SONG 16
Praise Jah for Im Son Wey Be Our King
(Revelation 21:2)
1. This earth go better pass this one
When Jesus our King dey rule.
Because na person wey go judge well,
Im Kingdom go make life better!
(CHORUS)
Praise Jesus our King, praise Jehovah,
Our God wey don give us im Son.
All wetin e talk na im we go do,
We promise to stay im side.
Praise Jesus our King, praise Jehovah,
For heaven, Jesus don dey rule.
E get the power, e use am dey praise
Jehovah God holy name.
2. As Jesus dey rule the Kingdom,
Im brothers go dey im side.
Jehovah don choose dem from this earth.
This Kingdom go bring Paradise.
(CHORUS)
Praise Jesus our King, praise Jehovah,
Our God wey don give us im Son.
All wetin e talk na im we go do,
We promise to stay im side.
Praise Jesus our King, praise Jehovah,
For heaven, Jesus don dey rule.
E get the power, e use am dey praise
Jehovah God holy name.
(Still check Prov. 29:4; Isa. 66:7, 8; John 10:4; Rev. 5:9, 10.)