one no be im name. E just be like when you call person “king” or “president,” na im name be that? God don tell us sey im name na Jehovah. Psalm 83:18 talk sey: ‘Make people know sey you, wey your name na Jehovah, na only you High Pass for the whole world.’ People wey write Bible use God name many times. Jehovah want make you know im name and make you dey use am. E tell you im name so that you go fit be im friend.
15. Wetin the name Jehovah mean?
15 God name wey be Jehovah, get big meaning. E mean sey God fit make anything wey e promise happen and sey e fit do anything wey e get for mind, nothing go fit stop am. Na only Jehovah fit bear this name.a
16, 17. Wetin e mean when Bible talk sey Jehovah na (a) ‘Almighty’? (b) ‘King wey dey rule forever’? (c) The person wey make everything?
16 As we don see for Psalm 83:18, e talk sey: ‘Na only you High Pass.’ Revelation 15:3 still talk sey: ‘Jehovah God wey be Almighty, everything wey you do plenty well well and dem good finish. All your way dey clean and true, King wey dey rule forever.’ We dey call Jehovah ‘Almighty’ and ‘King wey dey rule forever.’ Wetin this one mean? ‘Almighty’ mean sey nobody get power reach Jehovah for heaven and this earth. And ‘King wey dey rule forever’ mean sey e don dey tey tey and e no dey die. Psalm 90:2 show sey God no get beginning and e no get ending. You no happy sey you know this one?
17 Na only Jehovah make everything. Revelation 4:11 talk sey: ‘Jehovah our God, na only you get all the power, praise and respect because na you make everything. Everything dey, because you want am like that.’ Na true, all the angel wey dey heaven, all the star, the fruit wey dey grow for tree, and even fish wey dey river, na Jehovah make everything.
YOU FIT BE JEHOVAH FRIEND?
18. Why some people think sey dem no go ever fit be God friend? But wetin Bible teach us?
18 If some people just read about the kind person wey Jehovah be, fear go catch dem. Na because dem think sey God too get power, e too high, e too far from dem, and e no go get their time. You think sey na so God want make we dey think? No be so! Jehovah want near us. Bible talk sey God no far from all of us. (Acts 17:27) God want make we near am, and e don promise us sey e ‘go near us.”—James 4:8.
19. (a) Wetin you go do to be God friend? (b) Which one of God character you like pass?
19 Wetin you go do to be God friend? Jesus talk sey: ‘Dem go get life wey no go end, if dem sabi you wey be the only true God, and sabi your Son wey you send come this world, Jesus Christ.’ (John 17:3) Continue to dey learn so that you go know more about Jehovah and Jesus. E go help you get that life wey no go end. For example, we don learn sey ‘God na love.’ (1 John 4:16) But God still get other better better character. Bible tell us sey Jehovah dey ‘pity and dey feel for person, e no dey quick vex, im love no dey fail and e dey talk true everytime.’ (Exodus 34:6) Jehovah ‘good and e ready to forgive.’ (Psalm 86:5) God dey patient and e no dey leave im people. (2 Peter 3:9; Revelation 15:4) As you dey read about Jehovah for Bible, na so you go dey learn about the character wey e get.
20-22. (a) How you go take near God even if we no dey see am? (b) If other people want make you stop to dey study Bible, wetin you go do?
20 How you go take near God even if you no fit see am? (John 1:18; 4:24; 1 Timothy 1:17) As you dey read about Jehovah for Bible, you go come dey see am as real person. (Psalm 27:4; Romans 1:20) As you dey learn about Jehovah, you go dey love am more more and una go come be tight friend.
Na true sey better papa love im pikin well well, but na our Father for heaven love us pass
21 You go come know sey Jehovah na our Father. (Matthew 6:9) Na im give us life, and e want make our life better. Na that kind thing better papa go want make im pikin get. (Psalm 36:9) The truth be sey, we learn for Bible sey we go fit be Jehovah friend. (James 2:23) Just think about am, Jehovah wey make everything for heaven and earth, want make you be im friend!
22 Some people go want make you stop to dey study Bible. Dem fit dey fear sey you go change wetin you believe. Make you no let anybody stop you to be Jehovah friend. Because you no fit get any other friend wey better pass Jehovah.
23, 24. (a) Why e good make you no stop to dey ask question? (b) Wetin the next chapter go talk about?
23 As you dey study Bible so, no be everything you go understand finish, make you no shame to ask question or sey make dem help you. Jesus sey make we dey carry body down like small children. (Matthew 18:2-4) And you know sey small children no dey shame to ask question. God want make you get answer to your question. So make you take time dey study Bible and make sure sey na the truth you dey learn.—Read Acts 17:11.
24 The way wey better pass to learn about Jehovah na to study Bible. The next chapter go tell us wetin make Bible different from other book.