Wetin Dey Part 11
For this part, we go start to learn about the Christian Greek Scriptures wey start from the Bible book of Matthew. Na one family wey no too get money born Jesus for one small town. Jesus learn carpenter work from im papa. Na im go save everybody for this world. Jehovah don choose am as King of im Kingdom for heaven. If you be papa or mama, help your pikin see sey the family wey Jehovah choose to born Jesus dey serve Jehovah well. We go see how Jehovah take save am from King Herod wey want kill am. And we go see sey nothing fit stop Jehovah to make wetin e want happen. Learn how Jehovah take choose John to clear road for Jesus. Still help your pikin see how Jesus take show sey e love Jehovah Law and e ready to follow am, even when e dey young.