Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 March pp. 13-17
  • Your Faith Go Help You Choose Wetin Good

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Your Faith Go Help You Choose Wetin Good
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • TO CHOOSE NA NORMAL THING
  • E GOOD MAKE OTHER PEOPLE CHOOSE FOR US?
  • NO LET YOUR MIND CONTROL WETIN YOU GO DO
  • WHEN YOU FIT CHANGE WETIN YOU DON CHOOSE?
  • DO WETIN YOU DON CHOOSE
  • How You Dey Choose Wetin You Go Do?
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 March pp. 13-17
Jehovah send fire from heaven to burn Elijah sacrifice

Your Faith Go Help You Choose Wetin Good

‘Get faith as you dey ask. No get double mind at all.’—JAS. 1:6.

SONG: 81, 70

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Why we fit talk sey to choose na normal thing?

  • Why e no good make other people choose for us?

  • Wetin fit make us change wetin we don choose?

1. Why Cain no choose wetin good, and wetin come happen?

CAIN for Bible need to choose. E go control im temper or let im temper make am sin? Anyone wey e choose fit make am suffer or enjoy life. But, Cain no choose well. E kill im brother Abel. Because of wetin e do, e no come be God friend again.​—⁠Gen. 4:​3-16.

2. Why e good to choose well?

2 Like Cain, all of us need to choose wetin we go do. E fit no be wetin go make other people die. But, anything wey we choose fit make us suffer well well or enjoy life. Na im make if we dey choose wetin good, we no go too get problem for life. But if we dey choose wetin bad, na so so wahala we go see for life.​—Prov. 14:⁠8.

3. (a) Wetin go help us choose wetin good? (b) Which question dem we go talk about?

3 Wetin go help us choose wetin good? (1) We must get faith sey Jehovah ready to help us and e fit help us do wetin good. (2) We need to believe sey the advice wey Jehovah dey give us for Bible fit help us. (Read James 1:5-8.) As we dey near God more more and dey follow the advice wey dey Bible everytime, we go see sey na better thing Jehovah get for mind for us. This one go make us dey check wetin Bible talk before we choose wetin we go do. But how we fit continue to choose wetin good? And e good to change wetin we don choose?

TO CHOOSE NA NORMAL THING

4. Wetin Adam choose and wetin happen?

4 From the time wey God make people, dem start to choose wetin dem want. For example, Adam need to choose whether e go listen to God or im wife. Wetin e choose? E do wetin im wife tell am. And that one spoil many things. Jehovah pursue am comot from the garden and at last e die. No be only that one happen. Because of wetin e do, we still dey suffer till today.

5. Wetin give us mind sey we fit choose wetin good?

5 Some people fit think sey life go better if no be we dey choose wetin we want. Na true? No forget sey Jehovah no make us like robot wey no fit think or choose. Bible dey teach us how to choose wetin good. Even though sey Jehovah want make we choose by ourself, e no want make we enter trouble. How we take know? Make we see some example.

6, 7. Wetin Israel people need to choose and why e hard dem to choose wetin to do? (Go check the first picture.)

6 When Israel people dey Promise Land, dem need to choose whether dem go serve Jehovah or other gods. (Read Joshua 24:15.) Person fit think sey e no go hard dem to choose. But, wetin dem go choose fit make dem live or die. Around the time wey Jehovah use different different Judge save dem, Israel people no choose well many times. Dem leave Jehovah go dey serve other gods. (Judg. 2:3, 11-23) Think about another time when Israel people need to choose wetin dem want. Prophet Elijah tell dem make dem choose whether dem go serve Jehovah or the juju god wey be Baal. (1 Ki. 18:21) Elijah no happy with dem because dem dey get double mind. Since to serve Jehovah good and make sense, we fit dey think sey e go easy for dem to choose who dem go serve. True true, nobody wey dey think well go want serve Baal. But Bible talk sey Israel people ‘dey two side.’ Na im make Elijah tell dem sey make dem serve Jehovah because na that one better pass.

7 Why e hard Israel people to choose who dem go serve? One thing be sey, dem no get faith again and dem no gree do wetin Jehovah talk. Dem no take time learn about Jehovah or trust am. If to sey dem know wetin Jehovah want, dem for fit choose wetin good. (Ps. 25:12) Another thing be sey, dem follow wetin people wey no dey serve Jehovah dey do. This people change their mind and even choose who dem go serve. Na im make Israel people join dem dey serve their juju. Jehovah don already warn dem before sey this kind thing fit happen.—Ex. 23:2.

E GOOD MAKE OTHER PEOPLE CHOOSE FOR US?

8. Wetin we fit learn from Israel people example?

8 From Israel people example, e clear sey na we go choose wetin we go do. And to fit choose wetin good, we must follow wetin Bible talk. Make we remember wetin Galatians 6:5 talk. E sey: ‘Everybody get the work to carry im own load.’ (Ftn.) Make we no let another person choose wetin we go do. Instead, make we learn wetin good for God eye and do am.

9. Why e no good to let other people choose for us?

9 How other people fit make us choose wetin dem want? Na when we let dem push us to choose wetin bad. (Prov. 1:10, 15) No matter wetin other people talk, na our hand e dey to follow wetin we don learn for Bible. If we let people choose for us, we dey ‘follow dem.’ We fit land for big wahala if we let am happen.

10. Wetin Paul warn brothers for Galatia about?

10 Apostle Paul warn the brothers for Galatia about wetin fit happen if dem let other people choose for dem. (Read Galatians 4:17.) That time, some people for the congregation want choose wetin brothers go dey do. Dem want make people for congregation follow dem instead of the apostle dem. Na oversabi dey worry dem. Dem no want make the brothers use their freedom choose by theirself wetin to do.

11. How we fit help other people when dem want choose wetin dem go do?

11 Paul show us better example of how to let other people choose wetin dem go do. (Read 2 Corinthians 1:24.) When elders dey give advice for matter wey concern wetin person suppose choose by imself, make dem do like apostle Paul. Na true sey dem dey happy to show person wetin Bible talk. But, make dem sofri; make dem let the brother or sister choose by imself wetin e go do. Why? Because na the brother or sister go carry anything wey come out from wetin e choose. So make we no forget sey: If we help our brothers and sisters know wetin Bible talk about matter wey dem get, e go show sey we love dem. But make we remember sey dem get freedom to choose wetin dem go do. When dem choose wetin good, dem go happy. Make we no think sey we get right to choose for our brothers and sisters wetin dem go do.

One sister go meet one elder to advise am about how e go take fill im Durable Power of Attorney card (DPA), the elder dey show am things wey dem don write about the matter and wetin dey Bible, and after the sister come dey fill the form by imself

Elders dey show sey dem love the brothers and sisters when dem let dem choose by theirself wetin to do (Check paragraph 11)

NO LET YOUR MIND CONTROL WETIN YOU GO DO

12, 13. Wetin fit happen if we just dey follow our mind when we dey vex or no happy?

12 “Do wetin your mind tell you.” This na wetin many people today dey talk. But if we do this one, we fit enter big trouble. Another thing be sey Bible no support am. When we want choose wetin we go do, Bible warn us make we no follow our mind wey sin dey control or how we dey feel. (Prov. 28:26) Many example for Bible show the bad thing wey fit happen if person follow im mind. The main problem be sey our ‘mind dey deceive pass anything and e hard to control.’ (Jer. 3:17; 13:10; 17:9; 1 Ki. 11:⁠9) So, wetin go happen if person just dey do wetin im mind tell am?

13 Bible talk sey make we use all our mind love Jehovah and make we love our neighbor as we take love ourself. (Matt. 22:​37-39) But the Bible verse dem for paragraph 12, show wetin fit happen if we let our mind dey control wetin we go do. For example, e easy for person to do wetin good when e dey vex? You know the answer, especially if e don happen to you before. (Prov. 14:17; 29:22) Or what if person no happy, e go fit choose well? (Num. 32:6-12; Prov. 24:10) Bible show why e good make we dey let God law direct us. (Rom. 7:25) E clear sey, if we let our mind control us when we want choose wetin to do, we fit no choose well.

WHEN YOU FIT CHANGE WETIN YOU DON CHOOSE?

14. How we take know sey e no bad for person to change wetin e first choose?

14 All of us need to choose wetin good. But e mean sey we no fit change wetin we first choose? Sometimes, we fit change wetin we first choose after we think am again. For Jonah time, na wetin Jehovah do for Nineveh people be that. Bible talk sey: ‘When Jehovah see wetin dem do, how dem take comot hand from the bad things wey dem dey do, e change wetin e talk sey e go do dem. E no come do am again.’ (Jonah 3:10) As Jehovah see sey Nineveh people don repent, e change wetin e talk sey e go do. This one show sey Jehovah no dey raise shoulder, e dey feel for person and e get open mind. Another thing be sey, Jehovah no dey vex anyhow like many people today. Even if e vex, e no dey let the vex control wetin e go do.

15. Wetin fit make us change wetin we don choose?

15 Sometimes we fit see sey we need to change wetin we don choose. E fit be when condition change. Even Jehovah don change wetin e want do because things change. (1 Ki. 21:​20, 21, 27-29; 2 Ki. 20:1-5) New things wey happen fit still make us change wetin we don choose. For example, dem lie give King David about Mephibosheth wey be Saul grandpikin. When David come know sey wetin dem first tell am na lie, e change wetin e talk. (2 Sam. 16:3, 4; 19:24-29) Sometimes, e dey make sense to do like that.

16. (a) Wetin fit help us choose wetin good? (b) Why elders fit change wetin dem don first agree to do? Wetin dem go do if dem suppose to change am?

16 Bible advise us sey make we no rush when we want choose wetin we go do. (Prov. 21:5) When we take our time think well well about everything wey concern any matter, e go make us fit choose wetin good. (1 Thess. 5:21) Make papa first take im time do research for Bible and our book dem, before e choose wetin to do. E still good make e ask im wife and children wetin dem think about the matter. Remember sey God tell Abraham make e listen to im wife. (Gen. 21:9-12) Make elders self dey do research. When Governing Body talk new thing wey go make elders change how dem take dey do some things, make dem change am. Make dem no feel sey brothers go stop to respect dem. Instead, e go show sey dem get open mind and dem know where dem suppose do reach. Make dem ready to change wetin dem think and wetin dem first choose, if dem suppose change am. E good make all of us copy their example. This one go make wahala no dey congregation and everybody go dey do things as one.—Acts 6:1-4.

DO WETIN YOU DON CHOOSE

17. Wetin fit help us choose wetin good?

17 Some matter fit serious pass some. The more e serious, the more we go think about am and pray well well before we choose. For example, e fit be matter about whether to marry or who to marry. Another serious matter wey fit make Jehovah bless us, na matter about whether to pioneer and how we go take do am. For this kind matter, make we get the mind sey Jehovah fit and e go help us choose wetin good. (Prov. 1:5) So, e good make we follow wetin dey Bible and pray so that Jehovah go help us. And no forget sey Jehovah fit help us get the kind character wey go help us fit do wetin e want. Before we choose wetin to do for any serious matter, make we ask ourself: ‘Wetin I want do go show sey I love Jehovah? E go make my family happy and get peace? E go show sey I dey patient and get better mind?’

18. Why Jehovah want make we choose by ourself wetin we go do?

18 Jehovah no dey force us to love and serve am. Na we go choose. E dey let us use the freedom wey e don give us take choose by ourself whether we go serve am. (Josh. 24:15; Eccl. 5:⁠4) But, e want make we do wetin we don choose and make the thing agree with wetin Bible talk. If we believe sey Jehovah know wetin better for us and we follow wetin e talk, we go fit choose wetin good. And we no go be like river wey breeze dey blow up and down.—Jas 1:5-8; 4:8.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share