Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 14
  • Praise the King Wey Go Rule This Earth

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Praise the King Wey Go Rule This Earth
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Make We Sing to Our God!
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Praise Jah for Im Son Wey Be Our King
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Praise Jehovah Firstborn!
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Join Me Praise Jehovah
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
See More
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 14

SONG 14

Praise the King Wey Go Rule This Earth

(Psalm 2:12)

  1. 1. For ev’ry corner for this earth we see people dey gather.

    Jehovah God dey use im Son

    dey bring dem from all corner.

    Our God Jehovah, we pray sey:

    “Abeg help us follow your way.

    We pray make your Kingdom no delay,

    Na this hope dey give us power.”

    (CHORUS)

    Make we praise Jehovah, Praise im Son forever,

    Na im be King wey go rule this earth.

    Nobody fit be like Jesus our King,

    So we go give am our best.

  2. 2. Jehovah don give Jesus Christ

    our better King the power.

    Na im go change this earth for front,

    Na im go comot suffer.

    The things wey fit dey make us fear

    go soon comot, that time don near.

    Yes, life go dey sweet for ev’rywhere.

    We go enjoy am forever!

    (CHORUS)

    Make we praise Jehovah, Praise im Son forever,

    Na im be King wey go rule this earth.

    Nobody fit be like Jesus our King,

    So we go give am our best.

(Still check Ps. 2:6; 45:1; Isa. 9:6; John 6:40.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share