SONG 79
Teach Dem Make Dem Stand Well
(Matthew 28:19, 20)
1. Na good thing, to help people know God,
And serve am, with all their heart.
Dem don choose to serve Jehovah God,
And praise am with all their heart.
(CHORUS)
Jehovah we dey pray for dem
Because na you go fit help dem.
Dey help dem make dem no tire.
Abeg no stop to dey help all of dem stand well.
2. Everyday, we dey try pray for dem.
Everytime, we dey teach dem.
Everything, wey Jehovah don talk,
Dem don learn, and dem obey.
(CHORUS)
Jehovah we dey pray for dem
Because na you go fit help dem.
Dey help dem make dem no tire.
Abeg no stop to dey help all of dem stand well.
3. When Satan dey bring problem dey come,
And this world dey suffer dem.
We go pray, make Jehovah help dem.
Make their faith, no ever shake.
(CHORUS)
Jehovah we dey pray for dem
Because na you go fit help dem.
Dey help dem make dem no tire.
Abeg no stop to dey help all of dem stand well.
(Still check Luke 6:48; Acts 5:42; Phil. 4:1.)