Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 November pp. 20-24
  • No Follow Wetin People Dey Talk

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • No Follow Wetin People Dey Talk
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • GOD REALLY DEY?
  • WE NEED RELIGION?
  • WE NEED BIBLE TO TELL US WETIN WE GO DO?
  • WHICH KIND WORK E GOOD MAKE WE CHOOSE?
  • WE GO FIT SOLVE OUR PROBLEM?
  • ‘KNOW HOW TO ANSWER’
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 November pp. 20-24
Brothers for apostle time wey dey the congregation for Colossae dey talk about the letter wey Paul write to dem

No Follow Wetin People Dey Talk

‘Make una put eye for ground so that nobody go carry una comot with wetin dem dey talk. And make nobody deceive una with wetin no get head wey come from the world.’​—COL. 2:8.

SONG: 38, 31

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • How apostle Paul take advise Christian about wetin people dey talk?

  • Wetin be one thing wey people dey talk and wetin go help us no follow am?

  • Wetin you learn for this topic wey fit help you?

1. Wetin Paul tell the brothers for Colossae? (Check the first picture.)

APOSTLE PAUL write letter give the brothers and sisters wey dey Colossae. E write am when e dey prison for Rome around 60-61 C.E. E tell dem why dem suppose know ‘the things wey God spirit dey make person sabi.’ (Col. 1:9) Paul still tell dem sey: ‘I dey talk this one so that nobody go use sweet mouth deceive una. Make una put eye for ground so that nobody go carry una comot with wetin dem dey talk. And make nobody deceive una with wetin no get head. Na people dey teach this things and na things wey come from the world. No be Jesus Christ own.’ (Col. 2:4, 8) Paul come tell dem why some things wey people dey talk no correct, and why people believe am. For example, those things dey make people believe sey dem get sense pass other people or better pass dem. Paul write this letter because e no want make the brothers follow wetin people dey talk, or join dem dey do bad things.​—Col. 2:16, 17, 23.

2. Wetin make us want learn about some things wey people dey talk?

2 Wetin people for this world dey talk show sey dem no value wetin Jehovah talk for Bible. And small small, wetin dem talk fit make us no dey follow wetin dey Bible. Today, we dey hear this things for television, Internet, for our working place, or for school. For this topic, we go learn wetin we fit do so that wetin people dey talk no go spoil our mind. We go talk about five things wey people for this world dey talk, and wetin go make us no believe dem.

GOD REALLY DEY?

3. Wetin some people dey talk, and why dem dey talk like that?

3 For many country, some people dey talk sey: “I fit be good person even if I no believe sey God dey.” And dem go tell you sey dem no get time for any religion. This people fit never think the matter well to know if God really dey. Dem get the mind sey dem fit do anything wey dem want. (Read Psalm 10:4.) For other people mind, dem think sey dem get sense if dem talk sey: “I fit know wetin good even if I no believe sey God dey.”

4. How we fit take help person wey no believe sey God dey?

4 E make sense to believe sey nobody make everything? Some people wey put mind for science to help dem find the answer don confuse. But the answer simple. House go fit grow come out from ground? Who dash am! Na people dey build am. So everything get who make am. The truth be sey, even the things wey small pass for this earth wey get life (like bacteria) dey fit do wetin house no fit do. Dem get wetin dem need to take divide theirself to form new ones wey get life like dem. Who make dem to fit do this kind thing? Bible tell us the answer when e sey: ‘Na true sey, na person dey build house, but na God make everything.’​—Heb. 3:4.

5. If we no believe sey God dey, we fit know wetin good by ourself? Explain.

5 Wetin you fit tell person wey talk sey e fit know wetin good even if e no believe sey God dey? Bible tell us sey people wey no dey serve God fit dey do some kind good things. (Rom. 2:14, 15) For example, dem fit love their papa and mama, and dey respect dem. But if person no dey follow wetin Jehovah talk, e fit choose wetin go put am for serious trouble. (Isa. 33:22) Today, many people wey dey think well believe sey na only God go fit comot all the wahala from this world. (Read Jeremiah 10:23.) So e no make sense to believe sey we go fit know wetin good even if we no believe sey God dey, or if we no dey do wetin e talk for Bible.​—Ps. 146:3.

WE NEED RELIGION?

6. Wetin many people dey talk about religion?

6 Many people dey talk sey: “You fit still happy even if you no dey any religion.” Religion matter dey tire this kind people. And to dem, e no get anything wey person fit gain from religion. Other people no like religion because many of dem dey teach hellfire, dey collect tithe and dey support politics. This one dey make people no learn truth about God. No wonder many people feel sey dem no need religion to make dem happy. This kind people fit tell us sey: “I like anything wey concern God o, but I no want join any religion.”

7. How correct religion take dey make people happy?

7 Na true sey we no need religion to make us happy? The truth be sey fake religion no fit make person happy. But, if person no be God friend, e no fit really happy. Bible talk sey Jehovah na ‘happy God.’ So person wey no dey serve am no fit really dey happy. (1 Tim. 1:11) Jehovah dey always do things wey go help us. People wey dey serve God dey always happy because dem like to help other people. (Acts 20:35) The correct religion dey teach family wetin go make dem happy. For example, e dey make husband and wife respect each other, e no dey make dem eye another man or woman, their children dey get respect, and e dey make everybody for family love each other. So, people wey dey serve Jehovah for the whole world get peace, dem love each other, and dem get one mind.​—Read Isaiah 65:13, 14.

8. How we fit use Matthew 5:3 take help people know wetin dey make person happy?

8 Na true sey person fit dey happy even if e no serve God? But think am, Wetin fit make person happy? Some people dey enjoy their work, sport or other things wey dem dey like to do. Other people fit like to take care of their friend or people for their family. Na true sey people like all this things and dem dey enjoy am. But all this things no fit really make person happy. We dey different from animal. We fit learn about the Person wey make us and serve am well. Jehovah make us to dey happy as we dey serve am. (Read Matthew 5:3.) For example, when we gather together with our brothers and sisters for meeting, e dey make us happy. For there we dey hear things wey go help us. (Ps. 133:1) All of us for the whole world get one mind, we dey live clean life and we get better hope. This things dey make us happy.

WE NEED BIBLE TO TELL US WETIN WE GO DO?

9. (a) Wetin people dey talk about sex matter? (b) Why God hate am if person sleep with who no be im husband or wife?

9 Some people dey talk sey: “Wetin bad if I sleep with person wey no be my husband or wife?” Dem fit tell you sey: “Enjoy your life. Who tell you sey e no good?” Na bad thing to sleep with person wey no be our husband or wife. Why? Because Bible tell us sey God hate am.a (Read 1 Thessalonians 4:3-8.) Jehovah get the right to tell us wetin we go do because na im make us. Jehovah sey na only people wey don marry suppose sleep with each other. E give us this law because e love us, and we go gain am if we follow am. This kind thing dey make love and respect dey family. E still dey make family get peace of mind. God go punish people wey open eye do wetin e no like.​—Heb. 13:4.

10. Wetin go help us run from sex wey no clean for God eye?

10 Bible tell us wetin we go do to run from sex wey no clean for God eye. One way na to control wetin we dey look. Jesus talk sey: ‘Any man wey dey look woman sotey e want sleep with am, that man don already sleep with am for im heart. If your right eye dey make you do bad, make you pull am comot and trowey am.’ (Matt. 5:28, 29) So e no good make we dey watch film or dey look picture wey dey show naked people. And make we no listen to any music wey dey talk about sex matter. Apostle Paul tell Christian sey: ‘Kill the different different part of una body where things like this dey: all sex matter wey no clean for God eye.’ (Col. 3:5) Make we still dey control wetin we dey think and wetin we dey talk.​—Eph.5:3-5.

WHICH KIND WORK E GOOD MAKE WE CHOOSE?

11. Wetin fit make us want put all our body for work?

11 Many people dey talk sey: “Na work wey go make you get plenty money go make you happy.” Dem fit advise us to put all our body for this kind work. This kind work fit make us be big man, get people wey we dey control, and e fit make people know us well well. We self fit start to think like that, because many people dey think like that.

12. Work wey dey bring plenty money dey make person really happy?

12 Na true sey we go really happy if we get work wey go make us get money, dey control people or make people know us? No. Remember sey, Satan do wetin e do because e want dey control other people and want make dem know am. But we fit talk sey e dey happy? For where! (Matt. 4:8, 9; Rev. 12:12) Those things no fit really make us happy because dem no dey last. We no go fit take that one compare the work wey we dey do for Jehovah. E dey make us happy to help other people learn about Jehovah and wetin e promise us. Big work wey dey bring plenty money dey make people drag for position, e dey cause jealousy, and e dey make people hate each other. And after everything, this kind people go still be like ‘person wey dey try to catch breeze.’​—Eccl. 4:4.

13. (a) How we suppose to dey look work? (b) Wetin make apostle Paul really happy?

13 Na true sey all of us need work to survive. And e no bad to choose work wey we like. But make e no be the number one thing for our life. Jesus sey: ‘Nobody fit serve two oga. E go hate one and love the other one, or e go hold one tight and leave the other one. Una no fit serve God and money.’ (Matt. 6:24) Mouth no go fit talk how we go happy reach if we dey use all our heart serve Jehovah, and dey teach other people about am. Apostle Paul see sey this one na true. Before Paul become Christian, e first get am for mind to be big man. But later, Paul come see sey wetin make am really happy na to dey tell people about Jehovah and dey see how Bible dey change their life. (Read 1 Thessalonians 2:13, 19, 20.) E no get any other work wey dey make person happy reach this one.

E dey sweet one sister as e dey prepare to go study person, as e dey teach one woman truth for Bible, and as the woman follow am go meeting

Na when we dey help other people see wetin God talk we go really dey happy (Check paragraph 12, 13)

WE GO FIT SOLVE OUR PROBLEM?

14. Why many people think sey we go fit solve our problem by ourself?

14 People dey talk sey: “We go fit solve our problem by ourself.” Many people think sey na true. Why? Because dem like to dey do wetin dem want, and dem no want make God tell dem wetin dem go do. You fit don hear some people talk sey our problem don dey come down. Dem sey war, sickness, poverty and other bad things no too dey again. One man write sey: “Things dey better now because human being don tell theirself sey dem want make this world better.” But na true? We really know how we go take solve the problem wey dey this world? To know the answer, make we talk about the problem one by one.

15. Wetin show sey the problem wey dey this world don pass be careful?

15 War: E pass 60 million people wey die for First World War and Second World War. But that one no teach people lesson, dem still dey fight war. For 2015 when dem calculate the number of people wey run from their place because of war and suffer, dem see sey e don plenty reach about 65 million people. For only 2015, na around 12.4 million people run comot from their place. What of bad things? Na true sey some kind bad things don reduce for some place. But other bad things like “yahoo-yahoo,” people wey dey bomb other people, and man wey dey beat im wife, just dey worse everyday. Many people believe sey things don spoil pass as e be before. Human being no fit stop the bad things wey dey happen. What of sickness? Some sickness don get cure. But for 2013, dem talk sey nine million people wey never reach 60 years dey die every year because of heart disease, stroke, cancer, breathing problem, and diabetes. What of poverty? World Bank talk sey the number of people wey poverty want kill for only Africa, don high well well. E climb from 280 million people for 1990 to 330 million people for 2012.

16. (a) Why e be sey na only God Kingdom fit solve our problem? (b) Wetin the book of Psalm and Isaiah talk about, wey God Kingdom go do?

16 People wey dey do business and government dey only think of theirself because dem get big eye. E clear sey this kind people no fit comot war, bad things, sickness, and poverty. Na only God Kingdom go fit comot dem. Think about wetin Jehovah go do to dem. War: God Kingdom go comot things wey dey make people fight war. Things like long throat, fake religion and wayo no go dey. People no go dey think sey their country better pass other people own. Even Satan self no go dey again. (Ps. 46:8, 9) Bad things: Jehovah dey teach us how to love and trust each other now. No government don fit do this one. (Isa. 11:9) Sickness: Jehovah go comot sickness, and people no go get comma for body again. (Isa. 35:5, 6) Poverty: Jehovah go comot am. E go make everybody enjoy life, and dem go be im friend. Money go fit buy this one?​—Ps. 72:12, 13.

‘KNOW HOW TO ANSWER’

17. Wetin you go do if you no want follow wetin people dey talk?

17 If wetin people dey talk different from wetin you believe, wetin you suppose do? Check wetin Bible talk about the matter, and discuss am with person wey don dey serve Jehovah tey tey. Think about why those things wey dem dey talk fit make sense to people, wetin make am no correct, and why e no good make we follow am. Wetin Paul tell the brothers for Colossae, go help us no follow wetin people dey talk. E sey: ‘Make una dey use sense do things with people wey no dey serve God. Know how to answer different different person well.’​—Col. 4:5, 6.

a Many people no know sey dem add wetin dey John 7:53–8:11 join some Bible. This part no dey the original Bible wey dem write. Because of wetin that place talk, some people dey talk sey na only person wey never sin fit talk sey e bad to sleep with who no be your husband or wife. But for the law wey Jehovah give Israel people, e tell dem sey: ‘If you catch person wey dey sleep with another man wife, make you kill two of dem.’​—Deut. 22:22.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share