One sister dey preach for inside tea farm for Cameroon
Example Wey You Fit Follow
THE WATCHTOWER
Question wey you go ask: Upon all the things wey people don do to make sure sey Bible no dey again, if to sey no be book wey come from God, you think sey e for still dey?
Bible wey you go read: Isa 40:8
How you go give am: This magazine talk about how Bible take survive till this our time.
THE WATCHTOWER (back of The Watchtower)
Question wey you go ask: I want know wetin you think about this question. [Read the first question for page 16.] Some people believe sey na person form religion. Other people still think sey God dey use religion draw us near body. Wetin you think?
Bible wey you go read: Jas 1:27, ftn.
How you go give am: This topic explain other things wey Bible talk about this matter. I go like come back make we talk some point wey dey under this topic.
GOOD NEWS WEY COME FROM GOD!
Question wey you go ask: Many people think sey to dey read wetin Bible don talk sey e go happen just be like to dey read newspaper. Inside all this things wey Bible talk sey e go happen, which one you don see or hear sey e happen?
Bible wey you go read: 2Ti 3:1-5
How you go give am: This brochure explain why this things wey dey happen na good news for people wey love God. [Tell am some things wey dey lesson 1, question 2.]
WRITE AS YOU GO DO YOUR OWN
Use the way dem write the example for here take write as you go do your own when go preach.