Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 44
  • Prayer of Person Wey Dey Face Problem

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Prayer of Person Wey Dey Face Problem
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Abeg Jehovah, Hear My Prayer
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • “My Pikin, Get Better Sense”
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Put All Your Problem for Jehovah Hand
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • You Show Me Love
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
See More
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 44

SONG 44

Prayer of Person Wey Dey Face Problem

(Psalm 4:1)

  1. 1. Jehovah I dey pray to you, abeg make you hear me.

    This problem wey dey worry me

    dey make life hard for me.

    I don dey think, I no fit sleep

    because I just dey fear.

    Na you Jehovah go help me

    because you no dey fail.

    (CHORUS)

    Help me my God, make I no fall.

    When I dey fear, help me get mind.

    When problem come, na you I trust.

    Na you my God, go make me strong.

  2. 2. Your Word dey give me power

    wey dey make me no dey fear.

    When I dey pray inside my mind,

    na only you fit hear.

    Sometimes I fit dey think am sey

    my problem no go end.

    But Bible dey help me know sey

    your power no dey fail.

    (CHORUS)

    Help me my God, make I no fall.

    When I dey fear, help me get mind.

    When problem come, na you I trust.

    Na you my God, go make me strong.

(Still check Ps. 42:6; 119:28; Rom. 8:26; 2 Cor. 4:16; 1 John 3:20.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share