You Still Remember?
You don take time read the Watchtower wey never tey wey we print? See whether you fit answer all this question:
Why Jehovah gree make Israel people go fight war?
Jehovah love people. But sometimes e dey let im people go fight wicked people wey dey suffer dem. Na only God dey talk who go join fight the war and when dem go fight.—w15-E 11/1, pp. 4-5.
Wetin papa and mama go do to teach their pikin wey dey 13 to 19 years to serve Jehovah?
E good make papa and mama dey show sey dem love their pikin and show sey dem no dey carry shoulder up. E still good make papa and mama dey use sense know wetin dey their pikin mind and make dem try know the kind person wey their pikin be.—w15-E 11/15, pp. 9-11.
Why we no believe sey pope take over from Peter?
Matthew 16:17, 18 no talk sey na apostle Peter go be the head for congregation. Bible show sey na Jesus be the cornerstone for the congregation no be Peter. (1 Pet. 2:4-8)—w15-E 12/1, pp. 12-14.
Wetin we suppose think about before we talk?
To use our mouth well, make we know (1) when we suppose talk (Eccl. 3:7), (2) wetin we suppose talk (Prov. 12:18), and (3) how we suppose talk (Prov. 25:15).—w15-E 12/15, pp. 19-22.
Which things Christian no suppose put hand?
Better Christian no dey talk lie and dem no dey spoil people name. Dem no dey talk bad thing wey fit make person cry, dem no dey thief and play wayo.—wp16.1-E, p. 5.
Which people be the ‘chief priest’ wey Bible talk about?
This people wey be ‘chief priest’ na the priest dem wey their level high pass other priest own. People wey don work as high priest before still follow for ‘chief priest.’—wp16.1-E, p. 10.
How we suppose treat people wey dey eat the bread and drink the wine for Memorial?
We no dey take dem as oga. Anybody wey really be “anointed” no go want make dem take am as oga. E no go dey show imself. (Matt. 23:8-12)—w16.01-E, pp. 21-23.
Wetin we fit learn from how Abraham take be God friend?
E fit be sey na from Shem Abraham take learn about God. E sabi the kind person wey God be from the way God treat am and im family. We fit still do like that.—w16.02-E, pp. 4-6.
How Bible take get chapter and verse?
Na Stephen Langton wey be one church leader for olden days put all the chapter for Bible. Na some Jew people wey sabi copy book put verse for the part of Bible wey dem use Hebrew language write. Robert Estienne put verse for the part wey dem use Greek language write.—wp16.2-E, pp. 14-15.
How Satan take carry Jesus go tempt for temple?
Matthew 4:5 and Luke 4:9 fit mean sey na vision Satan take carry Jesus go there or na one high place for the temple Jesus stand. So we no fit talk how Satan take do am.—w16.03-E, pp. 31-32.
How your preaching fit be like dew?
Dew dey form small small. E dey cool body and e good for life. God take dew bless us. (Deut. 33:13) As all of us wey dey serve Jehovah join hand for this preaching, our preaching go be like dew wey dey cool body and wey good for life.—w16.04, p. 32.