Who We Go Respect and Praise?
‘Make we dey respect, praise and bless the Person wey sitdown for the throne and the Lamb. Na dem get the glory and power forever and ever.’—REV. 5:13.
1. Wetin fit make us respect and praise some people, and wetin we go learn for this topic?
SOMETIMES, e get people wey we dey like to respect and praise. E fit be because of the good thing wey dem do, or because dem get level pass us. For this topic, we go talk about who we go respect and praise, and why.
2, 3. (a) Why we suppose respect and praise Jehovah? (Check the first picture.) (b) Who be the Lamb for Revelation 5:13, and why we suppose respect and praise am?
2 Revelation 5:13 talk sey we suppose respect and praise Jehovah ‘the Person wey sitdown for the throne and the Lamb.’ Revelation chapter 4 come talk something wey suppose make us praise Jehovah, the Person wey no dey die. E sey: ‘Jehovah our God, you reach to get the power, praise and respect because na you make everything. Everything dey, because you want am like that.’—Rev. 4:9-11.
3 Na Jesus Christ be the Lamb wey Revelation 5:13 dey talk about. Yes, na im be ‘God Lamb’ wey carry our sin comot. (John 1:29) Bible talk sey Jesus high pass all the people wey be king and wey don be king. E sey: ‘Na im be the King of people wey dey rule as king and the Lord of people wey dey rule as lord. The only person wey no go die, and wey dey stay for light wey nobody fit near. No human being don see am or fit see am.’ (1 Tim. 6:14-16) True true, which king be like Jesus wey die for us? You no go like join the many angel for heaven wey dey sing sey: ‘The Lamb wey dem kill, praise, respect, blessing, power, sense, glory and better things suppose be im own.’—Rev. 5:12.
4. Wetin make to respect and praise Jehovah and Jesus no be matter of ‘if you like’?
4 To respect and praise Jehovah and Jesus no be matter of ‘if you like.’ We must do am if we want life wey no go end. Wetin Jesus talk for John 5:22, 23 show sey that one na true. E talk sey: ‘My Father no dey judge anybody at all, but e choose im Son to judge so that everybody go respect the Son as dem take dey respect the Father. Anybody wey no gree respect the Son no dey respect the Father wey send am.’—Read Psalm 2:11, 12.
5. Why e good to respect people and praise dem for wetin dem dey do?
5 Jehovah make people to fit get the kind character wey e get. (Gen. 1:27) Na im make many people fit do good things, only sey some dey do am pass some. For example, people sabi show love and pity person. God still give us the kind mind wey fit help us know whether wetin we do good or bad. But some people mind dey make dem feel sey bad na good. (Rom. 2:14, 15) Many people like things wey fine and clean, and dem no want get problem with anybody. Whether dem know or dem no know, dem dey show some of the better character wey God get. So, this one suppose make us respect dem and even praise dem for wetin dem dey do.—Ps. 8:5.
KNOW WHERE TO RESPECT AND PRAISE PERSON REACH
6, 7. How Jehovah people take different from other people for this praise matter?
6 E good make we know who we fit praise and where to praise am reach. Many people for this world like to copy wetin other people dey do. Dem go dey praise pastor, politician, people wey dey do sports, act film, or musician like sey dem be god. Dem no know where to praise dem reach. Because of this one, young and old people dey want copy their character, the way dem dey dress and how dem dey talk.
7 People wey dey serve Jehovah no suppose praise human being like that. Na Jesus Christ be the only person wey we suppose copy. (1 Pet. 2:21) God no go happy if we no know where we suppose praise people reach. Make we no forget wetin Bible talk, when e sey: ‘All of us don sin and we no fit reach the level wey God don set for us.’ (Rom. 3:23) The truth be sey we no suppose praise anybody like god.
8, 9. (a) How Jehovah servant take dey treat government people? (b) Where we go obey dem reach?
8 Every country get people wey dey work for government and this people get different different work wey dem dey do. All of dem dey join hand to make sure sey peace dey their country and dem dey care for the people. Everybody dey enjoy from their work. Na wetin make apostle Paul advise Christian dem to obey government. E tell dem sey: ‘Give everybody wetin dem suppose get: the one wey you suppose give tax, give am tax; the one wey you suppose respect, respect am.’—Rom. 13:1, 7.
9 Na this one make Jehovah servant dey respect, support, and praise government people for their work. We dey do wetin the government for our country talk. But Bible tell us where we suppose obey dem reach. We no go do wetin God no like or put hand for politics and war matter if na wetin government want be that.—Read 1 Peter 2:13-17.
10. How people wey serve Jehovah before our time show example of how to treat government people?
10 People wey serve Jehovah before our time, show us better example of how we suppose treat government and people wey dey work for dem. For example, e get one time wey Rome government want know how many people dey where dem dey rule. Joseph and Mary do wetin dem talk. Dem come travel go Bethlehem even though sey Mary get belle and e go soon born im first pikin. (Luke 2:1-5) And for apostle Paul time, some people lie sey e do wetin bad. Wetin e come do? When e dey talk to King Herod Agrippa and Festus, wey be governor for Judea wey Rome dey control, e no talk to dem anyhow. Instead e respect and praise dem.—Acts 25:1-12; 26:1-3.
11, 12. (a) Why we no dey praise people wey dey lead for religion as we dey do for government people? (b) Which better thing happen because of how one brother for Austria take treat one politician?
11 Even if people wey dey lead for religion want make we dey praise dem, we no go do am. Why? Because dem dey talk lie about God and dem no dey teach wetin dey Bible. Na im make we no suppose praise dem for their work. Instead we go respect dem like other people. Make we no forget wetin Jesus call people wey dey lead religion for im time. E sey dem be bad leader and pretender. (Matt. 23:23, 24) But we fit praise people wey dey government for their work. And sometimes better things dey happen because of this one.
12 Na wetin happen to our brothers for Austria be that. For World War II, government for Germany arrest brother Leopold Engleitner wey come from Austria. Dem use train carry am go one prison for Buchenwald. For the train, e meet one man wey be politician for Austria. Im name na Dr. Heinrich Gleissner. Germany government arrest this man because dem no like am. Brother Engleitner respect this man and preach to am as dem dey the train. The man listen well as e dey preach for am. When the war end, Gleissner help the brothers for Austria many times because e know people for government. E get other example wey talk about how Jehovah people take respect government as Bible talk and the better things wey happen. Which one you remember?
OTHER PEOPLE WEY WE GO RESPECT AND PRAISE
13. Which people we suppose praise and respect well well, and why?
13 We suppose dey praise and respect brothers and sisters for congregation, especially elders, circuit overseer, Branch Committee, and Governing Body wey dey direct us. (Read 1 Timothy 5:17.) We no dey look where dem come from, whether dem go school, who dem be for the area or whether dem get money before we go respect or praise dem. Bible talk sey dem be ‘gift’ wey Jehovah don give congregation. And Jehovah dey use dem care for im people. (Eph. 4:8) Brothers and sisters for apostle dem time, respect this kind people well well. Na so we self dey do today. When dem dey with us, we no dey treat dem like sey dem be god or angel. But we dey respect and praise dem because even though sey dem dey do plenty work for us, dem no dey raise shoulder.—Read 2 Corinthians 1:24; Revelation 19:10.
14, 15. How elders for congregation take different from people wey dey lead for religion?
14 This elders be like shepherd wey sabi take care of sheep. Dem dey carry body down. Dem no dey let anybody treat dem like people wey dey act film or sing music. This one make dem different from people wey dey lead for religion today and for Jesus time. Jesus talk sey: ‘When dem go party, dem like to sitdown for where big man dey sitdown and for front chair for synagogue and dem like make people dey hail dem for market.’—Matt. 23:6, 7.
15 Elders dey do wetin Jesus talk when e sey: ‘Make dem no call una Rabbi, because na one person be una Teacher, and all of una na brothers. Make una no call anybody for this world una Father, because una get one Father for heaven. And make people no call una leader, because una get one Leader, Christ. But the person wey big pass among una must be una servant. Anybody wey carry imself up, God go bring am down, and anybody wey carry imself down, God go carry am up.’ (Matt. 23:8-12) Na this one make Jehovah people for the whole world love, respect and dey praise the elders for congregation.
When elders no dey carry shoulder up, e go make brothers and sisters love, respect and praise dem (Check paragraph 13-15)
16. Why e good make we try follow wetin Bible talk about how to praise and respect person?
16 The truth be sey, e fit hard to know who we suppose praise and where we suppose praise and respect dem reach. Na so e still be for some Christian for apostle time. (Acts 10:22-26; 3 John 9, 10) But e good to do everything wey we fit do to follow wetin Bible talk about this matter. We go gain many things when we know who to praise and where to praise and respect dem reach.
WETIN WE GO GAIN WHEN WE KNOW WHERE TO PRAISE AND RESPECT PERSON REACH
17. Wetin fit happen if we dey praise and respect people?
17 When we dey respect and praise people, e go make dem no disturb our preaching work. Many times, e dey make dem know sey na better work we dey do. This na wetin happen to Birgit, one sister wey be pioneer for Germany. One time wey e go im pikin graduation for school, the teachers tell am sey dem happy to dey teach Jehovah Witness children wey dey the school. Dem talk sey e for bad well well if no Jehovah Witness pikin dey the school. Birgit come tell dem sey, ‘We dey teach our children to follow wetin dey Bible. And Bible talk sey make dem dey respect and praise their teacher.’ One teacher come talk sey, ‘If all the children be like una own, to teach go sweet well well.’ After some weeks, one of the teacher follow go convention for where dem dey call Leipzig.
18, 19. Wetin we go remember as we dey try respect and praise elders?
18 Na wetin Bible talk go help us know where to praise and respect elders reach. (Read Hebrews 13:7, 17.) Make we dey praise dem for the better work wey dem dey do. Make we still dey do wetin dem tell us to show sey we respect dem. This one go make dem happy to do the work. But to respect and praise elders no mean sey we go begin copy one elder wey we feel sey people sabi. E fit be how e dey dress, the kind hair wey e dey barb, the way e dey do when e dey give talk or even how e take dey talk with people. If we do am, e go come be like sey na that elder we dey follow no be Jesus. Make we no forget sey the elder na person like us wey get sin for body.
19 If we dey respect and praise elders as we suppose, we dey help dem. How? Dem no go begin carry shoulder up, dey feel sey dem be oga or sey na dem good pass.
20. Wetin we go gain when we know where to praise and respect person reach?
20 Another thing be sey, if we know who we suppose praise and where we suppose praise and respect dem reach, we dey help ourself. E go make us no dey think about only ourself or begin carry shoulder when dem praise us. We go dey do wetin Jehovah organization talk because Jehovah no want make we dey praise people pass as we suppose praise dem. E go still help us make we no comot for Jehovah side if person wey we dey respect well well, do wetin we no believe sey e fit do.
21. How Jehovah go feel if we know who we suppose praise and where we suppose praise and respect dem reach?
21 The one wey better pass be sey, we go make Jehovah happy when we know who we go praise and where we suppose praise and respect dem reach. E go still show sey we dey do wetin e want and we go continue to serve am well. Jehovah go come know how to answer anybody wey want insult am. (Prov. 27:11) Many people for this world no know who dem suppose praise and where dem suppose praise and respect dem reach. But we thank Jehovah because e don teach us how to do am.