SONG 71
We Be Jehovah Army!
(Joel 2:7)
1. We be Jehovah army,
We dey work with God.
Even if Satan dey vex,
And dey try to stop us,
This one no go make us shake.
Jesus dey with us.
We go still dey go preach,
Since na God we trust.
(CHORUS)
We be Jehovah army.
Jesus train us well.
Make we go tell people:
“God Kingdom dey rule.”
2. We be Jehovah servant.
We dey do im work.
We dey find people like sheep,
Wey don lost for this world.
Make we try dey go teach dem
Truth about our God.
Make we still invite dem
Come our Kingdom Hall.
(CHORUS)
We be Jehovah army.
Jesus train us well.
Make we go tell people:
“God Kingdom dey rule.”
3. We be Jehovah army.
Yes, we don ready.
Na Jesus Christ our oga
We dey try dey copy.
Make we shine our eye well well,
Satan no dey sleep.
E go try to fight us,
But na we go win.
(CHORUS)
We be Jehovah army.
Jesus train us well.
Make we go tell people:
“God Kingdom dey rule.”
(Still check Eph. 6:11, 14; Phil. 1:7; Philem. 2.)