Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • Wetin You Go Enjoy When You Come Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 5

      Wetin You Go Enjoy When You Come Our Meeting?

      Jehovah Witness people for one Kingdom Hall for Argentina

      Argentina

      Jehovah Witness meeting for Sierra Leone

      Sierra Leone

      Jehovah Witness meeting for Belgium

      Belgium

      A meeting of Jehovah’s Witnesses in Malaysia

      Malaysia

      Plenty people no dey go church again because dem no fit get better answer for many many question wey dey worry dem for mind. Why e good make you follow Jehovah Witness people go their Kingdom Hall? Wetin you go see when you come?

      Belle go sweet you well well sey you dey serve God with people wey love you. Christian for the apostle time dey gather to worship God for small small group wey dem dey call congregation. For this meeting, dem dey learn Bible and help theirself. (Hebrews 10:24, 25) When dem gather, belle dey sweet dem well well because dem sabi sey dem dey with people wey love dem and love God well well. (2 Thessalonians 1:3; 3 John 14) As we dey follow their example today, e dey make us happy.

      You go learn how you fit take do wetin Bible talk. For Moses time, na papa, mama and their pikin dey gather for one place worship God. Today too, overseer for our different different congregation dey help us sabi how we go dey do wetin we dey learn for Bible. (Deuteronomy 31:12; Nehemiah 8:8) Everybody dey free to sing and dem dey free to answer question to show wetin dem believe.​—Hebrews 10:23.

      Your faith go strong well well. Apostle Paul tell one congregation wey dey for im time sey: ‘I really want see una, make we fit help ourself so that our faith go strong well well.’ (Romans 1:11, 12) As we dey go meeting together with our brother and sister dem, our faith for God dey strong well well, and e dey help us to do wetin we dey learn.

      We want make you come follow us enjoy this meeting. We go happy well well if you fit come. Everything wey we dey do for there na free​—you no go pay anything.

      • Which example we dey follow for our meeting today?

      • Wetin we go enjoy if we dey go meeting everytime?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      If you want see how inside our Kingdom Hall be before you come our meeting, make you ask any Jehovah Witness person wey near you. E go show you the place.

  • Wetin We Dey Enjoy As We Dey Serve God Together With Our Brother and Sister Dem?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 6

      Wetin We Dey Enjoy As We Dey Serve God Together With Our Brother and Sister Dem?

      Jehovah Witness people dey greet theirself

      Madagascar

      One Jehovah Witness dey help im Christian brother

      Norway

      Elders dey visit one sister to encourage am

      Lebanon

      Jehovah Witness people dey greet theirself

      Italy

      The truth be sey, we no dey take our Christian meeting play. Even if na to trek for inside rain or for hot sun or pass inside thick bush, we go still go worship our God. Even as life no dey easy with everybody, na so e be for Jehovah Witness people, but why we still dey try go meeting?

      E dey help us manage our problem. Apostle Paul talk sey make we ‘dey think about other people.’ (Hebrews 10:24) So wetin Apostle Paul mean be sey e good make we sabi our brother and sister dem well well and the kind problem wey dey worry dem. When we sabi the kind problem wey dey worry our brother and sister dem and how dem take dey solve am, this one go teach us how we go take solve our own.

      E go help us make better friend. When we gather for our meeting, we dey see sey our brother and sister dem na our better friend. We still dey meet for another time to play and enjoy life together. How this one take dey make our life better? E dey make us respect and love ourself well well. And because we love dem well well even when dem get problem, e go dey easy for us to help dem. (Proverbs 17:17) As we dey serve God together for our different different congregation, this one go show sey we ‘get love for ourself well well.’—1 Corinthians 12:25, 26.

      Make you choose your friend from people wey dey do wetin God want. If you dey follow Jehovah Witness people, you go see this kind friend. Abeg make you no allow anything stop you to serve God with us.

      • Why e good make we dey worship God together for our meeting?

      • Which time you go like come our meeting?

  • How We Take Dey Do Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 7

      How We Take Dey Do Our Meeting?

      Jehovah Witness meeting for New Zealand

      New Zealand

      Jehovah Witness meeting for Japan

      Japan

      One young Jehovah Witness wey dey read Bible for Uganda

      Uganda

      Two Jehovah Witness wey dey do demonstration for Lithuania

      Lithuania

      The way Christian for Apostle time take dey do their meeting be sey dem go sing, pray, read Bible, and come talk wetin dem learn when dem read am finish. (1 Corinthians 14:26) Na the same thing we dey do for our meeting today.

      Everything wey we dey learn na from inside Bible and na something wey we fit do. For weekend, every congregation dey get 30-minute Public talk. This meeting dey teach us how wetin dey inside Bible take concern our life and the things wey dey happen for this world now. We dey open our Bible as dem dey read am. After this one, na “Watchtower” Study dey follow am for one hour. For this Watchtower study, anybody wey want answer question fit raise im hand up. This Watchtower Study dey help us do wetin Bible talk. Na the same watchtower all of us dey learn for our congregation wey pass 110,000 for the whole world.

      Our meeting dey help us sabi how to teach well well. For one evening inside the week, we dey get one meeting, the meeting get three part. The name of the meeting na ‘Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach.’ For this meeting, we dey use wetin dey the Life and Preaching Meeting Book take learn. Na every month we dey get this book. The first part for this meeting na Better Things Wey Dey Inside Bible. This part dey help us sabi some Bible chapter wey we don first read before we come the meeting. The next one na, Make You Dey Preach Well. This part dey get demonstration wey go help us sabi how to use Bible preach to people when we dey preach. One brother go use wetin e see for the demonstration take help us make we fit sabi read and teach well. (1 Timothy 4:13) The last part wey be Make We Dey Live Like Christian, dey help us see how we fit dey do wetin Bible talk everyday for our life. E dey get question and answer. Everybody go talk am together. This part dey help us sabi Bible well well.

      When you come our meeting, all the better things wey you go learn for Bible go really touch you and e go make your belle sweet.—Isaiah 54:13.

      • Wetin you go learn when you come our meeting?

      • Which of our meeting you go like come?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Before you come our meeting, e good make you try read wetin we go learn for that day. Make you see wetin you go learn from inside Bible wey go make your life better.

  • Why We Dey Wear Better Cloth Go Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 8

      Why We Dey Wear Better Cloth Go Our Meeting?

      Papa and im pikin dey dress to go meeting for Kingdom Hall

      Iceland

      Mama and im pikin dey ready to go meeting

      Mexico

      Jehovah Witness people wey dress well well for Guinea-Bissau

      Guinea-Bissau

      One family for Philippine dey waka go meeting

      Philippines

      All the photo wey you dey see for this book show sey Jehovah Witness people dey dress well go their meeting. Why we dey wear better cloth go our meeting?

      E dey show sey we respect God well well. The truth be sey, God no dey look face. Na wetin dey inside our mind e dey look. (1 Samuel 16:7) When we wear better cloth go our Kingdom Hall, we show sey we dey respect God and our brother and sister dem from our mind. For example, if you dey go court go stand for person, na which kind cloth you go wear? You no go wear better cloth to show sey you respect the big oga wey dey for the court? Na so e be when we dey go our meeting. We dey wear better cloth to show sey we respect Jehovah wey be ‘the oga wey big pass for the whole world’ and the place wey we dey stay worship am.—Genesis 18:25.

      E dey show sey we dey do wetin we dey learn for Bible. Bible talk sey make Christian wear ‘simple cloth like person wey dey fear God.’ (1 Timothy 2:9, 10) To ‘wear simple cloth’ mean sey you go choose better cloth wey no go show your body and wey no go tight you. And to dress ‘like person wey dey fear God’ mean sey you no go choose style wey dey short well well or wey bad. Wetin Bible talk here no mean sey na people go choose style for you o, but make your dress show sey ‘you dey praise God.’ (Titus 2:10; 1 Peter 2:12) As people dey see sey we dey wear better cloth go our meeting, e dey make dem respect us and even praise God.

      You no need to wear cloth wey cost well well before you go come our Kingdom Hall, make you just wear simple cloth wey clean.

      • Why e good make we wear better cloth go our meeting?

      • How wetin we dey learn for Bible fit help us dress well?

  • How We Go Take Ready Well Well Before We Go Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 9

      How We Go Take Ready Well Well Before We Go Our Meeting?

      One Jehovah Witness dey study to prepare for meeting

      Cambodia

      One Jehovah Witness dey study to prepare for meeting
      One Jehovah Witness dey answer question for meeting

      Ukraine

      As you don dey learn Bible with Jehovah Witness people, you see am sey you dey gain well well if you ready before dem come, na so e be if you read well before you go meeting. If you dey do am everytime, you go gain well well.

      Make you choose time and place wey go good for you to learn. Which time you go fit read wey you go understand wetin you read? Na for early morning before you go work or na for evening when your pikin don sleep? Even if you no fit study for long time, make you make sure sey that small time wey you get, you use am well. Make you study for place wey cool. If you pray before you start, your mind go come down and you go fit put mind for wetin you want learn.—Philippians 4:6, 7.

      Make you ready well so that you go fit answer for meeting. The first thing wey you go do na to sabi wetin all the lesson for the book talk. Check all the topic, all the photo and all the question. When you finish, make you read all the Bible verse wey dey the paragraph and see how dem support the lesson. (Acts 17:11) When you see the answer, make you use your pencil mark am. When you come meeting, you fit carry your hand up if you go like answer any question.

      If you dey ready before you go meeting everyweek, you go dey learn new new things wey go make you sabi Bible well well.—Matthew 13:51, 52.

      • How you fit take dey ready well everytime before you go meeting?

      • How you go take ready well well make you fit answer question for meeting?

      FIND OUT MORE

      Follow the same way wey you learn to ready for Watchtower Study and Congregation Bible Study. Learn how you go take ready the answer wey you go give for meeting.

  • Wetin Be Family Worship?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 10

      Wetin Be Family Worship?

      One family dey enjoy family worship

      South Korea

      One husband and wife dey study Bible together

      Brazil

      One Jehovah Witness dey study Bible

      Australia

      One family dey discuss one topic for Bible

      Guinea

      Jehovah want make family worship am together. This kind worship dey make their faith strong well well. Na since Israel time this kind worship start. (Deuteronomy 6:6, 7) Na im make Jehovah Witness people dey choose time everyweek for family worship, to learn Bible. Wetin dem dey learn dey help dem near God well well. Even if na only you dey stay for your house, you fit still use small time to learn wetin Bible talk.

      Family dey use this time dey near Jehovah. Bible talk sey ‘near Jehovah and e go near you.’ (James 4:8) Bible dey help us sabi the kind person wey God be and the things wey im dey do, when you learn all this things from Bible you go come sabi am well. One example wey you fit take do family worship na to take small time read Bible together, una fit even follow the Life and Preaching Meeting program everyweek. Una fit share wetin una want read give different different person for the house, and after una don finish, everybody go talk wetin e learn.

      Family worship dey bring everybody for family together. When family join learn Bible together, e dey make their love strong well well. Family worship na time wey everybody for the family go dey happy make e come quick quick. Papa and mama go choose wetin dem go learn for the family worship wey their pikin mind fit carry. Dem fit choose am for Watchtower or Awake! or our website wey be www.jw.org/pcm. Dem fit even talk about anything wey dey give their pikin wahala for school and wetin dem fit do. Una fit even watch one program for JWBroadcasting (tv.jw.org) and discuss wetin una learn. Dem fit even sing the song wey dem go sing for meeting and chop small thing after dem finish.

      This time for family worship na time wey family go use learn wetin dey inside Bible together everyweek. God dey bless that kind thing.—Psalm 1:1-3.

      • Why we dey do family worship?

      • Wetin papa and mama fit do make their family enjoy this worship?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Make you ask other people for the congregation how dem dey take do their family worship. Make you check book for Kingdom Hall wey una fit use for una family worship.

  • Why We Dey Go Our Assembly and Convention?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 11

      Why We Dey Go Our Assembly and Convention?

      One Jehovah Witness regional convention for Mexico

      Mexico

      Dem dey release one book for regional convention for Germany

      Germany

      One Jehovah Witness regional convention for Mexico Botswana

      Botswana

      One young man dey baptize for Nicaragua

      Nicaragua

      One drama wey dem act for stage for one regional convention for Italy

      Italy

      Wetin dey make this people happy well well like this? Dem dey for one assembly wey we dey do every year. Na three times we dey do this kind assembly every year just like people for Israel dey do am. E dey always hungry us make this time quick come so that we go fit gather together with our brothers. (Deuteronomy 16:16) Na three different program we dey get every year: The first na circuit assembly wey we dey do for one day. Na two times every year wey dey do this one. We still get regional convention wey we dey do for three days. Wetin we dey enjoy when we gather for this kind assembly?

      E dey make us love ourself well well. When people for Israel gather ‘for assembly,’ their belle dey sweet dem well well as dem dey praise Jehovah. (Psalm 26:12, footnote; 111:1) Na this kind thing dey happen for our assembly today. As we gather so, we dey enjoy with our brothers and sisters wey come from different different congregation and some wey come from different different country. We even dey chop together and play together. (Acts 2:42) This one dey make us love ourself well well. For this assembly, we dey enjoy correct love wey Bible talk.—1 Peter 2:17.

      E dey help us sabi God well well. When Israel people ‘understand wetin Bible talk, dem gain well well.’ (Nehemiah 8:8, 12) Today, when we gather, we dey enjoy everything wey we dey learn for our assembly. Na Bible we dey learn for all the program. Different different talk dey. Some na short short talk wey some brothers go give. Short short drama self dey. Na all this one dey help us learn how Bible fit make our life better. When we hear how our brothers and sisters still dey serve Jehovah even when dem dey inside problem, e dey make our faith strong well well. The drama wey we dey do for our regional convention dey help us see how wetin dey inside Bible fit make our life better. People wey ready to serve God well well dey baptize for all our assembly and convention.

      • Wetin dey make us happy for our assembly?

      • Wetin you go gain if you come our assembly?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      If you want sabi us well well make you come our assembly. Person wey dey help you learn Bible go show you the program. Make you mark the next assembly for your calendar. We go happy well well if you come.

  • How We Take Dey Arrange Our Preaching?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 12

      How We Take Dey Arrange Our Preaching?

      Jehovah Witness dey preach from house to house

      Spain

      One Jehovah Witness dey preach for where people dey relax

      Belarus

      One Jehovah Witness dey use telephone preach

      Hong Kong

      Jehovah Witness dey preach for street

      Peru

      Before Jesus die, e talk sey: ‘And people go dey preach this good news about God Kingdom for everywhere for this world make everybody fit hear, after that one, the end go come.’ (Matthew 24:14) How we go take preach this good news for everywhere for this world? Na to follow how Jesus take do am when e dey this world.—Luke 8:1.

      We dey try to meet people for their house. Jesus teach im disciple how to preach. Jesus tell dem sey make dem go preach for people for their house. (Matthew 10:11-13; Acts 5:42; 20:20) E even give dem area wey dem go preach. (Matthew 10:5, 6; 2 Corinthians 10:13) Na so we self dey arrange our preaching today. Every congregation get the area wey dem dey preach. This one dey help us make we fit ‘preach for everybody’ as Jesus talk.—Acts 10:42.

      We dey preach for people anywhere wey we see dem. Jesus show how to preach for everywhere. E even preach for people wey e meet near river and people wey dey fetch water for well. (Mark 4:1; John 4:5-15) Na as Jesus do, we self dey preach for everywhere wey we see people today, for road, for market, or even garage. We dey even use phone preach. We still dey preach for where we dey live, where we dey work, and our school. Even self our family wey no be Jehovah Witness dey enjoy our preaching. The truth be sey, this work don help many many people to hear this ‘good news wey dey save people life.’—Psalm 96:2.

      You fit remember some people wey you fit preach for and tell dem the better better things wey God go use im Kingdom do for dem? Make you preach for dem now. No waste time!

      • Wetin be the ‘good news’ wey God sey make we preach?

      • How Jehovah Witness people take dey follow Jesus example for preaching?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Make you tell the person wey dey help you learn Bible to teach you how you fit help other people learn wetin you don learn for Bible.

  • Who Be Pioneer?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 13

      Who Be Pioneer?

      One pioneer wey dey preach

      Canada

      Two pioneer wey dey preach

      House to house

      Pioneers dey conduct Bible study

      Bible study

      One pioneer dey study Bible

      Your own study

      Pioneer na people wey dey first go new new area before other people follow. Na Jesus be the first pioneer wey God send come this world to preach the good news and help people wey love God well well to get life. (Matthew 20:28) Today, people wey dey follow Jesus example dey use plenty time preach for different different people make dem come ‘be Jesus disciple.’ (Matthew 28:19, 20) Some don even choose to be pioneer.

      Pioneer na person wey dey use plenty plenty time preach. Na all JehovahWitness people dey preach today. Some don even arrange their time to use 70 hours preach every month. Na regular pioneer we dey call dem. This people dey do small work to help theirself. Another people na special pioneer wey dey use 130 hours preach for every month. Many of dem dey preach for village. This pioneer dey live simple life as dem believe sey God go give dem wetin dem need. (Matthew 6:31-33; 1 Timothy 6:6-8) People wey no fit use 130 or 70 hours preach fit use 50 or 30 hours. We dey call dem auxiliary pioneer.

      Pioneer dey preach because dem love God and people. Plenty people today want learn about God, as e be for Jesus time. (Mark 6:34) We dey use wetin we dey learn for Bible take help people sabi Jehovah. This one go make their life better and give dem hope for tomorrow. Pioneer dey use plenty plenty time preach because of the love wey dem get for their neighbor. (Matthew 22:39; 1 Thessalonians 2:8) This work dey make dem happy well well. E dey help dem near God and dey make their faith strong well well.—Acts 20:35.

      • Who be pioneer?

      • Wetin make some of our people dey pioneer?

  • Which School Dey for Pioneers?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 14

      Which School Dey for Pioneers?

      Pioneers wey dey preach

      United States

      People wey be student for Watchtower Bible School of Gilead
      People wey be student dey prepare for missionary work

      Gilead School, Patterson, New York

      One husband and wife wey be missionary dey preach for Panama

      Panama

      E don tey wey Jehovah Witness people don get different different school wey dey teach Bible. Some school dey wey dey help pioneer dem ‘sabi how to preach well well.’—2 Timothy 4:5.

      Pioneer School. Pioneer dey go this school after dem don preach for one year. Na six days dem take dey do this school for any Kingdom Hall wey near their house. This school dey help pioneer near God well well and e dey help dem sabi how to preach. And wetin dem dey learn from the school no dey make dem tire to serve God.

      School for Kingdom Evangelizers. This school dey help pioneer wey ready well well to go any place wey people wey dey preach never plenty. This school na for two months. People wey go this school be like Isaiah wey sey, ‘I dey here! Send me!’ This one show sey dem dey follow Jesus wey be the first person wey preach for this earth. (Isaiah 6:8; John 7:29) As dem dey comot for their town, na simple life dem dey live. Dem fit even carry dem go some place wey the weather cold or wey hot well well. Some place get different different food wey dem no dey chop. Dem even dey learn different different language wey go help dem fit preach. People wey don marry and people wey never marry fit go. But na only people wey dey 23 years go reach 65 years fit go this school. This school dey help dem sabi things for Bible wey go make dem ready to preach for everywhere wey Jehovah want use dem.

      Watchtower Bible School of Gilead. For Hebrew language, the name ‘Gilead’ mean ‘Plenty Witness.’ And since 1943 wey this school don start, e don pass 8,000 people wey don learn for this school. When dem finish the school, dem dey send dem ‘go different different country’ as Missionary. This people dey do this work well. (Acts 13:47) We no get any congregation for Peru when Missionary first reach that country. But today, Peru don get pass 1,000 congregations. Before Missionary enter Japan, Jehovah Witness people for that country no reach 10. Today, e don pass 200,000 people wey dey preach for that country. This school na for 5 month and na Bible dem dey learn for there. The people wey fit go this school na special pioneer, circuit overseer, missionary and people wey dey work for bethel. This school dey teach dem make dem fit preach well well and make other brothers and sisters faith strong well well.

      • Why people dey go Pioneer School?

      • Which people fit go School for Kingdom Evangelizers?

Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
Log Out
Log In
  • Nigerian Pidgin
  • Share
  • Set Am How You Like
  • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
  • How to Use Am
  • Privacy Policy
  • Privacy Settings
  • JW.ORG
  • Log In
Share