Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting
JANUARY 1-7
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 1-3
“The Kingdom wey dey Heaven Don Near”
(Matthew 3:1, 2) That time, John the Baptist come dey preach for the wilderness of Ju·deʹa, 2 sey: “Make una repent, because the Kingdom wey dey heaven don near.”
nwtsty study note for Mt 3:1, 2
dey preach: The Greek word wey dem translate as “dey preach” mean “to announce something like town crier.” E really show the way the person go take do am: Na to announce the message give many people, no be just some people.
Kingdom: Na the first time wey dem use the Greek word ba·si·leiʹa be this. E mean government wey get where e dey rule, people wey e dey rule, and king. Na 162 times dem use this word for Christian Greek Scriptures. But for only book of Matthew dem use am 55 times, and many times when dem use am, e dey talk about God Kingdom for heaven. Matthew use this word well well sotey we fit call book of Matthew, the Kingdom Gospel.
Kingdom wey dey heaven: Dem use this word for only book of Matthew about 30 times. For book of Mark and Luke, dem use “the Kingdom of God” wey mean the same thing with “the Kingdom wey dey heaven.” This one show sey na heaven the Kingdom dey, and na from there e dey rule.—Mt 21:43; Mr 1:15; Lu 4:43; Da 2:44; 2Ti 4:18.
don near: This one show sey dem go soon choose the person wey go be King for God Kingdom.
(Matthew 3:4) Now John wear cloth wey dem make with camel hair and e wear leather belt for waist. Im food na locust and bush honey.
nwtsty media
The Way John the Baptizer Be and the Kind Cloth Wey E Dey Wear
Dem make John cloth with camel hair and e wear leather belt wey dem fit use carry small small load. Na this kind cloth prophet Elijah still wear. (2Ki 1:8) Na poor people dey wear cloth wey dem use camel hair make and e no dey fine. E no be like rich people cloth wey dem dey use silk or linen make. (Mt 11:7-9) E fit be sey John no barb im hair from when dem born am because na Nazirite e be. And because of how e dress and how e be, e fit no hard person to know sey e dey live simple life. E use all im life do God work.
Locusts
For Bible, any grasshopper wey get short antenna na “locust.” Especially the ones wey dey fly together as one group. For one research wey dem do for Jerusalem, dem talk sey na 75 percent protein desert locust get. Today, for the area wey dem write Bible, before people chop locust, dem go first comot the head, leg, wing and belle. Na the thorax (chest) dem dey chop. Dem fit cook am or chop am like that. Dem talk sey locust dey taste like crayfish or crab and e get plenty protein.
Bush Honey
This picture dey show house wey bush bee make by theirself (1) and honey comb wey honey full (2). Apis mellifera syriaca na one type of bush bee wey dey the area wey John live, and e fit be sey na dem produce the honey wey John chop. This bee dey fit live for Judea wilderness wey hot and dry, but people no dey fit keep am to make honey because e dey attack people well well. But e don tey wey people wey dey live for Israel dey keep honey bee. Since the beginning of 900 B.C.E, dem dey use long round clay pot take keep am. Dem dig many of this pot come out for one area wey dey Jordan Valley. Now, dem dey call the place Tel Rehov. E fit be sey na from Turkey, dem bring the type of bee wey produce the honey wey dey this pot.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 1:3) Judah come be papa to Peʹrez and Zeʹrah and na Taʹmar born dem; Peʹrez come be Hezʹron papa; Hezʹron come be Ram papa;
nwtsty study note for Mt 1:3
Tamar: For book of Matthew, five women name dey the list of the family wey Messiah come from. The first of this five women na Tamar. Others na Rahab and Ruth, wey no come from Israel (vs. 5); Bath-sheba wey be “Uriah wife,” (vs. 6); and Mary (vs. 16). Na only men suppose dey this list. But e fit be sey dem add their name because e get one better thing about the way dem come take be Jesus great great grandmama.
(Matthew 3:11) My own na to baptize una with water because una don repent, but the person wey dey come for my back get power pass me. I no reach to comot im sandal. That person go baptize una with holy spirit and with fire.
nwtsty study note for Mt 3:11
baptize una: Or “cover una.” The Greek word ba·ptiʹzo mean “to dip inside water or to enter inside water.” Other verse for Bible show sey water must cover person wey dey baptize. E get one time wey John baptize people for Jordan Valley wey near Salim because plenty water dey there. (Joh 3:23) When Philip baptize the Ethiopian eunuch, two of dem enter inside the water. (Ac 8: 38) Inside Septuagint for 2Ki 5:14, na this same Greek word dem use when dem dey explain how Naaman take dip imself inside Jordan river seven times.
Bible Reading (No Pass 4 min) Mt 1:1-17
1 The book wey talk about the family wey Jesus Christ come from; Jesus Christ na David pikin, Abraham pikin: 2 Abraham come be Isaac papa; Isaac come be Jacob papa; Jacob come be papa to Judah and im brothers; 3 Judah come be papa to Peʼrez and Zeʼrah and na Taʼmar born dem;
Peʼrez come be Hezʼron papa;
Hezʼron come be Ram papa; 4 Ram come be Am·minʼa·dab papa;
Am·minʼa·dab come be Nahʼshon papa;
Nahʼshon come be Salʼmon papa;
5 Salʼmon come be Boʼaz papa and na Raʼhab born am;
Boʼaz come be Oʼbed papa and na Ruth born am;
Oʼbed come be Jesʼse papa; 6 Jesʼse come be King David papa.
David come be Solʼo·mon papa and na U·riʼah wife born am; 7 Solʼo·mon come be Re·ho·boʼam papa;
Re·ho·boʼam come be A·biʼjah papa;
A·biʼjah come be Aʼsa papa;
8 Aʼsa come be Je·hoshʼa·phat papa;
Je·hoshʼa·phat come be Je·hoʼram papa;
Je·hoʼram come be Uz·ziʼah papa;
9 Uz·ziʼah come be Joʼtham papa;
Joʼtham come be Aʼhaz papa;
Aʼhaz come be Hez·e·kiʼah papa;
10 Hez·e·kiʼah come be Ma·nasʼseh papa;
Ma·nasʼseh come be Aʼmon papa;
Aʼmon come be Jo·siʼah papa;
11 Jo·siʼah come be papa to Jec·o·niʼah and im brothers when dem carry dem as slave go Babylon. 12 For Babylon, Jec·o·niʼah come be She·alʼti·el papa;
She·alʼti·el come be Ze·rubʼba·bel papa;
13 Ze·rubʼba·bel come be A·biʼud papa;
A·biʼud come be E·liʼa·kim papa;
E·liʼa·kim come be Aʼzor papa;
14 Aʼzor come be Zaʼdok papa;
Zaʼdok come be Aʼchim papa;
Aʼchim come be E·liʼud papa;
15 E·liʼud come be El·e·aʼzar papa;
El·e·aʼzar come be Matʼthan papa;
Matʼthan come be Jacob papa;
16 Jacob come be papa to Joseph, Mary husband, wey born Jesus, wey dem dey call Christ.
17 So all the family from Abraham go reach David, na 14 generation; from David go reach when Babylon carry Israel comot na 14 generation; from that time go reach Christ na 14 generation.
JANUARY 8-14
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 4-5
“Wetin We Learn From Jesus Sermon On the Mount?”
(Matthew 5:3) “People wey know sey dem need God for their life dey happy because the kingdom wey dey heaven na their own.
nwtsty study note for Mt 5:3
happy: This one no just be sey mind dey sweet person because e dey enjoy imself. But e dey show how person wey God bless or wey God dey favour, dey feel. Dem still dey use this word describe God and Jesus wey be king for heaven.—1Ti 1:11; 6:15.
People wey know sey dem need God for their life: The Greek word for “people wey know,” mean “poor people (beggars wey no get food, cloth, or house).” For here, e dey talk about people wey need something and wey really know sey dem need am. For Lu 16:20, 22, na the same word dem use for Lazarus wey be “beggar.” The Greek word wey some Bible translate to “poor in spirit” dey describe people wey really know sey dem poor well well for matter wey concern God and sey dem really need God for their life.
(Matthew 5:7) “People wey dey show mercy dey happy, because dem go show dem mercy.
nwtsty study note for Mt 5:7
dey show mercy: For Bible, to show mercy no be just to forgive person or to reduce im punishment. Many times, e dey talk about the soft mind wey dey make person pity other people wey no get, and even help dem.
(Matthew 5:9) “People wey be peacemaker dey happy, because dem go call dem children of God.
nwtsty study note for Mt 5:9
peacemaker: This na people wey no dey find trouble and wey dey bring peace come where peace no dey.
w07 12/1 17
Teach Your Pikin to Dey Make Peace
Papa and mama wey dey serve Jehovah, really want make their children dey “find peace and run follow am.” (1 Peter 3:11) If person na peacemaker, e go really happy because e no go dey suspect people, dey vex anyhow or hate anybody.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 4:9) And e tell am sey: “I go give you all this things if you bow down and just worship me.”
nwtsty study note for Mt 4:9
just worship me: The Greek word for “to worship” wey dem use for here, show sey na something wey person go just do once. As dem translate am “just worship me,” e show sey Devil no talk sey make Jesus continue to dey worship am. E want make Jesus worship am only once.
(Matthew 4:23) Then e come dey waka for the whole Galilee, dey teach for their synagogue and dey preach the good news about the Kingdom and dey cure all kind of disease and all kind of sickness wey the people get.
nwtsty study note for Mt 4:23
dey teach . . . dey preach: To teach and preach no be the same thing. To teach pass to preach; you go need to train, explain, and use word and example wey go make the person believe wetin you dey teach am.
Bible Reading (No Pass 4 min) Mt 5:31-48
31 ‘And dem still talk sey: “Anybody wey divorce im wife, make e give am divorce certificate.” 32 But, I dey tell una sey anybody wey divorce im wife when im wife no put hand for sex wey no clean for God eye, dey push am to go commit adultery, and anybody wey marry woman wey dem divorce dey commit adultery. 33 “Una don still hear sey dem tell people for olden days sey, ‘Make you no swear when you know sey you no go do am, but make you do the things wey you don promise Jehovah sey you go do.’ 34 But, I dey tell una sey: Make una no swear at all. Make una no use heaven swear because na God throne; 35 or with this earth because na there e dey put im leg; or with Jerusalem because na the city of the great King. 36 No use your head swear because you no fit turn one hair to white or black. 37 Just let your ‘Yes’ be yes, and your ‘No,’ no, because anything wey pass this one na from the wicked person. 38 Una hear when dem talk sey: “Eye for eye, and teeth for teeth.” 39 But, I dey tell una sey: No do wicked person back, if anybody slap you for one side of your face, turn the other side give am. 40 And if person want carry you go court to collect your inner garment, make you still give am your outer garment; 41 And if person wey get authority force you carry load for one mile, carry am for two miles. 42 If person beg you something, give am. And no turn face comot from person wey want borrow something from you. 43 ‘Una hear sey dem talk sey: “You must love your neighbor and hate your enemy.”’ 44 But, I dey tell una sey: Make una continue to love una enemy and pray for people wey dey suffer una, 45 so that una go fit show sey una be children of una Father wey dey heaven, because e dey make im sun shine ontop wicked people and good people, and e dey make im rain fall for righteous people and bad people. 46 So, wetin una go gain if una love only the people wey love una? No be the same thing tax collectors dey do? 47 And if na only una brothers una dey greet, which big thing una dey do? No be the same thing people for the world dey do? 48 So, una must dey perfect as una Father for heaven dey perfect.
JANUARY 15-21
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 6-7
“Continue To Dey Find God Kingdom First”
(Matthew 6:10) Make your Kingdom come. Make wetin you want happen for this earth, as e dey happen for heaven.
Prayer Na Gift From Jehovah
12 Wetin be the first thing wey we suppose pray for? Na to dey pray make the things wey Jehovah want for this earth happen. Make we dey use all our mind thank am for all the things wey e don do for us. (1 Chronicles 29:10-13) When Jesus dey teach im disciples how to pray, e tell dem sey make dem first pray make God name dey holy. E come talk sey make dem pray make God Kingdom come, and sey make wetin Jehovah want for this earth happen the way e want am. Na after e don teach dem to pray for all this better better things, e come talk sey make dem pray for wetin dem need. (Read Matthew 6:9-13.) Make we dey first pray sey make wetin Jehovah want happen, before we pray for wetin we need. This one go show wetin dey important pass to us.
(Matthew 6:24) “Nobody fit be slave to two oga. E go either hate one and love the other one, or e go hold one tight and leave the other one. Una no fit be slave to God and to Riches.
nwtsty study note for Mt 6:24
slave: The Greek word dey talk about slave wey get only one oga. Jesus dey talk for here sey Christians no fit use all their life serve God and the same time, dey pursue money and gather property.
(Matthew 6:33) “So, make una continue to dey find the Kingdom and im righteousness first, and e go add all this other things join for una.
nwtsty study note for Mt 6:33
continue to dey find: The Greek word for “continue to dey find,” show sey na something wey no go stop. Jesus real disciples no go just find the Kingdom for small time, then later start to find other things. But dem go always make am the number one thing for their life.
the Kingdom: Some olden days Greek book use “God Kingdom.”
im: This word dey talk about God, our “Father wey dey heaven” as e dey Mt 6:32.
righteousness: People wey dey find God righteous things na people wey ready to do wetin God want. Dem hate wetin e hate, and love wetin e love. But the Pharisees no dey teach people that one. Dem want make things dey happen the way e take good for their own eyes.—Mt 5:20.
Put God Kingdom as Number One Thing for Your Life
18 Read Matthew 6:33. God Kingdom na wetin Jesus disciple suppose dey put as the first thing for their life. If na so e be for us, then we go fit enjoy wetin Jesus talk. E sey: “[God] go add this other things join for una.” Wetin make e fit talk like that? For verse 32 e sey: “Una Father for heaven know sey una need all this things,” things wey we need to fit live life. Jehovah sabi wetin we need one by one even before we know sey we need am—whether na food, cloth or where we go stay. (Phil. 4: 19) E know which of our cloth go soon spoil and the kind food wey we need. E still know the kind house wey go good for us and our family. Jehovah go make sure sey we get wetin we really need.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 7:12) “Na im make, everything wey una want make people do to una, make unaself do am to dem. This one na really wetin the Law and the Prophets mean.
w14 5/15 14-15 ¶14-16
Follow Matthew 7:12 When You Dey Preach
14 Just think am sey, one day person wey you no know call you for phone. E come start to ask you the kind food wey you dey like. You come dey wonder who the person be and wetin e want. But just to respect the person, you fit talk with am small, before you end the call. But if to sey the person talk who e be, wetin e dey do and why e call, e fit no hard you to answer any question wey e ask. Why? Because na better thing for person to let us know who e be, before e start to ask us question. So, how we fit treat people wey we meet for preaching like this?
15 For many area, we need to tell the person wey we want preach to why we come. Na true sey our message dey important, but how e go be if we no tell am who we be or why we come, and we just start to ask am question like: “If you fit end any problem for this world, which one e go be?” We know sey this question na to help us know wetin dey the person mind so that we go fit use Bible help am. But the person fit dey wonder: ‘Who be this one self, why e dey ask me this question and wetin e dey even talk about?’ So, e good make we dey try to make people mind come down when we dey preach to dem. (Phil. 2:3, 4) How we fit do am?
16 One circuit overseer talk the style wey e dey use, wey dey work for am well well. E sey: “After I don greet the person and tell am who I be, I go give am the tract Would You Like to Know the Truth? I go come sey, ‘today, we dey give people for this area this tract. Six question wey many people dey ask, dey the tract. This one na your own.’ The truth be sey, once people don know why you come, e dey make many of dem relax small. And from there, you fit just start to preach. When I see sey the person don relax, I go ask am sey: “You don ever think about any of this question before?” If the person choose one, I go open the tract and show am wetin Bible talk about the question. But if e no choose, I go choose one question, and show am wetin Bible talk.” We get many way to start preaching. For some area, people fit want make we greet dem, ask about their family and talk other things before we start to preach. Wetin go help us na to change our preaching style to match how people for our territory dey do things.
(Matthew 7:28, 29) When Jesus talk this things finish, wetin happen be sey the people wey gather come surprise well well because of the way e take dey teach, 29 because e dey teach dem like person wey get authority, no be like their scribes.
nwtsty study note for Mt 7:28, 29
surprise well well: The Greek word wey dem use for here, show sey wetin Jesus talk really touch the people and dem no forget am.
the way e take dey teach: This word explain how Jesus take dey teach, the style wey e use, and everything wey Jesus teach for the Sermon on the Mount.
no be like their scribes: Jesus no teach people like the scribes wey dey like to quote wetin other law teachers talk. But e teach dem God Word as person wey God send.—Joh 7:16.
Bible Reading (No Pass 4 min) Mt 6:1-18
1 Make una sofri, so that una no go dey do good things for people front because una want make dem see una; If una do like that, una Father for heaven no go pay una back. 2 So, when you want give gifts of mercy, make you no begin blow horn as you dey go. Na wetin pretenders dey do for synagogue and for street, so that people go praise dem. True true, I dey tell una sey, dem don pay dem finish. 3 But you, when you dey give gifts of mercy, no let your left hand know wetin your right hand dey do, 4 so that your gifts of mercy go dey secret. Then your Father wey dey see wetin dey happen for secret, go pay you back. 5 Another thing be sey, when una dey pray, make una no dey do like pretenders, because dem like to dey stand and pray for synagogue and corners of main street, so that people go see dem. True true, I dey tell una sey dem don pay dem finish. 6 But when you dey pray, enter your room and, after you don close your door, pray to your Father wey you no fit see. Then your Father wey dey see wetin dey happen for secret, go pay you back. 7 When you dey pray, no dey talk the same thing again and again, the way people for this world dey do, because dem think sey dem go get answer for their prayer because of their plenty talk. 8 So no do like dem, because una Father know wetin una need even before una beg am. 9 “Una must pray like this: “Our Father wey dey heaven, make your name dey holy. 10 Make your Kingdom come. Make wetin you want happen for this earth, as e dey happen for heaven. 11 Give us the bread wey we need for today. 12 and forgive us wetin we dey owe you, as we don forgive people wey dey owe us. 13 And no put us for temptation, but make you save us from the wicked person.’ 14 “Because if una forgive people the bad things wey dem do una, una Father wey dey heaven go forgive una; 15 but if una no gree forgive people the bad things wey dem do una, una Father no go still forgive una the bad things wey una don do. 16 Anytime wey una dey fast, make una stop to dey squeeze face like pretenders, because dem dey spoil their face so that people go know sey dem dey fast. True true, I dey tell una sey, dem don pay dem finish. 17 But you, when you dey fast, rub oil for your head and wash your face, 18 so that people no go know sey you dey fast, but only your Father wey you no fit see, go know. Then your Father wey dey see wetin dey happen for secret, go pay you back.
JANUARY 22-28
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 8-9
“Jesus Show Sey E Love People”
(Matthew 8:1-3) When e don come down from the mountain, many people come follow am. 2 And see! one man wey be leper come meet am, e bow down to am, come tell am sey: “Lord, if you just want, you fit make me clean.” 3 So e come stretch im hand, touch am, and tell am sey: “I want do am! Make you dey clean.” At once, im leprosy comot.
nwtsty study note for Mt 8:3
e touch am: For the law wey Jehovah give Moses, person wey get leprosy suppose stay outside Israel camp, so that other people no go carry the disease. (Le 13:45, 46; Nu 5:1-4) But, the people wey dey lead Jew religion that time, come add their own law join. For example, dem sey make people dey give leper space wey reach 1.8 m (6 ft), but if breeze dey blow well well, make e reach like 45 m (150 ft). This law come make people dey treat leper anyhow. Jew people dey even praise one teacher wey hide when e see leper, and another one wey dey stone dem so that dem no go near am. But Jesus no do like that at all. E pity the leper sotey e even touch am. That one na something wey other Jews no fit do. Jesus touch the leper even though sey only wetin e talk, go fit make the man well.—Mt 8:5-12.
I want do am: Jesus no only agree to help the leper, but e really show sey e dey im mind to heal am. This one show sey na love make Jesus heal am, no be just to do miracle.
(Matthew 9:9-13) As Jesus comot from there dey go, e come see one man wey im name na Matthew wey sitdown for the tax office, and e tell am sey: “Be my follower.” Na im e stand up, come follow am. 10 Later as e dey chop for the house, see! many tax collectors and sinners come there, come join Jesus and im disciples dey chop. 11 But when the Pharisees see wetin dey happen, dem come tell im disciples sey: “Why una teacher dey chop with tax collectors and sinners?” 12 When e hear wetin dem talk, e sey: “People wey well no need doctor, na people wey dey sick need am. 13 Make una go learn wetin this one mean: ‘I want mercy, no be sacrifice.’ Because na sinners I come call, no be righteous people.”
nwtsty study note for Mt 9:10
dey chop: Or “to sitdown round table.” To sitdown round table with person show sey you near that person well well. Na im make, for Jesus time, Jews no dey sitdown round table with, or chop with people wey no be Jew.
tax collectors: That time, many Jews dey collect tax for Rome government. People hate dem because dem dey work for government wey the people no like, and dem dey make the people pay pass the normal tax. Other Jews no dey gree do things with tax collectors. For their eye, tax collectors, dey the same level with sinners and prostitutes.—Mt 11:19; 21:32.
(Matthew 9:35-38) And Jesus come dey waka round all the city and village, dey teach for their synagogue and dey preach the good news about the Kingdom and dey cure all kind of disease and all kind of sickness. 36 As e see the plenty people, e come pity for dem, because their skin don pill and dem scatter like sheep wey no get shepherd. 37 Then, e come tell im disciples sey: “True true, things to harvest plenty, but the workers small. 38 So, beg the Master of the harvest to send workers come im harvest.”
nwtsty study note for Mt 9:36
pity for dem: The Greek word splag·khniʹzo·mai wey dem use here, na almost the same thing with the Greek word for “intestine” (splagʹkhna). E dey show how person dey really feel for inside im belle. Na one of the Greek word wey dey show sey person really get soft mind.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 8:8-10) The army officer come tell am sey: “Oga, I no reach who you suppose enter im house, but just talk am and my servant go well. 9 Because me too dey under person, and I get soldiers wey dey under me, and I go tell this one sey, ‘Go!’ and e go go, and the other one, ‘Come!’ and e go come. I go tell my slave, ‘Do this thing!’ and e go do am.” 10 When Jesus hear am, e surprise, e come tell the people wey dey follow am sey: “True true, I dey tell una sey, I never see anybody for Israel wey im faith strong like this.
w02 8/15 13 ¶16
“I Show Una Example”
16 Na still the same thing happen when one army officer—wey no be Jew, e fit be Rome person—meet Jesus and beg am to heal im slave wey dey sick, Jesus know sey the soldier hand no clean, but e no put that one for mind. That time, person wey be army officer go don do many bad things like to kill, and worship juju. Jesus only put mind for the good thing wey the man do; the faith wey e show. (Matthew 8:5-13) Later, when Jesus talk to the man wey dem nail for pole near am, e no condemn the man for the bad life wey e live. But e give am hope sey im tomorrow go better. (Luke 23:43) Jesus know sey to condemn people, no go help dem. This one really help many people live better life because na their good side Jesus see.
(Matthew 9:16, 17) Nobody dey use new cloth patch old outer garment, because the new cloth go tear comot from the garment and the hole go come big pass before. 17 And people no dey put new wine inside old wineskin. If dem do am, the wineskin go burst, the wine go waste and the wineskin go spoil. But na inside new wineskin people dey put new wine, and the two go just dey.”
Why Jesus Disciples No Dey Do Fasting?
Jesus want make John the Baptist disciples know sey im disciples no need to follow the old things wey people for Jew religion dey do, things like fasting. E no come patch and keep this old way wey dem take dey worship God. Infact, this religion go soon comot. The worship wey Jesus dey talk about no be the one wey match with Jew religion wey men command full. E no dey try sew new cloth ontop old cloth or to put new wine inside old wineskin bottle.
Bible Reading (No Pass 4 min) Mt 8:1-17
1 When e don come down from the mountain, many people come follow am. 2 And see! one man wey be leper come meet am and bow down to am, come tell am sey: “Lord, if you just want, you fit make me clean.” 3 So e come stretch im hand, touch am, and tell am sey: “I want do am! Make you dey clean.” At once, im leprosy comot. 4 Na im Jesus come tell am sey: “Make sure sey you no tell anybody, but go, make the priest see you, and make you give the gift wey Moses command, so that dem go know wetin happen.” 5 When e enter Ca·perʼna·um, one army officer come meet am, dey beg am 6 sey: “Oga, my servant lie down for house, e paralyze, e no fit move im body, and e dey suffer well well.” 7 E tell am sey: “When I reach there, I go cure am.” 8 The army officer come tell am sey: “Oga, I no reach who you suppose enter im house, but just talk am and my servant go well. 9 Because me too dey under person, and I get soldiers wey dey under me, and I go tell this one sey, ‘Go!’ and e go go, and the other one, ‘Come!’ and e go come. I go tell my slave, ‘Do this thing!’ and e go do am.” 10 When Jesus hear am, e surprise, e come tell the people wey dey follow am sey: “True true, I dey tell una sey, I never see anybody for Israel wey im faith strong like this. 11 But I dey tell una sey many people go come from east and west and dem go come sitdown chop for table with Abraham, Isaac and Jacob, for the Kingdom wey dey heaven; 12 But dem go trowey the sons of the Kingdom for outside, inside darkness. Na there dem go dey, dey cry and dey grind their teeth.” 13 So Jesus come tell the army officer sey: “Go. Make e happen to you, as you take show your faith.” And na exactly that time the servant well. 14 When Jesus enter Peter house, e see sey im wife mama lie down, e get fever. 15 So Jesus come touch am for hand, the fever come leave am, and e stand up come start to serve am. 16 But when evening don reach, people come dey bring many people wey demon dey control come give am; and e go just use one word drive the demons comot, and e cure all the people wey dey suffer, 17 so that wetin prophet Isaiah talk go be true, when e sey: “E collect all our sickness and e carry all our disease.”
JANUARY 29–FEBRUARY 4
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 10-11
“Jesus Give People Rest of Mind”
(Matthew 10:29, 30) Dem dey sell two sparrow for one coin wey get small value, no be so? Still, one of dem no go fall for ground make your Father no know. 30 Even self, e know how many hair wey dey una head.
nwtsty study note for Mt 10:29, 30
sparrow: The Greek word strou·thiʹon mean any small bird. But many times dem dey use the word for one bird wey be sparrow. Na this bird cheap pass for all the bird wey dem dey chop.
for one coin wey get small value: Or “for one assarion.” If person work for only 45 minutes, dem go pay am one assarion. (Go check App. B14.) For here, when Jesus dey preach round Galilee for the third time, e sey dem dey sell two sparrow for one assarion. But another time, maybe like one year after, when e dey preach for Judea, Jesus talk sey dem fit sell five sparrow for two assarion. (Lu 12:6) From the two verse, we learn sey people wey dey sell sparrow no value am sotey dem ready to use one do jara for customer wey buy four.
e know how many hair wey dey una head: Dem talk sey the hair wey dey person head pass 100,000. As Jehovah know us reach how many hair wey dey our head, e really show sey e know everybody wey be Jesus disciple one by one.
nwtsty media
Sparrow
For all the bird wey dem dey chop, na sparrow cheap pass. Dem fit use the money wey dem pay person wey work for only 45 minutes buy two. The Greek word mean different type of small bird, like the sparrow wey dem dey keep for house (Passer domesticus biblicus) or the Spanish sparrow (Passer hispaniolensis). This sparrow still plenty well well for Israel.
(Matthew 11:28) Come meet me, all of una wey dey struggle and wey carry load wey dey press una down, and I go make una rest.
nwtsty study note for Mt 11:28
load wey dey press una down: The people wey Jesus dey talk to, na people wey problem and wahala for life don press down. Because of the many command wey their leaders add join Law of Moses, to worship Jehovah come be like heavy load for dem. (Mt 23:4) Even the Sabbath day wey dem suppose use rest, come tire dem.—Ex 23:12; Mr 2:23-28; Lu 6:1-11.
I go make una rest: The Greek word for “rest,” fit mean to sitdown or lie down when person tire, (Mt 26:45; Mr 6: 31) or for person wey dey work to rest so that e go get power again (2Co 7:13; Phm 7). Na true sey Jesus “yoke” (Mt 11:29) na work no be rest. But, the Greek word wey Jesus use here, show sey e want give people wey don tire, power and rest of mind so that dem go like to carry im yoke wey no heavy.
(Matthew 11:29, 30) Make una carry my yoke for una shoulder and learn from me, because I no dey quick vex and I dey carry body down, and una go get rest of mind. 30 Because my yoke easy to carry, and my load no heavy.”
nwtsty study note for Mt 11:29
carry my yoke for una shoulder: The “yoke” wey Jesus mean na to obey wetin person wey high pass us talk and do wetin e want. If to sey wetin dey im mind na make im disciples carry two yoke, the type wey God give am, e for tell dem sey make dem enter under im yoke with am and e go help dem. That means, the verse for be : “Enter under my yoke with me.” But if na yoke wey Jesus dey give dem by imself, then e mean sey dem go obey and follow wetin Jesus dey tell dem as their leader.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 11: 2, 3) But when John wey dey prison, hear the things wey Christ dey do, e come send im disciples 3 go ask am sey: “Na you be the Person Wey Dey Come, or we dey expect another person?”
John Want Make Jesus Tell Am By Imself
The question surprise you? John na person wey dey fear God. E don nearly reach two years since when John baptize Jesus, when e dey baptize am, e see God spirit when e come ontop Jesus and e hear when God sey e don choose Jesus. So, we no fit talk sey John faith don weak. Even self, Jesus for no talk better things about John as e dey do now. But if John faith never weak, why e come dey ask this kind question about Jesus?
E fit be sey John want make Jesus tell am by imself sey na im be the Messiah. This one go make John strong even though sey e dey prison. And e fit get another reason why e ask. E know wetin Bible talk about the Messiah, sey the Messiah go be king and savior. But, many months after Jesus don baptize, John still dey prison. So, John want know whether another person dey come after Jesus, wey go complete the work wey the Messiah suppose do.
(Matthew 11:16-19) “Who I go compare this generation with? E be like small children wey sitdown inside market dey call other children wey dem dey play with, 17 sey: ‘We play flute for una, but una no dance; we cry well well, but una no beat una chest sey e pain una.’ 18 Na so e be when John come, e no dey chop and drink, but people sey, ‘E get demon.’ 19 Son of man come, e chop and drink, but people talk sey: ‘See! Na person wey dey chop too much, and wey dey drink well well, and na friend of tax collectors and sinners.’ Even with that one, better sense dey use the kind work wey e dey do show sey e dey righteous.”
E No Go Better for the Stubborn Generation
Jesus respect John well well, but how other people dey look John? Jesus talk sey, “This generation be like small children wey sitdown inside market dey call other children wey dem dey play with, sey: ‘We play flute for una, but una no dance; we cry well well, but una no beat una chest sey e pain una.’”—Matthew 11:16, 17.
Wetin Jesus mean? E make am clear when e sey: “When John come, e no dey eat and drink, but people sey, ‘E get demon.’ The Son of man come, e chop and drink, but people talk sey: ‘See! Na person wey dey chop too much, and wey dey drink well well, and na friend of tax collectors and sinners.’” (Matt. 11:18, 19) John live simple life as Nazirite. E no even drink wine, but this people sey e get demon. (Numbers 6:2, 3; Luke 1:15) Jesus live im life like other men. E eat and drink as e suppose, but dem sey e do am too much. Nothing wey dem do wey the people no complain about.
Bible Reading (No Pass 4 min) Mt 11:1-19
1 When Jesus don tell im 12 disciples wetin dem go do, e comot from there to go preach and teach for their different different city. 2 But when John wey dey prison, hear the things wey Christ dey do, e come send im disciples 3 go ask am sey: “Na you be the Person Wey Dey Come, or we dey expect another person?” 4 Jesus answer dem sey: “Go tell John wetin una dey hear and wetin una dey see: 5 Blind people don dey see and cripple don dey waka, leprosy dey comot from leper body, and deaf people don dey hear, people wey die don dey come back to life and poor people dey hear the good news. 6 Anybody wey no let anything about me make am fall, dey happy.” 7 As dem come dey go, Jesus come dey talk about John to the people wey gather sey: “Wetin una go wilderness go see? Na grass wey breeze dey blow? 8 So, wetin una go see? Man wey wear soft garment? See, people wey dey wear soft garment dey the house of kings. 9 So, why una go? Na to see prophet? Yes, I dey tell una sey, e even pass prophet well well. 10 This na the person wey dem write about sey: ‘See! I dey send my messenger to dey your front, e go prepare the road before you come!’ 11 True true I dey tell una this thing sey, among the people wey woman born, nobody high pass John the Baptist, but the person wey small pass for the Kingdom of heaven high pass am. 12 From John the Baptist time come reach now, the target wey people get na to pursue the Kingdom wey dey heaven and get am, and people wey dey try well well, dey get am. 13 Because all the Prophets and the Law, go reach John time don talk about am; 14 and if una ready to believe am, na im be the ‘Elijah wey go come.’ 15 Make the person wey get ear, hear. 16 “Who I go compare this generation with? E be like small children wey sitdown inside market dey call other children wey dem dey play with, 17 sey: ‘We play flute for una, but una no dance; we cry well well, but una no beat una chest sey e pain una.’ 18 Na so e be when John come, e no dey chop and drink, but people sey, ‘E get demon.’ 19 The Son of man come, e chop and drink, but people talk sey: ‘See! Na person wey dey chop too much, and wey dey drink well well, and na friend of tax collectors and sinners.’ Even with that one, better sense dey use the kind work wey e dey do show sey e dey righteous.”