Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 February p. 8
  • Help Your Children Get Strong Faith for God

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Help Your Children Get Strong Faith for God
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Similar Material
  • Where We Fit Get Answer to Many Many Question Wey Dey Worry Us for Mind?
    Where We Fit Get Answer to Many Many Question Wey Dey Worry Us for Mind?
  • Wetin Fit Make Our Family Happy?
    Wetin Fit Make Our Family Happy?
  • What Is True Love?
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Question From People Wey Dey Read Our Book
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 February p. 8

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Help Your Children Get Strong Faith for God

We dey see the kind power wey Jehovah get for the things wey e make. (Ps 19:1-4; 139:14) But for this world wey Satan dey control, people dey talk lie about how life take start. (Ro 1:18-25) Wetin una go do so that all this yeye story no come start to dey grow for una children mind? Na from small pikin you go start to help dem get strong faith for Jehovah. Help dem know sey Jehovah really dey and sey e dey care for dem. (2Co 10:4, 5; Eph 6:16) Know how wetin dem dey learn for school take dey affect how dem dey think. And use the many things wey Jehovah don give us teach dem wetin go touch their mind.​—Pr 20:5; Jas 1:19.

One papa dey teach im pikin the things wey God make; dem dey teach dem for school sey everything come by theirself; Wetin Your Mate Talk—Things Wey Show Sey God Dey

WATCH THIS VIDEO WETIN YOUR MATE TALK—THINGS WEY SHOW SEY GOD DEY. AFTER, ANSWER ALL THIS QUESTION:

  • Wetin some people believe about God?

  • Wetin dem dey teach you for school?

  • Why you believe sey Jehovah really dey?

  • How you go take help person believe sey na God make everything?

OTHER THINGS WEY WE GET:

• JW.ORG series “My Bible Lessons” (For Age 3 and under)

• Video Make You Be Jehovah Friend—‘Na Jehovah . . . Make Everything’

• Awake! series “Was It Designed?”

• JW.ORG worksheet “Why Do I Believe in God?”

• JW.ORG series “Creation or Evolution?” (four parts)

• JW Broadcasting video “Wetin People Talk About How Life Take Start”

• Video The Wonders of Creation Reveal God’s Glory

• Brochure Was Life Created?

• Book Is There a Creator Who Cares About You?

The Origin of Life​—Five Questions Worth Asking

The Origin of Life—Five Questions Worth Asking

This brochure na for young people wey be Jehovah Witness, wey dem dey teach for school sey no be God make everything. We fit still give am to people wey really want know if na God make everything.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share