SONG 9
Jehovah Na Our King!
(Psalm 97:1)
1. Come sing, come make we praise Jehovah.
All the things wey e make praise am ev’ry day.
Make we sing for our God, make we go preach im Word,
Make we join our voice and praise im name!
(CHORUS)
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
Praise Jehovah God wey be our King!
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
We go praise Jehovah God our King!
2. Jehovah get power to save us.
Think about all the things wey e don dey do.
All the things wey we get, all the things we dey see,
Na Jehovah God we go dey praise.
(CHORUS)
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
Praise Jehovah God wey be our King!
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
We go praise Jehovah God our King!
3. No other god fit reach Jehovah.
Dem go shame, yes because their power dey fail.
Now Jehovah our King don choose Jesus to rule
For im Kingdom wey go rule the earth.
(CHORUS)
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
Praise Jehovah God wey be our King!
Make the heavens praise God! Make we join dem praise am,
We go praise Jehovah God our King!
(Still check 1 Chron. 16:9; Ps. 68:20; 97:6, 7.)