Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w18 February pp. 18-22
  • Wetin E Mean for God Spirit to Direct Person?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin E Mean for God Spirit to Direct Person?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • WETIN E MEAN FOR GOD SPIRIT TO DEY DIRECT PERSON?
  • BETTER EXAMPLE WEY WE FIT LEARN FROM
  • “DEY THINK LIKE JESUS”
  • Continue to Dey Allow God Spirit Direct You!
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
w18 February pp. 18-22
One sister settle down dey think about wetin Bible talk about Jesus

Wetin E Mean for God Spirit to Direct Person?

‘Make God give all of una the mind to dey think like Jesus.’​—ROM. 15:5.

SONG: 17, 13

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • How we go take know person wey God spirit dey direct?

  • Wetin we fit learn from the better example of people wey allow God spirit direct dem?

  • Why e good make we try to dey “think like Jesus”?

1, 2. (a) Wetin some brothers and sisters wey allow God spirit to direct dem talk? (b) Wetin be the three main question wey we go talk about for this topic?

ONE sister for Canada talk sey: “As I dey let God spirit direct me, I don dey happy pass before. And e don help me fit manage the problem wey I dey face everyday.” One brother for Brazil wey don marry for 23 years talk sey e dey enjoy im marriage well well. Wetin help im and im wife? E sey: “We dey try to put mind for things wey concern God.” Another brother for Philippines talk sey: “Because I dey allow God spirit direct me, I don get peace of mind. And the way I take dey do things with brothers wey come from different place, don better pass before.”

2 Wetin all this people talk show sey na better thing for God spirit to dey direct person. This one fit make us ask ourself sey, ‘Wetin I fit do make God spirit dey direct me more more, so that I go gain like this people wey we talk about?’ Before we answer that question, e good make we first know wetin Bible talk about people wey God spirit dey direct. For this topic, we go answer three main question. (1) Wetin e mean for God spirit to dey direct person? (2) Which people example go help us near Jehovah more more? (3) If we dey try to “think like Jesus,” how e go take help us become person wey God spirit dey direct?

WETIN E MEAN FOR GOD SPIRIT TO DEY DIRECT PERSON?

3. How Bible take show sey person wey God spirit dey direct different from person wey im body dey control?

3 Apostle Paul help us know how “person wey God spirit dey direct” take different from “person wey im body dey control.” (Read 1 Corinthians 2:14-16.) How dem take different? E talk sey “person wey im body dey control no dey get anything wey God spirit dey give. Dem no make sense to am; and e no go fit know dem.” But “person wey God spirit dey direct dey understand everything.” And this kind person “dey think like Jesus.” Paul tell us sey make we dey allow God spirit direct us. But e still get other things wey make person wey get God spirit different from person wey im body dey control.

4, 5. How person wey no get God spirit dey behave?

4 Make we first talk about the character of person wey dey allow im body control am. This kind person dey think like people wey dey this world. And we know sey people for this world dey think of only wetin their body want. Paul talk sey na “people wey no want hear word” get this kind character. (Eph. 2:2) People wey dey behave like this dey follow wetin other people dey do. Dem dey always do wetin their body want. This one dey make dem do wetin dem like. Dem no dey try at all to do wetin God want. The main thing wey this kind person dey always think about na im position, im money, or how e go take do wetin dey im mind even if other people no like am.

5 E get other bad things wey people wey no get God spirit dey do. (Gal. 5:19-21) Paul talk about some of dem for the first letter wey e write give brothers for Corinth. E sey people wey dey do wetin their body want dey like to cause quarrel. And if two people dey quarrel, dem dey like to support one person. Dem dey make other people no follow law, and dem dey carry each other go court. Dem no dey respect people wey God want make dem respect. And this kind people like food and drink pass any other thing. When temptation come, dem dey allow theirself fall put. (Prov. 7:21, 22) For Bible, Jude talk about people wey go dey do bad things sotey God spirit go leave dem.​—Jude 18, 19.

6. How dem take dey know person wey God spirit dey direct?

6 So wetin e mean for God spirit to dey direct person? Person wey God spirit dey direct dey think about how to do wetin go make God happy. E dey different from person wey dey do wetin im body want. E dey “follow God example.” (Eph. 5:1) E dey try to know wetin Jehovah want, and e dey try to see things the way Jehovah dey see am. E dey see God as real Person. E dey try to follow wetin God talk. (Ps. 119:33; 143:10) E no dey put eye for wetin im body want. Instead, e dey try to get the character wey God spirit dey make person get. (Gal. 5:22, 23) Make we use one example to know wetin e mean for God spirit to direct person: Person wey be businessman dey like to do business. Na so e still be with person wey God spirit dey direct. E dey like to do things wey concern God.

7. Wetin Bible talk about people wey God spirit dey direct?

7 Bible talk better things about people wey God spirit dey direct. Matthew 5:3 talk sey: “People wey know sey dem need God for their life dey happy because the Kingdom wey dey heaven na their own.” Romans 8:6 talk why e good make person dey allow God spirit direct am. E sey: “To dey put mind for the flesh dey bring death. But, to dey put mind for the spirit dey bring life and peace.” If we dey always think about God matter, we and Jehovah go be friend. We go still get rest of mind sey we dey do wetin Jehovah like, and we go get hope to enjoy life wey no go end.

8. Why e no easy to get God spirit and continue to allow am direct us?

8 We dey live among people wey dey think of only wetin their body want. So e no easy for person to get God spirit. And when we don get God spirit, we need to try well well make we no come dey think like people for this world. If person stop to allow God spirit direct am, e go start to copy the way people for this world dey think and behave. But wetin we fit do so that this kind thing no go happen? And how we fit continue to allow God spirit to direct us?

BETTER EXAMPLE WEY WE FIT LEARN FROM

9. (a) Wetin we go do make God spirit dey direct us more more? (b) Which people example we go talk about?

9 For pikin to get sense, e need to copy the better example of im papa and mama. Na so e still be for us. We need to copy the better example of people wey be Jehovah friend. This one go make us near Jehovah more more. We no suppose copy the example of people wey dey allow their body control dem. (1 Cor. 3:1-4) Example of people wey we suppose copy, and the one wey we no suppose copy dey inside Bible. Since we want make God spirit dey direct us, make we talk about people wey show better example. We go talk about Jacob, Mary, and Jesus.

One brother settle down think about Jacob example

Wetin we fit learn from the example of Jacob? (Check paragraph 10)

10. How Jacob take show sey God spirit dey direct am?

10 Make we first talk about Jacob. Life no easy for am as e no easy for many of us today. For example, im own brother wey no value things about God want kill am. Ontop that one, im wife papa try to play am wayo many times. But even with this one, Jacob continue to dey allow God spirit direct am. E get strong faith for wetin Jehovah promise Abraham. And Jacob know sey na through im family Jehovah go do wetin e promise Abraham. So e make sure sey e take care of im family well. (Gen. 28:10-15) The things wey Jacob talk and wetin e do, show sey e dey think about wetin God like, and e want make wetin God talk happen. For example, when e think sey im brother want come kill am, e tell Jehovah sey: “I dey pray to you, save me . . . You talk sey: ‘I go treat you well, and I go make your pikin many well well like sand sand wey dey sea.’” (Gen. 32:6-12) Jacob really get strong faith for wetin Jehovah promise, and e show am for the way e take live im life.

One sister dey talk about Mary example as e dey comment for meeting

Wetin we fit learn from the example of Mary? (Check paragraph 11)

11. Wetin show sey Mary na person wey God spirit dey direct?

11 Another person wey we go talk about na Mary. Wetin make Jehovah choose Mary to be Jesus mama? Mary na person wey dey always think about God and e let God spirit direct am. How we take know? When Mary go visit Zechariah and Elizabeth wey be im family people, e talk things wey show sey e dey allow God spirit direct am. (Read Luke 1:46-55.) Wetin Mary talk to praise Jehovah really show sey e know wetin dey the first part of Bible wey dem use Hebrew write. And e still show sey e like God Word well well. (Gen. 30:13; 1 Sam. 2:1-10; Mal. 3:12) Even though sey Mary and Joseph newly marry, dem no sleep with each other until Mary born Jesus. This one show sey two of dem no put mind for only wetin dem want. Instead, dem put wetin God want as the number one thing for their life. (Matt. 1:25) And when Jesus dey grow, Mary put eye for the things wey happen to am. Mary listen well to the better things wey Jesus dey talk. Apart from that one, Mary “put all the things wey e talk for mind.” (Luke 2:51) Wetin Mary do really show sey e put mind for wetin God talk about Jesus. Mary example really teach us sey e good make we dey put wetin God want as the number one thing for our life.

12. (a) How Jesus take show sey e dey copy im Father? (b) How we go take copy Jesus example? (Go check the first picture.)

12 For all the people wey don live for this earth, who you think sey be the number one example of person wey don show sey e get God spirit? Na Jesus Christ. When e dey this earth, e show sey e dey copy im Father example. Wetin e do show sey e dey think and feel like im Father. E do wetin im Father want and e follow wetin e talk. (John 8:29; 14:9; 15:10) For example, prophet Isaiah talk sey Jehovah dey pity people. If you check wetin Mark write about Jesus, you go see sey Jesus still dey pity people. (Read Isaiah 63:9; Mark 6:34.) Like Jesus, when you see people wey need help, you dey pity dem and ready to help dem? You dey put body for the preaching work like Jesus? (Luke 4:43) If you dey pity people and you dey help dem, e dey show sey you dey allow God spirit direct you.

13, 14. (a) Wetin we fit learn from people wey dey allow God spirit direct dem today? (b) Give one example.

13 Today, we still get better example of people wey dey allow God spirit direct dem. This people dey show sey dem dey copy Jesus example. You fit don see sey dem dey put body for preaching. And dem get better character wey dey make dem do good things for people, and dey pity people. Dem dey make mistake like us. But dem still dey try to get better character, and dey do things wey Jehovah want make dem do. One sister for Brazil wey im name na Rachel talk sey: “Before, I dey like to dress like people for this world. Because of that one, I no come too dey dress well. But the truth wey I learn from Bible, come make me do everything wey I fit do to be God friend. E no easy for me to change, but now I dey happy pass before, and my life don make sense.”

14 E get another sister, wey im name Reylene. E come from Philippines. This sister first dey put eye for how e go take go school and get better work. E think sey this one go make im life get head. The sister talk sey: “Small small, I no come put mind for wetin I plan to do for Jehovah. But I come see sey something wey better pass my work dey miss for my life. So I come start to dey put mind again for how I go take serve Jehovah.” Since that time, Reylene come dey put wetin Jehovah want as the number one thing for im life. E know sey Jehovah go take care of am as Matthew 6:33, 34 talk. The sister talk sey: “I know sey Jehovah go take care of me!” Person like this fit dey your congregation. E good make we dey copy the better example of this kind people wey dey follow Jesus.​—1 Cor. 11:1; 2 Thess. 3:7.

“DEY THINK LIKE JESUS”

15, 16. (a) Wetin we go do if we want be like Jesus? (b) Wetin go help us get the kind mind wey Jesus get?

15 How you go take copy Jesus example? First Corinthians 2:16 talk sey make we dey “think like Jesus.” Romans 15:5 still talk sey make we get the mind wey Jesus get. This one mean sey if we want be like Jesus, we need to know how e dey think, feel, and the things wey e do. When we don know this things finish, we go come copy im example. The main thing wey dey Jesus mind na to do wetin go make God happy. So if we dey copy Jesus example, we go dey near Jehovah more more. This one really show sey e good make we learn to dey think like Jesus.

16 How we go take do this one? Jesus disciples see the miracle wey e do, hear wetin e talk, and see how e treat different different people. Dem still see how e take follow wetin Jehovah talk. Dem sey: “We see everything wey e do.” (Acts 10:39) Today, we no fit see Jesus. But Jehovah make sure sey dem write wetin Jesus do for Bible. As we dey read about am for the book of Matthew, Mark, Luke, and John, and dey think about wetin we read, e go make us know Jesus well well. And this one go dey make us think like am. We go come fit dey follow Jesus example, and get the “kind mind” wey e get.​—1 Pet. 2:21; 4:1.

17. Wetin we go gain if we dey think like Jesus?

17 Wetin we go gain if we dey think like Jesus? Just as better food dey make person body strong, na so our friendship with Jehovah go dey strong if we dey always think like Jesus. Small small, we go come dey know how Jesus go take handle any matter. This one go help us choose wetin go make Jehovah happy, and wetin go make our conscience no worry us. You no think sey all this one na better reason why we suppose follow Jesus example?​—Rom. 13:14.

18. Wetin you don learn from this topic?

18 For this topic, we don learn wetin e mean for God spirit to dey direct person. We don still learn about the better example of people wey allow God spirit direct dem. And we see how we go take dey near Jehovah more more if we dey think like Jesus. But e still get other things wey we need to learn. For example, how we go take know whether our friendship with God strong? Which other things we fit do to make our friendship with God strong pass before? And how e go take affect how we dey live our life? We go answer this question for the next topic.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share