SONG 44
Prayer of Person Wey Dey Face Problem
(Psalm 4:1)
1. Jehovah I dey pray to you, abeg make you hear me.
This problem wey dey worry me
dey make life hard for me.
I don dey think, I no fit sleep
because I just dey fear.
Na you Jehovah go help me
because you no dey fail.
(CHORUS)
Help me my God, make I no fall.
When I dey fear, help me get mind.
When problem come, na you I trust.
Na you my God, go make me strong.
2. Your Word dey give me power
wey dey make me no dey fear.
When I dey pray inside my mind,
na only you fit hear.
Sometimes I fit dey think am sey
my problem no go end.
But Bible dey help me know sey
your power no dey fail.
(CHORUS)
Help me my God, make I no fall.
When I dey fear, help me get mind.
When problem come, na you I trust.
Na you my God, go make me strong.
(Still check Ps. 42:6; 119:28; Rom. 8:26; 2 Cor. 4:16; 1 John 3:20.)