Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • Which Kind Work Elders Dey Do for Congregation?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 15

      Which Kind Work Elders Dey Do for Congregation?

      One elder dey talk to some people for congregation

      Finland

      One elder dey teach for congregation

      Elders dey teach

      Elders dey encourage some people for congregation

      Elders come visit dem for house

      One elder dey preach

      Dem dey preach

      Just as e be for Apostle time, Jehovah Witness people dey choose some people wey love God well well and wey ready to ‘help other people for the congregation to serve God.’ We dey call dem elders. Their faith strong well well. (Acts 20:28) Elders na people wey don learn about God well well and wey go fit help other people serve God well. ‘Na the love wey dem get for God dey make dem do this work. Dem no dey collect salary, and nobody dey force dem do their work.’ (1 Peter 5:1-3) How elders take dey help us?

      Dem dey take care of the congregation. Elders dey help everybody for the congregation learn wetin God want. Dem want make we serve God well. Dem sabi sey na God give dem this big work. Na im make dem no dey march people head pass. Their work dey make us happy well well. (2 Corinthians 1:24) Just like mama wey get pikin dey sofri sofri take care of im pikin, na so elders dey do for everybody wey dey their congregation.—Proverbs 27:23.

      Dem dey help us do wetin God want. Na every week elders dey use Bible take teach us wetin God want. This one dey make our faith strong well well. (Acts 15:32) Dem dey show us correct example for preaching and dey train us for different different way to take preach.

      Dem dey help all of us one by one. Elders get love well well for the congregation. Sometimes, dem dey visit us for our house or for Kingdom Hall. Dem dey use Bible help us, so that we go fit keep wetin we dey learn for mind.—James 5:14, 15.

      As dem no dey collect salary, elders dey do other work to support their family. We dey respect this elders because no be small work dem dey do.—1 Thessalonians 5:12, 13.

      • Which kind work elders dey do for congregation?

      • How elders dey take help all of us one by one?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Na who fit be elder? You fit read 1 Timothy 3:1-10, 12, and Titus 1:5-9 make you see who Bible talk sey fit be elder or ministerial servant.

  • Wetin Be Ministerial Servant Work?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 16

      Wetin Be Ministerial Servant Work?

      One ministerial servant dey give people book and magazine for congregation

      Myanmar

      One ministerial servant dey give public talk

      One of our meeting

      One ministerial servant dey conduct meeting for field service

      People wey want go preach

      One ministerial servant dey follow people clean and repair Kingdom Hall

      Dem dey clean Kingdom Hall

      Na overseer and ministerial servant dey take care of the congregation as Bible talk. (Philippians 1:1) We get plenty overseer and ministerial servant for different different congregation. How ministerial servant work take dey help us?

      Dem dey help elders. Ministerial servant na some of our brothers wey get strong faith for Jehovah. You fit trust dem because dem dey fear God well well. Some young and some na old people. Dem dey do different different work for the congregation make elders fit get plenty time to teach the congregation Bible.

      Dem dey do work wey go help the congregation. Some ministerial servant work na to greet people wey come meeting and show dem where dem go sitdown. Some dey arrange our song, some work na to share book give people. Some dey check contribution box and some dey show area wey brothers and sisters go preach. Dem still dey join clean our Kingdom Hall. Elders fit even tell some make dem help some brother and sister wey don old. Everybody for congregation dey respect dem because dem dey use all their mind do any work wey elders give dem.—1 Timothy 3:13.

      Dem dey show us good example. Na only people wey get better character dem dey make ministerial servant. This brothers dey follow wetin Bible talk because dem love Jehovah well well. The talk wey dey give for congregation dey make our faith strong. Their example for preaching dey help everybody for the congregation to dey preach well. Because dem dey join hand with elders, the congregation dey serve God together with one mind. (Ephesians 4:16) If dem continue with this fine fine work, dem go be elders one day.

      • Which kind people ministerial servant be?

      • Wetin ministerial servant dey do to make sure sey things go well for congregation?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Any time wey you go our Kingdom Hall, make you try know the elders and ministerial servant one by one and even their family.

  • How Circuit Overseer Dey Help Us?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 17

      How Circuit Overseer Dey Help Us?

      One circuit overseer and im wife

      Malawi

      One circuit overseer dey conduct meeting for service

      People wey want go preach

      One circuit overseer dey preach

      People wey dey preach

      One circuit overseer dey do meeting with elders for congregation

      Elders dem dey do meeting

      Bible talk about Apostle Paul and Barnabas well well. Dem dey travel go different different place to go see people wey dey congregation for that time. Na because sey dem love their brothers and sisters well well make dem dey go visit dem. Paul talk sey e ‘want go back make e see all the brothers,’ make e fit know how dem dey. Paul ready to go far far place to see dem and help dem. (Acts 15:36) Na the same thing circuit overseer dey do today.

      Dem dey come help us. Circuit overseer dey visit congregation two times for one year. Na one one week dem dey stay. Na so dem take dey visit about 20 different different congregation. Their example, and their wife own if dem don marry, fit help us. Dem dey try sabi everybody for the congregation whether na pikin or old person. Dem dey follow us go visit people wey we dey help learn Bible. Dem and other elders dey go visit brothers and sisters to help dem serve Jehovah well. The kind talk wey dem dey give for our meeting and assembly dey make our faith strong.​—Acts 15:35.

      Dem dey show love for everybody. Circuit overseer want make everybody for congregation serve Jehovah well. The meeting wey dem dey do with elders and ministerial servant dey help dem sabi how things dey for congregation. For this meeting, circuit overseer dey give dem better better advice wey go help dem do their work well. Dem even dey help pioneer sabi how dem go take preach well. Dem really want sabi and help people wey just join us make their faith fit strong well well. This brothers ‘dey work for our own good.’ (2 Corinthians 8:23) Make we follow their example.​—Hebrews 13:7.

      • Why circuit overseer dey visit congregation?

      • Wetin we go gain when dem come?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Make you mark the next time wey circuit overseer go visit your congregation for your calendar, make you no miss am. And if you want make im or im wife join your Bible study, make you tell person wey dey study Bible with you.

  • How We Take Dey Help Our People Wey Dey Inside Wahala?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 18

      How We Take Dey Help Our People Wey Dey Inside Wahala?

      Jehovah Witness people dey carry food and other things come to help brothers for Dominican Republic

      Dominican Republic

      Jehovah Witness people dey build one Kingdom Hall wey don scatter for Japan

      Japan

      One Jehovah Witness dey tell one brother for Haiti wetin go make e mind come down

      Haiti

      Jehovah Witness people dey quick arrange things to help their people when different different wahala happen. This one dey show sey we love ourself well well. (John 13:34, 35; 1 John 3:17, 18) How we take dey help dem?

      We dey help dem with money. For Apostle time, when plenty plenty people dey hungry for Judea, Christian wey dey Antioch gather money send go give their brothers wey dey there. (Acts 11:27-30) Na so Jehovah Witness people dey do today. When we hear sey our brothers and sisters dey suffer for anywhere for this world, we dey gather money for our congregation send go give dem.—2 Corinthians 8:13-15.

      We dey help dem with wetin dem need. Elders wey dey the area wey the big wahala happen dey try check whether everybody for the congregation dey fine. Some of dem dey arrange food, clean water wey dem go drink, cloth wey dem go wear, place wey dem go stay and medicine wey dem go take. Jehovah Witness people wey sabi how to build house go come join build the Kingdom Hall and house wey scatter. When wahala happen, Jehovah Witness people dey quick help because all of us na one. Na true sey we dey help our brothers but we still dey help plenty people wey no be Jehovah Witness.—Galatians 6:10.

      We dey use Bible take help dem. People wey dey inside this kind big wahala need help. When e happen like that, we dey get power from Jehovah, ‘God wey dey make our mind come down.’ (2 Corinthians 1:3, 4) Jehovah Witness people dey happy to tell people wetin dey inside Bible sey, e no go tey wey God go use im kingdom comot all wahala wey dey make us suffer.—Revelation 21:4.

      • Why Jehovah Witness people dey help people quick quick when wahala happen?

      • How we fit use Bible take cool the mind of people wey suffer this kind wahala?

  • Who Be the Faithful and Discreet Slave?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 19

      Who Be the Faithful and Discreet Slave?

      Jesus dey follow im disciple talk
      One Jehovah Witness dey study one book wey dey teach wetin dey inside Bible

      As we dey learn Bible, we dey gain better thing

      Two brothers wey dey part of the governing body of Jehovah Witness people

      Before Jesus die, e get wetin e tell Peter, James, John, and Andrew wey be im disciple. E tell dem wetin dem go dey see to know sey the end don dey near. E come ask dem sey ‘na who be the faithful and discreet slave, wey im oga tell make e take care of all im servant and give dem food for the correct time?’ (Matthew 24:3, 45; Mark 13:3, 4) Wetin Jesus dey tell im disciple be sey, as na im be their oga, im go choose people wey go dey give dem better food from inside Bible for this last days. Who be this slave?

      Dem be small group wey God use im spirit choose. Na dem we dey call Governing Body for Jehovah Witness people. This Governing Body dey help us sabi wetin dey inside Bible for the correct time. Na only this Governing Body wey get sense well well we put our mind make dem dey give us food from inside Bible ‘for the correct time.’​—Luke 12:42.

      Dem dey take care of God house. (1 Timothy 3:15) Jesus give this slave big work. This work na to dey take care of all im people and property wey dey this world. Dem dey arrange preaching, money matter, and even arrange everything wey we dey learn for our different different congregation. Things wey we dey learn from our book dem, and for our meeting and assembly show sey Governing Body dey give us everything wey we need and when we need am.

      This better slave dey faithful because dem dey teach the correct thing wey dey inside Bible and dem dey do the preaching work wey Jesus sey make dem do. The correct way wey dem take dey manage Jesus property for this world show sey this discreet slave get sense well well. (Acts 10:42) Jehovah dey bless this work with plenty plenty good things.​—Isaiah 60:22; 65:13.

      • Who Jesus choose make e give im disciple food from inside Bible?

      • Wetin show sey this slave dey faithful and discreet?

  • How Governing Body Take Dey Work Today?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 20

      How Governing Body Take Dey Work Today?

      Governing body for the apostle time

      Governing body for the apostle time

      Christians for apostles time dey read letter wey come from the governing body

      Dem dey read letter wey governing body send come

      For the Apostle time, na one small group wey be ‘apostles and elders’ for Jerusalem be the governing body. Na dem dey tell all the congregation the better better thing wey dem go do. (Acts 15:2) Before dem gree for any matter, dem dey first look wetin Bible talk and dem dey follow wetin holy spirit want make dem do. (Acts 15:25) Na the same thing Governing Body dey do today.

      God dey use dem do wetin e want. This brothers wey be Governing Body love Bible well well. Dem sabi how to take care of Bible matter and other matter dem. Dem dey gather everyweek to know wetin dey worry their brothers and sisters wey dey everywhere for this world. Dem still dey use letter or circuit overseer and other people take dey tell us wetin Bible talk. This one dey help us get one mind. (Acts 16:4, 5) Na this Governing Body dey arrange things wey we dey learn from Bible for different different congregation, dem still dey arrange our preaching work. And na dem dey choose some brothers wey go take care of congregation.

      Dem dey do wetin God spirit tell dem. Governing Body dey follow wetin Jehovah and Jesus dey tell dem. (1 Corinthians 11:3; Ephesians 5:23) Dem no dey think sey dem be the oga for God people. Dem with their brothers wey holy spirit choose ‘dey follow Jesus anywhere e go.’ (Revelation 14:4) As dem dey do this big work so, dem go like am if we dey remember dem for our prayer.

      • Which people be the governing body for the apostle time?

      • How the Governing Body take dey show sey dem want make God use dem for this our time?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      If you read Acts 15:1-35, you go see how Bible and holy spirit take help governing body that time solve one big problem

  • Wetin Be Bethel?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 21

      Wetin Be Bethel?

      Two Jehovah Witness wey dey work for Art Department for Bethel

      Art Department, U.S.A.

      One of Jehovah’s Witnesses working in the Bethel printery in Germany

      Germany

      One Jehovah Witness wey dey work for were dem dey wash cloth for Bethel wey dey Kenya

      Kenya

      Waiter dey arrange table for dinning for Bethel wey dey Colombia

      Colombia

      Bethel, na Hebrew name wey mean ‘God House.’ (Genesis 28:17, 19, footnote) That name really fit the office wey Jehovah Witness people dey use take arrange their preaching work for different different country. The Governing Body dey for our head office wey dey New York for America. Na from there dem dey check branch office dem wey dey other country. Because dem dey work together, chop together and even learn Bible together, dem dey call dem Bethel family.​—Psalm 133:1.

      Na special place wey people dey use their mind work. Na people wey love God well well wey dey use all their time support preaching dey work for Bethel. (Matthew 6:33) Dem no dey collect salary but all of dem get fine place to stay. And dem dey give dem pocket money to buy small small things. Everybody for Bethel get work. Some dey work for office, some for kitchen, some na for where dem dey print book. Some even dey take care of the house, cloth and do other small small things.

      Na place where people dey use all their time support preaching. Everything wey we dey do for Bethel na to help many many people sabi the correct things wey dey inside Bible. This book wey you dey read na one of dem. Na Governing Body write am. Dem use computer send am go give people wey go translate am for different different language for the whole world. When dem translate am finish, dem go print am with machine wey sabi do the work quick quick for Bethel. When the book don ready, dem go send am go all the congregation wey pass 110,000. Every work wey we dey do for Bethel na to support our preaching make people fit hear am quick quick.​—Mark 13:10.

      • Who dey work for Bethel, and wetin dem dey give dem?

      • Which serious work Bethel for different different country dey support?

  • Which Work We Dey Do for Our Branch Office?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 22

      Which Work We Dey Do for Our Branch Office?

      Some brothers dey arrange the work for branch wey dey for Solomon Islands

      Solomon Islands

      One Jehovah Witness person dey work for our branch office wey dey Canada

      Canada

      Trailers wey dem take dey carry book and magazine go different different place

      South Africa

      Na different different work dey Bethel. All this work na to support preaching for their country and any country wey dey under dem. Some dey work for where dem dey write book for different different language, some na for where dem dey print am, and some work na to arrange and keep am. Some even dey work for where dem dey do video and other things.

      Na Branch Committee dey take care of Bethel. Na Governing Body put this work for Branch Committee hand. Branch Committee fit be three elder or e fit pass. Dem dey follow wetin Bible talk. Na dem dey tell Governing Body how the preaching work dey go for their country and if any wahala dey. This one go help Governing Body sabi the kind book wey dem go print, and the kind matter wey we go hear for meeting and assembly. Governing Body still dey send some brothers go different different branch office to help the brothers wey dey Branch Commitee to fit do their work well. (Proverbs 11:14) For that visit, the brother go give talk wey go encourage all the brothers wey dey live for that branch area.

      Branch Office dey help all the congregation. Na branch office go gree sey make dem form new congregation. Dem dey tell pioneer, missionary, and circuit overseer wey dey their country things wey dem go do. Na dem dey arrange how dem go take build new Kingdom Hall. Dem still dey make sure sey dem send publication go different different congregation. Everything wey dem dey do for branch office na to support the preaching work.​—1 Corinthians 14:33, 40.

      • How Branch Committee take dey support Governing Body?

      • Which work branch office dey do?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      Make you try visit any branch office anytime from Monday go reach Friday. If you dey come, make you wear cloth like person wey dey go meeting for Kingdom Hall. Wetin you go see go help you serve God well well.

  • How We Take Dey Write and Translate Our Book for Different Different Language?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 23

      How We Take Dey Write and Translate Our Book for Different Different Language?

      Person wey dey work for Writing Department for U.S.A.

      Writing Department, U.S.A.

      People wey dey translate our book for South Korea

      South Korea

      One man for Armenia dey hold one book wey Jehovah Witness people translate

      Armenia

      One girl for Burundi dey hold one book wey Jehovah Witness people translate

      Burundi

      One woman for Sri Lanka dey hold some magazine wey Jehovah Witness people translate

      Sri Lanka

      Jehovah Witness people want make everybody for this world hear wetin God talk. Na im make us dey make different different book for many language wey don pass 750. (Revelation 14:6) How we take dey do am? We get some people wey dey for different different country wey dey help us write, and people wey dey help us put am for different different language. All of dem na Jehovah Witness people.

      Na English dem dey first use write the book. Na Governing Body dey arrange all the work wey Writing Department for our head office dey do. All the people wey dey write our book wey dey our head office and some branch office dey under this Writing Department. Since we get different people wey come from different different country wey dey do this work, e dey help us write about different different matter about different different tribe. This one dey make our book touch people mind as dem dey read am for their language.

      Dem go send the English go give people wey go write am for different different language. After dem don check the English well well and see sey e correct, dem go use computer send am go give people wey go translate am for different different language. This people wey dey translate am for different different language dey choose correct word wey talk wetin English talk. When dem translate am finish, dem go check am and read am to see sey e correct well well.​—Ecclesiastes 12:10.

      Computer dey make the work fast. Na true sey computer no fit do wetin person go do, but e fit make the work fast because of plenty things wey dey inside. Jehovah Witness people get one computer program wey we dey call Multilanguage Electronic Publishing System (MEPS). This program dey help us arrange the work, put the photo and other things for different different language before we print am.

      Why we dey do all this kind work even for language wey be sey the people wey dey speak am no plenty? Na because Jehovah want make ‘everybody sabi the correct thing wey Bible dey talk and get life wey no go end.’​—1 Timothy 2:3, 4.

      • How dem take dey write our book?

      • Why we dey translate our book for different different language?

  • How We Take Dey Get Money for Our Work?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 24

      How We Take Dey Get Money for Our Work?

      Person dey put money for contribution box
      Jehovah Witness dey preach

      Nepal

      Brothers and sisters for Kingdom Hall construction group for Togo

      Togo

      Brothers dey work for branch office for Britain

      Britain

      Na every year we dey print plenty book and Bible. And na for free we dey give people this publication. We dey build and repair many many Kingdom Hall and branch office for many place. We even dey support all the people wey dey work for Bethel and plenty missionary wey dey preach for other country. We still dey send money go give our people wey dey inside wahala. Where you think sey all this money dey come from?

      We no dey do offering or pay tithe. Na true sey na big money we take dey do all our work. But we no dey beg people for money, one of our Watchtower wey dem don write tey tey talk sey: ‘We believe sey Jehovah dey for our back so we no go ever beg people for money’ and e never happen!​—Matthew 10:8.

      Na money wey people use their mind give na im we dey use. Many people like our work, so dem dey put money to take support am. We wey be Jehovah Witness people dey happy to use all our mind, our power, our money, and other things wey we get to take support God work for everywhere. (1 Chronicles 29:9) We get small small box for our Kingdom Hall and assembly Hall wey person fit put money as im mind tell am make e give. Or person fit donate money from our web site, jw.org. All the money wey we dey get, na from people wey no too get money. E just be like the woman wey Jesus talk sey e put small money inside box for temple. (Luke 21:1-4) So anybody ‘fit keep something’ wey e go put ‘as im mind tell am.’​—1 Corinthians 16:2; 2 Corinthians 9:7.

      We know sey Jehovah go continue to dey touch people mind to use the better thing wey dem get take support our work.—Proverbs 3:9.

      • How Jehovah Witness people take different from other religion?

      • How we dey take use money wey people use their mind give?

  • Why We Dey Build Kingdom Hall and How We Take Dey Build Am?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 25

      Why We Dey Build Kingdom Hall and How We Take Dey Build Am?

      Kingdom Hall construction volunteers in Bolivia

      Bolivia

      Brothers wey want build Kingdom Hall for Bolivia
      One Kingdom Hall for Nigeria after dem don build am finish

      Nigeria, before and after

      One place wey dem want build Kingdom Hall for Tahiti

      Tahiti

      Everything wey we dey learn for our Kingdom Hall na about God Kingdom. And na that Kingdom be the main thing wey Jesus preach when e dey for this world. Na im make we dey call am Kingdom Hall.​—Luke 8:1.

      Na place wey you fit worship God the way wey e want. Na Kingdom Hall, Jehovah Witness people dey learn plenty plenty things wey dey help dem sabi how to preach well well. (Matthew 24:14) Kingdom Hall get different different size. But, all of dem dey simple and clean. Plenty congregation fit use one Kingdom Hall. Today, we don build plenty plenty Kingdom Hall, (like five everyday) make everybody worship Jehovah for better place. How we take dey do am?​—Matthew 19:26.

      Dem dey build am with money wey people take their mind give. All this money dey go our branch office. Na from there we dey comot money build Kingdom Hall and repair any one wey don old.

      People wey dey build am come from different different place and dem no dey collect salary. Na Kingdom Hall Construction Group dey do this work for different different country. This people dey travel go different different village or town to build Kingdom Hall for the congregation wey dey their country. For other country, dem choose some brother wey love Jehovah and sabi the work well well, make dem dey check how the work dey move for their area. Na plenty people wey dey use the Kingdom Hall dey help do the work. Na Jehovah spirit dey help dem do this work.​—Psalm 127:1; Colossians 3:23.

      • Why we dey call the place wey we dey worship God Kingdom Hall?

      • How we manage take dey build Kingdom Hall for everywhere?

  • How We Go Fit Help Take Care of Our Kingdom Hall?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 26

      How We Go Fit Help Take Care of Our Kingdom Hall?

      Jehovah Witness people dey clean their Kingdom Hall for Estonia

      Estonia

      Jehovah Witness people dey clean their Kingdom Hall for Zimbabwe

      Zimbabwe

      One Jehovah Witness dey repair Kingdom Hall for Mongolia

      Mongolia

      One Jehovah Witness dey paint Kingdom Hall for Puerto Rico

      Puerto Rico

      God name dey clean well well. As we dey use im name for our Kingdom Hall, that place suppose dey clean too. One way we fit take serve God na to join clean our Kingdom Hall, repair am, and make sure sey everything wey dey inside clean well well. Anybody fit join clean am.

      You fit join clean Kingdom Hall when meeting finish. People for Kingdom Hall dey happy to join hand together clean our Kingdom Hall when meeting finish. We dey clean everywhere for our Kingdom Hall every week. And na elder or ministerial servant dey share work wey people go do. You go fit sweep, wash ground, clean chair and arrange am, wash toilet, clean window, trowey dirty or clean outside. Every year e get one day wey we take dey clean our Kingdom Hall well well. If you tell your pikin sey make dem join clean Kingdom Hall, e go help dem to dey respect God house.​—Ecclesiastes 5:1.

      You fit help repair something. Every year we dey check if everything wey dey for Kingdom Hall still dey work well. We dey check like this to make sure sey everything dey work well, make we for no use big money repair am when e spoil finish. (2 Chronicles 24:13; 34:10) Na Kingdom Hall wey dey clean and fine good to worship God. If we join do work for Kingdom Hall, e dey show sey we like Jehovah and the place wey we dey worship am well well. (Psalm 122:1) This work wey we dey do dey touch people mind for the area.​—2 Corinthians 6:3.

      • Why e good make we join take care of our Kingdom Hall?

      • Wetin we dey do to make sure sey our Kingdom Hall dey clean?

  • How the Library Wey Dey for Kingdom Hall Fit Help Us?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 27

      How the Library Wey Dey for Kingdom Hall Fit Help Us?

      One man wey dey use the library wey dey for Kingdom Hall

      Israel

      One Jehovah Witness wey dey help one young man do research

      Czech Republic

      One small girl wey dey write im name inside im songbook

      Benin

      One man wey dey use Watchtower Library do research

      Cayman Islands

      You go like sabi wetin dey inside Bible well well? E get any person, place or anything for Bible wey you go want know? Or you don ever think whether Bible fit help you answer the different different question wey dey worry you for mind? You fit use where we dey keep different different book for Kingdom Hall wey we dey call library.

      You go see book or any other thing wey go help you get answer for different different question. You fit no get all the different different book wey Jehovah Witness people don do for your language, but you go see many new book for inside the library wey dey for Kingdom Hall. Different different Bible, better dictionary and other different different book wey go help you dey there. You fit use the library before meeting start and when meeting finish. If computer dey there, Watchtower Library fit dey inside. This Watchtower Library na wetin Jehovah Witness people put for inside computer. Many of our book dey inside and e dey easy to use. If you dey find any topic, any word or any place for inside Bible, Watchtower Library go help you.

      Anybody wey get assignment for the Life and Preaching Meeting, go fit use am. You fit use the library take prepare your assignment. Na Life and Preaching Meeting overseer get hand for the library. Na im go make sure sey all the new book dey there as e suppose dey. The Life and Preaching Meeting overseer or the person wey dey teach you Bible fit show you how you go take find anything wey you want know, but make you no carry any book wey dey for library comot from Kingdom Hall. Make you use the book well, make you no write anything for inside.

      Bible talk sey if we want ‘sabi wetin God dey tell us well well, we go use all our mind find am like sey we dey find better thing wey hide inside ground.’ (Proverbs 2:1-5) The library wey dey Kingdom Hall go help you.

      • Wetin dey Kingdom Hall library wey go help you get answer to different different question?

      • Who go fit teach you how you go take use the library?

      MAKE YOU LEARN OTHER THINGS

      If you want get your own library for house, make you check magazine counter for inside Kingdom Hall. Your Bible teacher go tell you the publication wey you go need first.

  • Wetin You Go See for Our Website?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
    • LESSON 28

      Wetin You Go See for Our Website?

      One woman wey dey use im computer do research

      France

      One family wey dey use computer

      Poland

      One woman wey dey watch sign language video for our website

      Russia

      Jesus Christ tell the people wey dey follow am sey: ‘Make una light dey shine, make people fit see the kind good thing wey una dey do, come praise una papa wey dey heaven.’ (Matthew 5:16) Na im make us dey use internet. Na for our website wey be jw.org we dey write everything wey we believe and everything wey we dey do. Wetin you fit see for our website wey be jw.org?

      Bible answer different different question wey people dey ask. The answer for the different different question wey people dey ask dey this our website. For example, the tract wey dem dey call Suffer Suffer Go Fit End? and People Wey Don Die Fit Come Life Again? dey our website for different language wey pass 600. You go still see New World Translation Bible for there and e dey for language wey pass 130, other book wey you fit use take study Bible dey there, even the book wey dem dey call What Does the Bible Really Teach? and the new Watchtower and Awake! wey we get. You fit read this different different publication for our website, or download am as MP3, PDF, or EPUB. You fit even print am give person wey want read am for im language. Different different video dey for people wey dey use hand dey talk (sign language). You fit still download different different Bible drama, Bible wey dem read like drama and better song wey you fit enjoy anytime you want.

      News about Jehovah Witness People. You fit still hear news and watch video wey go show you all the thing wey we dey do for the world. You fit see where dem go show you the time wey we go do our convention and where our different different branch office dey.

      All this things wey we dey do dey show sey we dey let our light shine everywhere even go reach far place like Antarctica—the place wey cold pass for this world. We dey pray make wetin we dey preach reach people everywhere for the whole world so that people go fit praise God.—2 Thessalonians 3:1.

      • How jw.org dey help people learn wetin dey inside Bible?

      • Wetin you go like see for our website?

      MAKE YOU KNOW SEY:

      Some people wey no like Jehovah Witness people don open different different website for internet wey dem take dey talk lie lie about the kind people wey we be. Their own na to carry people comot for Jehovah side. Make we no go that website o!—Psalm 1:1; 26:4; Romans 16:17.

Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
Log Out
Log In
  • Nigerian Pidgin
  • Share
  • Set Am How You Like
  • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
  • How to Use Am
  • Privacy Policy
  • Privacy Settings
  • JW.ORG
  • Log In
Share