Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 139
  • See Yourself for Paradise

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • See Yourself for Paradise
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Join Sing the Kingdom Song
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Make We Sing to Our God!
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Life Wey Pioneer Dey Live
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Your Name Na Jehovah
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
See More
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 139

SONG 139

See Yourself for Paradise

(Revelation 21:1-5)

  1. 1. If you fit see, where I dey see.

    Jehovah don show us how e go be.

    For Paradise wey dey for front,

    All this wahala go don comot.

    We go see sey, cry no go dey.

    We go enjoy if we just obey.

    Na small time remain, Paradise go soon come,

    Na im dey make us dey pray make God Kingdom come.

    (CHORUS)

    Jehovah na you, go do am for us.

    When your Kingdom don dey rule reach this earth.

    And we go dey enjoy better life everyday

    Because wahala no go dey this world again.

  2. 2. Just use your mind, see me and you,

    Dey laugh and smile with better work to do.

    No bad people, go make us fear

    Because good people full everywhere.

    We no go fear, sey we go die.

    Nothing like death go dey make us cry.

    The people wey dey inside grave go come back,

    And dem go join us praise God when e bring dem back.

    (CHORUS)

    Jehovah na you, go do am for us.

    When your Kingdom don dey rule reach this earth.

    And we go dey enjoy better life everyday

    Because wahala no go dey this world again.

(Still check Ps. 37:10, 11; Isa. 65:17; John 5:28; 2 Pet. 3:13.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share