SONG 92
Place Wey We Build for You
(1 Chronicles 29:16)
1. We thank you our Father, Jehovah
for this place we build for your name.
Our belle dey sweet sey we build am
for people to come know your name.
We love you our Father, Jehovah.
Na you be the God we go serve.
This place wey we build no go reach you.
We beg you sey make you take am.
(CHORUS)
Abeg our God, use am dey do
anything wey you want do.
With all our heart, we dey happy
sey we fit build house for you.
2. Na you we go praise for ev’rything,
because sey dem come from your hand.
If no be your spirit dey help us,
to build this better place for hard.
From now we go use am dey praise you,
and help people know who you be.
We go do ev’rything we fit do
to make sure sey this place dey clean.
(CHORUS)
Abeg our God, use am dey do
anything wey you want do.
With all our heart, we dey happy
sey we fit build house for you.
(Still check 1 Ki. 8:18, 27; 1 Chron. 29:11-14; Acts 20:24.)