SONG 141
Na God Dey Give Life
(Psalm 36:9)
1. All wetin we get, all wetin get life,
Everything we dey enjoy, as we dey live.
Na God dey arrange all this better things.
Jehovah use im power give us everything.
(CHORUS)
Na wetin we go do to tell God thank you?
Na to show am sey we love am for wetin e do.
We no go fit forget, because na Jehovah
dey give this better gift. Na im dey give us life.
2. Some people fit stop, dem fit forget God.
Some people don forget God when things dey hard.
We no be like dem, we get faith wey strong.
And we dey thank Jehovah as we sing this song.
(CHORUS)
Na wetin we go do to tell God thank you?
Na to show we love our neighbours with wetin we do.
We no go fit forget, because na Jehovah
dey give this better gift. Na im dey give us life.
(Still check Job 2:9; Ps. 34:12; Eccl. 8:15; Matt. 22:37-40; Rom. 6:23.)