SONG 63
We Be Jehovah Witness
(Isaiah 43:10-12)
1. People for this world dey serve
Different god wey no get life.
This kind god fit get eye,
But dem no fit see.
Jehovah no be like that,
E dey see the future well.
People wey dey serve am no go shame.
E no get god wey be like am.
(CHORUS)
Na Jehovah we dey serve,
E send us to go dey preach.
And na Jehovah Witness we be,
We trust Jehovah our God.
2. We dey tell people good news
Sey God Kingdom go soon come.
We want help dem know God
Wey go fit save dem.
Jehovah give us this work,
So we no dey fear to preach.
We trust Jehovah, e no go fail,
And na Jehovah side we dey.
(CHORUS)
Na Jehovah we dey serve,
E send us to go dey preach.
And na Jehovah Witness we be,
We trust Jehovah our God.
3. Na bad people full this world,
Dem dey do wetin dem like.
If dem learn about God,
E go give dem hope.
Make we try go preach to dem
Sey Armageddon dey come.
Bible go fit help dem change their life
And dem go join us praise our God.
(CHORUS)
Na Jehovah we dey serve,
E send us to go dey preach.
And na Jehovah Witness we be,
We trust Jehovah our God.
(Still check Isa. 37:19; 55:11; Ezek. 3:19.)